Fela Durotoye

From Wikipedia
Fela Durotoye
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am12 May 1971 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Pesin wey e mariTara Fela-Durotoye Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, financial analyst Chenj-am
Wie e go skulJohn F. Kennedy School of Government, Obafemi Awolowo University Chenj-am
Party wey e dey for politisAlliance for New Nigeria Chenj-am
Candidacy in election2019 Nigerian presidential election Chenj-am
Official websitehttps://feladurotoye.net/about/ Chenj-am

Adetokunbo Olufela Durotoye ( dey bon am 12 May 1971) na Naija pesin wey dey give pipo bizness advais, dey tich pipo how to bi lida an e na poblik spika. Na Fela bi di oga pata-pata of "GEMSTONE Nation Builders Foundation". Di hoganasashon na one bodi wey de tich yong pipo to bi lida an mek soshal chenj. Di hoganasashon no bi govamet dey kontro am an no bi to mek moni. ANN (Alliance for Niu Naijiria chuz Fela to bi dia kadidet wey go go for dem as president for di Naija 2019 presidensha eleshon.

In 2023, Naija presidor Bola Tinubu chuz Fela as Sinior Spesha Hasistat to di presidor for Nashonal "Values" an Sosha "Justice"

How e tek stay life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Fela Durotoye on 12 May 1971. E papa nem na Layiwola Durotoye an e mama nem na Adeline Durotoye. Fela peret na profesor wey dey tich for Yunivasiti of Ibadan. Afta wey Fela peret move go Obafemi Awolowo Yunivasiti (OAU), Fela go dia "Staff Children's Skul" (1974-1981) an do e sekondri skul for "Moremi High Skul" (1981-1986). Fela go Obafemi Awolowo Yunivasiti go rid komputa Sayensi, Ekonomik, as do e Masta digri (M.B.A) at Obafemi Awolowo Yunivasiti. Fela don pass out from John F.Kennedy School of Government Executive Education Program of Harvard Yunivasiti Fela go Yale Yunivasiti go do one program wey di nem na "High Impact Leadership for a better society". E stil get satifiket as a lida Koch of di John Maxwell tim. For 2015, Dela Finnish "Lagos Business School" wey e tek do program on executive seminar program on strategy, Innovation and governance. E stil do one Supernumerary polis trenin for Naijiria Polis Trenin Kolej wey e pass out with Ditinshon.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fela wok for Ventures & Trusts Limited in 1992 as dia finashial hanalist. Fela na di oga patapata for kostoma sarvis dipatmet at Phillip Consulting Limited in 1998. Fela start V.I.P Consulting Limited in 200. Dis e kompini dey manej kostoma an human manejimet. Dey leta chenj di nem of di kompini to Visible Impact Limited.

Fela dey tok about manejimet an lidaship mata inside an outside Naija. For 2018, Fela tok to ova 200 bizness pipo wey kom di fest "Nigerian American Business Forum wey hapun for Tampa Florida. Some Pipo wey go di program bi Mohammed Shaaba Lafiagi, senator Ben Murray-Bruce, Naija stok ex-chenj chairman Abimbola Ogunbanjo, Midiha pesin Biodun Shobanjo, forma govno Peter Obi, an Ade Olufeko.

For December 2019, Fela plan to chenj how Mushin wey de Legos Stet. Di pipo-dem wey e kol join for di projet bi: Banky W,Alibaba, Kate Henshaw, Omoni Oboli, Teju Babyface, Sound Sultan, TY Bello, Dj Jimmy Jatt, Omawumi, Denrele, Dele Momodu, Tosin Bucknor, Stella Damasus, Tee A, Segun Dangote, Ebuka Obi-Uchendu an plenti oda pipo. Di projet na to paint house wey de Mushin.

How e tek do for politis mata[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fela tok sey e wan go for presidet for 2019 Naija jeneral eleshon. Pipo no dis one on 22 February 2018. Di politika parti wey e chuz to yuz for di eleshon na ANN (Allians for Niu Nigeria). Di parti chuz am to bi dia kandidet on Saturday, 29 September 2018. Qen Fela wan chuz pesin wey go bi e vais for di eleshon as presidet, e chuz Khadijah Abdullahi-Iya.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fela wife na Tara Fela-Durotoye, E wife na di CEO of House of Tara an e wife sril bi lorya. Di marej get three pikin. Dia nem na: Mobolurin, Demilade, an Morolaoluwa. Fela na kristen.