Ben Murray-Bruce
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Ben |
Wen dem bon am | 17 February 1956 |
Ples wey dem bon am | Lagos |
Wok wey e dey du | politician, entrepreneur, motivational speaker |
Post wey e dey | director general, member of the Senate of Nigeria |
Wie e go skul | University of South Carolina |
Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party |
Awod wey e kolet | Officer of the Order of the Niger |
Benedict Murray-Bruce OON (dem bon am on 18 February 1956) na Naija biznes pesin an politishan, na im get Silverbird Grup. Na memba of People's Democratic Parti (PDP), Na im enta as Senate of Nigeria Insaid March 2015 wia e stan for Bayelsa East Senatorial District, Bayelsa Stet, Nigeria.
Hau e tek stat life an edukashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Ben Murray-Bruce for Legos, im papa an mama na Ijaw Mulligan an Magrett Murray Bruce dia two kom fom Akassa, Bayelsa State, Nigeria. E go Lady of Apostles Yaba, Legos, wia e tek finish I'm primari skul edukashon an St Geogory College, Obalende wia e tek du im West Afrika Skul Certifikate bifor e go di Universiti of Southern California wey dey di United Stet, na fom dia e kolet barchelor's digre insaid Marketing in 1979.
Im pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ben Murray-Bruce mari Evelyn Murray-Bruce for 41 years. On 20 March 2021, e anous sey di wait don kpai fom cancer.
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]- "Showbiz Icon of the Year Award" (2005)
- ""Top Ten" Significant Nigerian Businessmen Award" (2006)
- "Life Achiever Award" (2006)
- "Champion for Nation Building Award" (2007)
- "Excellent Personality Award" (2009)
- "Officer of the Order of the Niger" (2014)[1]
Wia dem ci pruf
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Richard Akinwumi (29 September 2014). "Jonathan names Nigeria's national flag designer, Akinkunmi, special aide for life". Premium Times. Retrieved 2015-06-18.