Bola Tinubu
Man abi wuman | man ![]() |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija ![]() |
Nem for lokal langwej | Bola Tinubu ![]() |
Orijina nem | Asiwaju Bola Tinubu ![]() |
Fest nem | Bola, Ahmed ![]() |
Famili nem | Tinubu ![]() |
Wen dem bon am | 29 March 1952 ![]() |
Ples wey dem bon am | Lagos ![]() |
Mama | Abibatu Mogaji ![]() |
Pesin wey e mari | Oluremi Tinubu ![]() |
Fest langwej | Yoruba Langwej ![]() |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej ![]() |
Langwej wey e tek rait di wok | British English ![]() |
Wok wey e dey du | accountant, politician ![]() |
Wu e dey wok for | Arthur Andersen, Deloitte, GTE, Mobil Producing Nigeria ![]() |
Post wey e dey | member of the Senate of Nigeria, Lagos State Governor, Presido of Naija ![]() |
Wie e go skul | Chicago State University ![]() |
Party wey e dey for politis | Alliance for Democracy, Action Congress of Nigeria, All Progressives Congress ![]() |
Rilijon | Islam ![]() |
Bola Ahmed Adekunle Tinubu na Naija politishan an di presido of Naija. Bola Tinubu na di nomba 16 pesin to bi Naija presido. Tinubu don bi govno of Legos Stet bifor bifor from 1999 go rish 2007. Tinubu don bi Senato for Lagos West for di Third Republic wey no last. Na Bola Tinubu dem chuz for All Progressive Congress as dia kandidet for di 2023 Naija Presido eleshon. Na for Southwest Naija Tinubu gro bifor e kom go United State (USA) go rid Accounting for Chicago State University . Tinubu kom bak to Naijá araund 1980 an e get wok for Mobil Nigeria as akauntant, bifor e join politis as pesin wey Social Democratic Party pik as dia Lagos West senatorial kandidet. Afta Sani Abacha tok sey e no wan see Senate again in 1993, Tinubu dey amog di pipul wey fight mek demokrazi kom bak as e join di"National Democracy Coalition movement.Di Tru mata bi sey, Tinubu nid run komot fom Naijá in 1994, e kom bak wen Abacha dai in 1998 an na dis one stat di bigini of Fourth poblik. For di gofnor eleshion wey dey du for 1999, Tinubu wey bi memba of "Alliance for Democrazy" (AD) win ova di Peoples Democratic Party" (PDP) kandidet Dapo Sarumi an di kandidet of "All People's Party" (APP) Nosirudeen Kekere-Ekun.Afta Four years, Tinubu win di sekond eleshion for di sekond term ova di PDP kandidet Funsho Williams.Di main tori of Tinubu as govno of Legos Stet bi how e wan mek Legos Stet Mega siti an e fight wit Fedira Govament wey PDP kandidet dey kontrol. Afta wen Tinubu liv ofis, e bi amog di ogas wey fom di politika parti "All Progressive Congress" in 2013. Pipul dey always get kweshon on Tinubu karia if e get magomago an di tori abaut e life.
Tori abaut e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]
Akordin to di pepa wey dey kot, dey bon Tinubu for March 29, 1952.Tinubu mama na Abibatu Mogaji wet leta bikom di Iyaloja of Legos Stet.Tinubu go St.John's Primary School, Aroloya wey dey Legos an Children Home School in Ibadan. Tinubu travul go abrod wey e go Richard J.Daley College in Chicago den Chicago State University.E get di sartifiket Bachelor of Science (BSc.) in Akauntin. Pipul no too suo about Tinubu wen dey bon Tinubu, di skul wey e go an e ril nem bikos meni dokument an wetin Tinubu sef dey tok about am no mek am klair at all. Den sey na anoda famili wey dey Osun State bon Tinubu an sey e ril nem no bi Bola Ahmed Tinubu an sey na lai e dey tok abaut e histri, bot all dis one na dem sey dem sey. Dis "Dem sey, Dem sey stat wen Tinubu somit e pepa to INEC (Independent National Electoral Commission) wen e wan go for govno in 1999. Di pepa lai sey Tinubu go Government College Ibadan an di rekod wey dey Chicago State University tok sey na 1954, no bi 1952 dey bon Tinubu. Wen dey tell Tinubu mek e tok wetin happun, e sey Tokubo Afikuyomi mek mistek wen e somit e pepa giv pepa giv INEC an sey Chicago State University du mistek wen dem dey rait e age. Di mata stil kom up wen Tinubu rilis e pepa to INEC in 2022 as e wan go for presidet bikos im no put di e pamari an sekondri skul wey e go dis time araund wen e dey put dem bifor.
How e tek wok an tori abaut e drug mata[chenj-am | chenj-am for orijin]
Tinubu don wok for di folorin kompini:
- Arthur Andersen
- Deloitte, Haskins & Sells
- GTE Service Corporation
- Mobil Oil: Tinubu join Mobil oil wen e roton to Naijá an e leta bikom one of di ogas wey get mouth for di kompini.
Wen Tinubu dey USA for ovasee, di Govament for ovasee chek Tinubu bank akaunt an tok sey e hand no Klin bikos of di big moni wey dey inside am.Di Govament kom blok di akaunt wey di moni wet rish $460,000 in di year 1993.Di Govament blok di akaunt bikos Tinubu dey hep sel Hard drug for two Chicago dila in di eli 1990s.
How e tek stat politis[chenj-am | chenj-am for orijin]
Tinubu stat to join politis in 1992 wen e join "Social Democratic party"(SDP). Tinubu na memba of di grup wey Shehu Musa Yar'adua dey kontrol inside SDP parti.Oda politishian wey dey di politika parti na Umaru Yar'adua, Atiku Abubakar, Baba Gana Kingibe, Rabiu Kwankwaso, Abdulahi Aliyu Sumaila, Magaji Abdulahi, Dapo Sarumi an Yomi Edu. Tinubu bikom Senate wey dey repiset Lagos West Constitution bifor di Naijá third ripoblik skata. Wen dey skata di rosot of June 12, 1993 presidenta eleshion, Tinubu kom join oda politishian fom di parti National Democratic Coalition(NDC). Di grup na pipul wet dey fight mek demokrazi kom bak to Naijá an mek dey mek Moshood Abiola di presidor of Naijá as dey biliv sey na Abiola win di June 12 eleshion. Abiola run komot fom Naijá wen jeneral Sani Abacha bi presidor in 1994 an kom bak in 1998 afta Abacha don dai.Na dat time di Fourth Nigeria Replubic stat. Bifor di 1999 eleshion, Bola Tinubu na boi of Abraham Adesanya an Ayo Adebanjo an dey bi di lida of di parti "Alliance for Democrazy" (AD).Tinubu win di pamari eleshion wey di parti du to chuz bitwin Tinubu, Funsho Williams and Wahab Dosunmu wey bi forma minista of woks and hause. Tinubu bikom di Govno of Legos Stet in January 1999 onda di AD parti.
Govno of Lagos State[chenj-am | chenj-am for orijin]
Tinubu bikom di govno of Legos on May 1999 an e promis sey e go mek 10,000 hause for poor pipul to stey.For di 8 years wey Tinubu yuz as govno, e put moni for edukeshion an giv bak som skul to dia forma owna.Tinubu stat niu road as e plan to mek Legos get propa road bikos of di nomba of pipul in Legos. Tinubu with e sekond in komad, Femi Pedro win di sekond term eleshon as e enta ofis as govno in April 2003. Na onli Legos State PDP no win for all di State wey dey Saut-West.Wahala dey bitwin den presidor Olusegun Obasanjo of PDP an Tinubu of AD wey Legos Stet sopoz fom adishional lokal govament bikos of how pipul tek plenti inside di Stet.Bikos of di palava, forma presidor Obasanjo no gri giv Legos Stet dia moni wey fediral dey give Stet to giv dia lokal govament.As e time for govno dey kom to end, Tinubu enta meni kuore wit PDP politishian like Adeseye Ogunlewe wey bi forma Legos senator wey bi minista for wok an hause at dat time, an Bode George, hey bi head of PDP for Saut-West. Di luv wey Tinubu an Femi Pedro get for one anoda stat to wik wen Femi Pedro tok sey e sef wan bikom govno of Legos.Dis one mek Femi Pedro go join anoda parti kol Labour Party (LP) wen e stil bi vais govno. Tinubu time as govno of Legos Stet finish on May 29, 2007 wen e liv di posishion for Babatunde Fashola of Action Congres (AC).
E bank akaunt for oyibo kontri palava[chenj-am | chenj-am for orijin]
For April 2007, afta wey di jeneral eleshion don finish, di fediral govament kari Tinubu go Code of Conduct Bureau sey mek e tok how e tek get 16 difren difren bank akaunt for oyibo kontri.
[chenj-am | chenj-am for orijin]
For January 2009, EFCC (Economic and Financial Crimes Commission) tok chek Tinubu, govno of Delta James Ibori, govno of Akwa Ibom Obong Victor Attah weda dey yuz Stet moni, dia pawa as govno tek bai shiar for V-mobile kompini in 2004. E get one ripot wey som pipul get sey dey wan kill Tinubu on March 2009. Di parti AD ( Alliance for Democrazy) ripot di mata to den inspeto of polis Mike Okiro mek e luk di mata wel wel. For September 2009, British Polis tok sey dey wan chuk eyes inside how Legos Stet Govament tek bai shiar for Econet ( Airtel for now). Tinubu tok sey no magomago dey am an sey na all di pipul for Legos go gain inside wetin dey du. Naijá Fediral govament no gri kopuret wit British Polis to investiget di three forma govno in London kot.
Godfada an hooligan in Legos Stet[chenj-am | chenj-am for orijin]
Pipul dey tink sey Tinubu na godfada of Lagos wen we tok abaut politis mata for Legos.E get one sho for AIT television wey kari di tori wey di taitu na "The Lion of Bourdilon".Di AIT sho na 2015 Dokumentri wey tok abaut how Tinubu dey kontrol politis an moni wey Legos Stet get.Tinubu kari di produsa of di sho go kot an e tok sey dey most giv am #150 billion for how dat sho tek lai an spoil e nem.Dey kansu di AIT sho on March 6, 2015. Di kas of Fashola sekod term kwerel wahala wit Tinubu as Tinubu wan mek Muiz Bahire (wey bi forma envarometa komishona) to bi govno instead of Fashola in 2015 fit don mek pipul tink sey e na godfada of Legos Stet. Anoda kwerel bitwin Fashola an Tinubu happun as Tinubu dey kampain for Akinwunmi Ambode an Fashola dey kampain for anoda pesin.Anoda tins wey mek pipul tink sey Tinubu na godfada bi how Akinwunmi Ambode tek komot as govno an how e tek arrenj mek di niu govno Babatunde Sanwo-Olu enta ofis as govno.
Tori abaut Bullion van an eleshon for Lagos[chenj-am | chenj-am for orijin]
Wen 2019 eleshion dey go on, meni pipul see Bullion van enta di ples wey Tinubu dey liv for Bourdilon road for Ikoyi. Wen dey tel Tinubu mek e tok abaut am e tok sey "I fit put my moni eniwie wey I like" .
Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]
For 2016, Tinubu tok to Atiku Abubakar wen e stil bi vais president sey mek e liv PDP an kom e politikal parti to kampain for presidor of Naijá.Atiku gri to join Tinubu for e parti bot e no chuz Tinubu as e sekond bot go for Ben Obi wet kom come Saut-East as e sekond.Atiku no win di eleshion as PDP win for di eleshion. Wen Tinubu see sey e parti no win di 2007 presidetal eleshion, Tinubu stat to dey join oda parti togeda so dat all di smol parti gi fit fom one big parti to tek shalej PDP in 2019. In February 2013, Tinubu don hep mek three smol smol parti join to fom one parti. Di parti bi: Action Congress of Nigeria (ACN), Congress for Progressive Change (CPC), All Nigeria Peoples Party (ANPP) an smol smol pat of All Progressive Grand Alliance (APGA) an niu PDP (nPDP) Di nem of di niu parti wey dey fom na All Progressive Congress (APC). In 2014, Tinubu join hand wit forma militri hed of state Jeneral Muhammadu Buhari wey bi lida of CPC parti wey join fom APC.Buhari don kampan to bi presidor for three times bifor in 2003, 2007, 2011. Tinubu bifor wan bi Buhari vais bot leta chenj e mind an e pik Yemi Osibanjo to bi Buhari vais.Yemi Osibanjo na Tinubu frend an e na forma komishona of jostis. In 2015, Buhari win di eleshion onda di APC parti an Buhari win end di sixteen years wey PDP din dey kontrol Naijá.Buhari wey win mek am di fest time wey anoda pesin wey no bi president win presidor of Naijá for Naijá histri. Tinubu plai meni pat in Buhari Govament, as e sopot meni idiya as pipul dey tok sey e bi like Tinubu sef wan go for presidet too.In 2019, Tinubu sopot Buhari to fit win PDP kandidet Atiku Abubakar. Wen wahala happun for APC parti, dey remuv Tinubu frend wey also bi APC parti Chairman Adams Oshiomole as Chairman an meni pipul kom dey tok dey na plan mek Tinubu fit no fit kampain to bi Presidor for 2023.
Plan to bi 2023 Naijá Presidor[chenj-am | chenj-am for orijin]
For January 10, 2022, Tinubu mek Presidet Buhari no sey e get plan to bi di Naijá Presidor for 2023. On June 8, 2022, APC parti tok sey na Tinubu win di pramari eleshion as e get 1,271 winni Vais Presidor Yemi Osibanjo ewu get 235 an Rotimi Amaechi wey get 316.
Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]
Tinubu na muslim.Tinubu wife na Oluremi Tinubu wey bi di Lagos Sentral Senator district senator.Tinubu mama Abibatu Mogaji dai wen mama bi 96 years on June 15, 2013. Tinubu pikin Jide dai in London wen e get hart attak for dia.
Shif taitu[chenj-am | chenj-am for orijin]
Tinubu na Asiwaju of Legos an di Jagaban of Borgu kingdom in Naija Stet in Naijá.