Dele Momodu

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Dele Momodu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemDele Chenj-am
Famili nemMomodu Chenj-am
Wen dem bon am16 May 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amIle Ife Chenj-am
Pesin wey e mariMobolaji Abiodun Momodu Chenj-am
Fest langwejYoruba pipul Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Post wey e deychief executive officer Chenj-am
Wie e go skulObafemi Awolowo University Chenj-am
Academic degreemaster's degree Chenj-am
Work locationLagos Chenj-am
Wen e stat wok1996 Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
Candidacy in electionpresidential election Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Official websitehttp://delemomodu2011.com/ Chenj-am

Ayòbámidélé Àbáyòmí Ojútelégàn Àjàní Momodu (Dem bon am for 16 May 1960) wey pipul sabi wel wel as Dele Momodu na Naija jornalist, raita, poblik spika an biznesman.Na e bi di oga pata-pata of "Ovation International" magazine.Ovation international magazine dey kari big pipul parti an pikshon wey dey hapun all ova di wold espeshiali for Afrika.For 2015, Dele Momodu stat "Ovation TV" an also stat e niuz Pepa "The Boss Newspapers".Dele Momodu don kolet meni awod bikos of e wok wey dey tok abaut bizness, politics, buks, Muzik indostrie an Fashon indostrie. Dele Momodu dey rait evri Saturday inside Thisday Niuz Pepa onda di topik "Pendulum"

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Dele Momodu in May 16, 1960.One of e nem wey bi Ayobamidele mins "my joy don folo me go house". E bi di las out of di 3 pikin wey e mama bon.Wen Dele Momodu bi 13 years old, e papa kpai. Na Dele Momodu mama an famili memba-dem sopot am.Dele Momodu mama sef kpai on May 18, 2007.One of di lesin wey e mama tish am bi sey mek e no giv up wen tins rili hard.Dis lesin e len from e mama as e mama no gri giv up on sopotin Dele wen oda pipul don giv up on im.Even as Dele no pass e WAEC di fest an sekod time, e mama stil pay for di nes WAEC even sey no peti peti maket e dey sel an na onli am dey tekia of di oda two pikin-dem.Di nem of Dele sinior bi Dr. Oladele B. Ajayi an Debbie Ajayi.

How e tek go skul an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dele Momodu go rid Yoruba langwej for Yunivasiti of Ife ( now na Obafemi Awolowo University, Ile-Ife).E finish e bashelor digri in 1982. E stil rid Inglish litishor an get e Masta satifiket in 1988 from Yunivasiti of Ife.Wen Dele dey du e Your kopa bitwin 1982 an 1983, na Oyo Stet Kolej of Hat an kolsho dey post am go as tisha. In 1983 to 1985, Dele Momodu bi di pamanet seketiri to di forma deputi govno of Ondo Stet, Shif Akin Omoboriowo. Dele Momodu hep manej Oba Okunade Sijuwade Olubuse II wey bi di Ooni of Ife hotel in 1986.Di nem of di hotel na "Motel Royal Limited". Dele stop to wok for di hotel so dat e go fit go forda e edukeshon as e go du e masta in Inglish Litirashor. Na wen e dey du e masta e stat to dey rait hatikul for "[The Guardian]]", "Sunday Tribune" an odas Naija niuz pepa. Yunivasiti of Profeshional Stodies wey dey Accra in Ghana on July 30, 2016, awod Dele Momodu honorary doctorate degree(Ph.D). Di taitu of e Ph.D awod bi Doctor of Humane Letters. In May 1988, Dele Momodu stat to wok as staff raita for African Concord Magazine wey Moshood Kashimawo Olawale Abiola get.In 1989, dey transfa am go Weekend Concord as pahoniha raita.Na for March 1989 e fest rait di kova tori of Weekend Concord. Dele Momodu stil rait for odas pepa like National Concord, Sunday Concord, Business Concord an Yoruba Niuzpepa Isokan.