Yoruba Langwej

From Wikipedia

Yoruba langwej na langwej wey Pipul for West Afrika dey spik espeshial in South-West Naijá.Na Yoruba Pipul dey spik am. Na abaut 45 million of Yoruba pipul dey spik am an na abaut 2 million pipul wey dey no bi yoruba dey spik am.Yoruba langwej na langwej wey get diffren fashion, mentod an way of spikin.Na pipul wey dey Naijá an Benin dey spik am pass bot smol grup in Cöte d'Ivoire, Sierra

Leone an Gambia still dey spik am smol smol.

You go hear Yoruba Language for Afro- Brazilian side wit diffren nem kol Candomblé, for di Karibian side of Santeria wit Lucumi Langwej.

Tori of di langwej[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yoruba dey amog di Edekiri langwej. Oda langwej qey dey di Edekiri langwej bi Itsekiri an Igala. Yoruba langwej dey amog di Afrika langwej wey Pipul wet no dey Afrika kontinent dey spik pass as ova 47 million of both Yoruba pipul an meni million wey no bi Yoruba dey spik am.