Sound Sultan

From Wikipedia
Sound Sultan
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
AliasSound Sultan Chenj-am
Wen dem bon am27 November 1976 Chenj-am
Ples wey dem bon amJos Chenj-am
Wen e kpai11 July 2021 Chenj-am
Wie e go skulLagos State University, Federal Government College Ogbomoso Chenj-am
Wen e stat wok1996 Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimcontemporary R&B Chenj-am
Record labelKennis Music Chenj-am
Official websitehttp://soundsultan.com/ Chenj-am

Sound Sultan (dem bon am as Olarewaju Abdul-Ganiu Fasasi for November 27, 1976 an e kpai for July 11, 2021) na Naija singa, songraita, akto an recording artist. E dey among di pipul wey stat hip hop music for Naija. Pipul sabi am wel wel as e dey yuz im muzik tok abaut poor pipul, bad govment, an bad tins for Naija.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1991, e dey sing oda artist song for party wey dem dey do inside skul an e dey rait im own song. E dey luk im broda wey bi Baba Dee ezampul. Dis im broda stodi theatre art, an na im tich am hau e go dey du ontop stej. E stat to dey len hau to pley guitar afta e don finish sekondri skul an e dey inside one muzik band for 1999.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sound Sultan's wok fo sho biznes in di 1990's, wen e gada moni to tek enta studio.

By 1999, e don win plenti talent sho fo Naijà. E rilis im fest single - Mathematics "Jagbajantis" in 2000, wey pipul sabi wel wel fo Naijà. Sound Sultan stil rilis oda songs wit oda artist, Na Kennis Music sign am.

Onda Kennis Music e rilis four albums,for 2007, im kontrat wit Kennis Music finish e kon go join Baba Dee wey bi im broda stat Naija Ninjas, wey dey du rekod, produs an dem dey du clot sef. Im stat to dey sing as rapper leta e sing R&B, Afrobeat, an Naijà Fuji. E tok sey mek pipul no dey luk artist kain song but mek dem dey hear di messaj wey di artist dey send.

Wen e dey Naijà Ninja, e rilis Back from The future (2011) an sign artist lik Karma Da Rapper, Young GreyC, Shawn(Sean Tizzle) an Blacka.

Naijà Ninja rekod label fest rilis na The Rebirth for 2012 an songs lik Aropin wey pipul sabi wel wel dey insaid som artist like Sean Tizzle, Karma & Sound Sultan folo dey fo di EP.

Sound Sultan an Wyclef Jean fest wok togeda fo di song wey bi Proud to be an African wey Faze an 2 face folo dey fo di song. Wyclef stil folo Sound Sultan du som oda songs lik: King of my Country (2009) an People Bad(2012).

Fo Insaid 2012 dem annous Sound Sultan nem as UN Ambassador for Peace bikos of im bi gud ezampul for Naijà youth.

Insaid 2015, wen plenti pipul don dey tok sey where e dey Sound Sultan kon rilis song wey bi Remember.

Sound Sultan dey Insaid pipul wey stat Continental Basketball Leaque an e get im own team wey bi: Lagos City Stars.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]