University of Ibadan

From Wikipedia

University of Ibadan (UI) na poblik yunivasiti wey dey Ibadan for Naija. Na for 1948 de fom am as University College Ibadan way bi one of di skul wey dey onda University of London. Di yunivasiti komot onda University of London for 1962.University of Ibadan bi di yunivasiti wey old pas wey dey giv digri satifiket for Naija.Bikos of meni studet wey don pass out for di Univasiti, di Univasiti don hep for politis, indostrie, ekonomis an kulshora divelopment in Naija.Di histri an di wok wey di skul don du mek am get levul as one of di fine Univasiti in Afrika. Di univasiti of Ibadan get 92 depatment inside 17 fakulti wey bi Arts, Science, Basic Medical Science, Clinical Science, Agriculture, Social Science, Education, Veterinary Medicine, Pharmacy, Technology, Law, Public Health, Dentistry, Economic and Management Science, Renewable Natural Resources, Environmental Design and Management, and Multidisciplinary Studies.

Pipul wey dey run di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ofis
Post Pesin wey dey di post
Visitor Muhammadu Buhari
Chancellor Sultan Sa'adu Abubakar, 20th Sultan of Sokoto
Pro-Chancellor & Chairman Chief John Odigie Oyegun
Vice-Chancellor Professor Kayode Oyebode Adebowale
Deputi Vice-Chancellor (Administration) Professor E.O. Ayoola
Deputi Vice-Chancellor (Academic) Professor Aderonke M. Baiyeroju
Deputi Vice-Chancellor (Research, Innovation and Strategic Partnerships) Professor Oluyemisi A. Bamgbose

Pipul wen don bi Vice-Chancellor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kenneth Mellanby (Principal): 1947–1953