Obafemi Awolowo University

From Wikipedia
Obafemi Awolowo University
public university
Inception1962 Chenj-am
Official nameObafemi Awolowo University Chenj-am
Native labelObafemi Awolowo University Chenj-am
Named afterObafemi Awolowo Chenj-am
Motto textFor Learning and Culture Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityIlesa Chenj-am
Located in time zoneUTC+01:00 Chenj-am
Coordinate location7°31′6″N 4°31′22″E Chenj-am
Memba ofAssociation of Commonwealth Universities, Association of African Universities Chenj-am
Language usedEnglish langwej Chenj-am
Official websitehttp://www.oauife.edu.ng Chenj-am
Official colormidnight blue, gold Chenj-am
Map

Obafemi Awolowo University (OAU) na fediral govament yunivasiti wey dey Ile-Ife, Osun Stet in Naija. Na 1961 dey fom di yunivasiti an di skul stat to tish studet in October 1962 wit di nem "University of Ife". Na Westa Rijion Govament dey kontrol am dat time onda Samuel Ladoke Akintola. Den chenj di nem to "Obafemi Awolowo University" in May 12, 1987 to tek rimemba Obafemi Awolowo (1909-1987) wey bi di fest premiha lida of Westa Rijion of Naija wey tink an fest bring di idiya kom.

Tori of di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1951, dey mek new konstitushion an dis kom bring mejo chenj to chuz pipul wey go dey mek law in di Westa Rijion.Di niu Rijional govament kom mek kretin primari an sekondri skul dia mejo wok as dey biliv sey edukeshon dey impotat if divelopment wan dey.In 1959, di Fediral Ministri of Edukeshon fom one komission to shek how di kontri manpawa nid of yunivasiti graduate bitwin 1960 an 1980.Na Cambridge leshura Eric Ashby, Masta at Clare College, Cambridge bi shairman for di komitee. For October 1960, di Ashby komitee rekomed dey mek dey put more yunivasiti for Norta pat an Souta pat of Naija an anoda yunivasiti for Legos, but mek no yunivasiti dey Westa Rijion bikos Westa Rijion get "free an universal primary Education". One manoriti ripot wey Govament agrie set mek one yunivasiti dey witdin di Westa Rijion an mek dey giv fasiliti of di "Nigeria College of Arts, Science and Technology", wey dey Ibadan to dem.Dey pass one vote wey agrie to build di yunivasiti in 1961.Di final site of di yunivasiti wey bi 13,500 akas of land na im di pipul of Ile-Ife giv sey mek sem yuz for di buildin of di yunivasiti.Di fest moni wey di skul get for sopot na £250,000 wey di Westa Rijional Govament dash dem.

Ibadan Kampos[chenj-am | chenj-am for orijin]

For September 1962, dey opun di yunivasiti mek 244 studet stat to kom dia tempoari fasiliti, di forma kolej of Arts an Sayens , Ibadan.Som of di studet wey kom di yunivasiti don dey du kolej of Arts an Sayens bifor an som staf wey kom don dey tish for "University College", Ibadan an don ovasi.Na Oladele Ajose dey pik as di fest Vais-Shansellor of di yunivasiti an di yunivasiti stat wit Falkoti of Agrikolshor, Art, Ekonomis, Soshial Sayens, Law an Sayens.Di metod dey du tins for Obafemi Awolowo University dat time wan resembu di metod wey "University College Ibadan an di skul get koneshion wit "University of Wisconsin .Politis mata kom mek tó kari di go Ife din Ibadan dilai smol. For February 1966, Lt-Col Francis Adekunle Fajuyi qeytbi di visito of di Obafemi Awolowo University an di fest Militri Govno of Westa Rijion chuz Ezekiel Oluwasanmi as di niu Vais Shansellor an Shif TT Solarus as di pro-shansellor as e stil giv dem moni an orda mek dem pak to di pamanet site bifor October 1966. Fajuyi kpai for di militri koup wey hapun for July 1966 an e no si how di skul tek mov go Ife.Di yunivasiti build one hostel an am Fajuyi Hall join at to tek rimemba am for di pat wey e du for di skul.

Di pakin to Ife[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di yunivasiti pak go Ife stat for January 1967.Na di kampos wey dey Ife fest get Falkoti of famasi for di entaya West Afrika, di fest dipatmet of kemika Enjiniarin an di fest falkoti of eletronik komponet an eletrika Enjiniarin.

Akademi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Obafemi Awolowo University get 13 falkoti an two kolej ( di post graduate kolej an kolej of Health Sayens). Di skul get dipatmet wey pass 60.

How di skul tek bi fediral yunivasiti[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1975, one Militri Govament dikrie wey dey du mek di Yunivasiti of Ife a fediral yunivasiti.

Pipul-dem wey don bi Vais-Shansellor[chenj-am | chenj-am for orijin]