Kate Henshaw

From Wikipedia
Kate Henshaw
pesin
Industryfilm industry, cinema of Nigeria, entertainment industry Chenj-am
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemKate Chenj-am
Famili nemHenshaw Chenj-am
Wen dem bon am19 July 1971 Chenj-am
Ples wey dem bon amCalabar Chenj-am
RelativeAndre Blaze Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, Federal Government Girls College, Calabar, University of Calabar Chenj-am
Academic degreeBachelor of Science Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Awod wey e koletAfrica Movie Academy Award for Best Actress in a Leading Role, Best of Nollywood Awards Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Kate Henshaw wey dem stil.sabi am as Kate - Henshaw Nuttall (dem bon am on 19 July 1971), na Naija aktres, In 2008 shi win di Afrika Muvie Academy Awords do Bes Aktres in a leading rol for di wey shi tek akt for Stronger than Pain muvie.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Kate Henshaw in Cross River State, na shi bi di fes pikin insaid di four wey im papa an mama bon. Shi go St. Mary private School wey dey Ajele, Lagos for im primari skul edukashon. Shi leta go Federal Government Girl College, Calabar for sekondri Edukashon. Shi uze one year for Universiti of Calabar to len remedial studies kon leta fes Medical Microbiology for di Skul of Medical Lab Science. Shi stil go LUTH (Lagos University Teaching Hospital) in Lagos. Henshaw wok for Bauchi General Hospital. Bifor shi bi ogbonge aktres, shi don wok as model, shi don wok for difren newspaper an television for Shield deodorant.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1993, Kate Henshaw go du audishon for rol insaid When the Sun Set muvie an na shi dem chuz..Di fes time wey shi wan sho for Nollywood fim bi dat. Henshaw don du pas 45 Nollywood muvis.

In 2008, shi win Afrika Muvie Akademi Aword for Bes Aktres in a Leading rol for Strong than Pain muvie.

Shi dey insaid pipu wey dey akt wey dom kol dia nem to win Bes Aktres in a leading rol at Afrika Muvie Academi Awords in 2018, for di wey shi tek akt for "Roti".

Politis On 19 July 2014, Kate Henshaw sho pipu website wey dem shi go uze du campaign bikos shi wan go for fediral Haus of Representatives go stan for Calabar/Odukpani pipu onda People's Democratic Party (PDP). Henshaw los di primari eleshon to Rt. Hon Essien Ayi. Dem giv Henshaw Speshal Adviser Liason Lagos by di Cross River State Govnor Ben Ayade in December 2015.

Endorsements[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2012, na Henshaw bi di brand ambassador for UK perfume, Blessing perfumes. Shi bi di brand ambassador for "Onga" seasoning wey promasidor Nigeria Limited dey produs. In September 2012, Henshaw an Dan Foster dey insaid jorj for Nigeria got Talent sho. In 2013, Henshaw wit Banky W bi brand ambassador for Samsung Mobile. In January 2019, Kate Henshaw dey insaid 50 jorj wey tek pat in CBS internashonal Talent Sho wey dem dey kol The World's Best. Henshaw na ambassador for Globacom compini.

Hau e tek dey hep pipu[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2016, Henshaw hep one smol boy, wey bi Micheal Alvez, e get ulcer for fes an kol Henshaw mek e hep Henshaw hep am. Di boy gada 8 million Naira. Di boy famili no gree Kolet Di moni bikos dem tok sey dey no wan di moni.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kate Henshaw Mari British- bon Roderick James Mittal in 1999, an dey get one pikin. Henshaw an Nuttel marriage skata in 2011.

Honors In 2011, Fediral govmet giv Henshaw Order of di Fediral Repoblik (MFR).

Fim wey e don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

Above Death: In God We Trust (2003)

A Million Tears (2006)

My Little Secret (2006)

Stronger Than Pain (2007)

Show Me Heaven (2007)

Aremu The Principal (2015)

Chief Daddy (2018)

New Money (2018)

The Ghost and the House of Truth (2019)

4th Republic (2019)

The Women (2018)

Blood Sisters (2022)

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]