Ebuka Obi-Uchendu

From Wikipedia
Ebuka Obi-Uchendu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemEbuka Chenj-am
Famili nemObi, Uchendu Chenj-am
Wen dem bon am14 July 1982 Chenj-am
Ples wey dem bon amBenin City Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer, media personality Chenj-am
Pat of wok wey e put mindlaw, presenter Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Abuja, Washington College of Law Chenj-am
Academic degreeMaster of Laws, master's degree Chenj-am
Wie e dey livLagos Chenj-am
Wen e stat wok2006 Chenj-am
Affiliation stringKnight & Sheriff Chenj-am
Participant inWorld Economic Forum Annual Meeting 2014 Chenj-am
Notable workBig Brother Naija, season 5, Big Brother Naija, season 3, Big Brother Naija (season 4) Chenj-am
Significant eventBig Brother Naija Chenj-am
Awod wey e koletNigerian Broadcasters Merit Awards Chenj-am

Chukwuebuka Obi-Uchendu (dey bon am 14 July 1982) na Naija pesin wey dey tok for redio an Televishon. Ebuka kom from Okija wey de Anambra Stet. Pipo no Ebuka wel wel as di pesin wey dey host Big Broda Naija, Rubbin Mind tok sho for Channels TV . Ebuka stil dey join bodi to host "The Spot and Men's Corner" on Ebonylife Televishon. Ebuka dey helep Budweiser Nigeria, Samsung, Nigeria an 2Sure Nigeria sel dia prodot.

Ebuka win di Outstanding TV Presenter of the Year at di Nigerian Broadkasta Merid Awod for di way e tek wok in Rubbin Minds.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Benin Siti, Edo Stet dey bon Ebuka on 14 July 1982. Ebuka papa dey wok for bank an e mama dey wok for hospitu as nurse. Ebuka na di nomba 3 pikin out of di 4 pikin-dem wey e peret bon. E get one elda sista, one elda broda an a yonga broda. Na for Benin Siti Ebuka do e pamari edukeshon. Ebuka do e ezam wey dem dey kol "Common entrance wen e dey pamari 4. Ebuka folo e famili pak wen dem pak go Abuja. Na for Abuja Ebuka do e sekondiri edukeshon for "Christ The King Kolej", Abuja. E finish di skul in 1997. Ebuka rid law for Yunivasiti of Abuja wey e finish in 2004. In 2005, Ebuka enta Nigerian Law Skul, Bwari, Abuja. Ebuka in 2010 finish e Masta digree in Washington Kolej of Law of di Amerika Yunivasiti. Di pat of law wey e chuk bodi into na "Intellectual Propati" an Komunikashon law.


How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2006

Ebuka in 2006 enta as one of di 14 pipo-dem wey go de inside di house in Big Broda Nigeria. Na nomba 8 posishon Ebuka kari komot dat time. Na Ebuka do well pass for all di pipo-dem wey do Big Broda Nigeria in 2006. Dey tok sey na Ebuka go bi di host of di sekod sisin of Big Brods Naija wey dem do in 2017. Na im stil do di third edishon of di sho.

Afta di Big Broda Nigeria wey e do for 2006 finish, Ebuka sahin mek fone kol kompini yuz am tek sel dia prodot. E sahin with Beer kompini too an e host sho like: Friend or Foe on NTA, The GLO sho on NTA, an Guiness' Greatness TV. Ebuka stil dey rait for Naija This Day niu-pepa for one side of di niu-pepa kol "Contrast".

  • 2011

Wen 2011 jeneral eleshon wan start, Ebuka host di fest eva presidental eleshon wey dem wan do for Naija.

  • Rubbin Minds and EbonyiLife TV.
  • 2013

For 2013, di produsa of Rubbin Minds pik Ebuka as di pesin wey go bi di niu host.

Ebuka join bodi with Lamide Akintobi an Zainab Balogun in 2013 to host The Spot. Na for DSTV dem dey sho dis program.

  • 2016

For Jul6 2016, Ebuka bikom di host of Men's Corner, one Naija tok sho wey konsain man. Wen dem wan do Big Broda Naija Sisin 5 Reunion, some of di fan of di sho tok sey Ebuka no sabi do host wel wel but meni of di fans to sey e sabi do am wel wel.

Fim wey e don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Taitu Type Date Role Notes
Big Brother Nigeria Reality TV Series 2006 Himself Finished 8th out of 14

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ebuka and Toke Makinwa presenting at the 2020 AMVCA
Year Awod Katigori Risot
2007 The Future Awards On-Air Personality Nominated
2008 Nominated
2013 Nigerian Broadcaster's Merit Awards Outstanding TV Presenter of the Year (Male) Nominated <ref>"BEHOLD! Winners at 6th Nigerian Broadcasters Merit Awards (NBMA) | Nigerian Broanom". {{cite web}}: Missing or empty |url= (help)
2015 Won
2021 Net Honours Most Popular Media Personality (Male) Won

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 15 April 2015 in Legos, Ebuka tok sey e wan mari Cynthia Obianodo. Dey mari demsef on 6 February 2016 in Abuja. Di marej produs one gel-pikin wey Cynthia bon on 8 November 2016. Dey tok sey anoda pikin dey kom in 2018. Cynthia tok sey na for Twitter e tek see Ebuka.