Rabiu Kwankwaso

From Wikipedia
Rabiu Kwankwaso
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am21 October 1956 Chenj-am
Ples wey dem bon amMadobi Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the House of Representatives of Nigeria, Governor of Kano State, Minister of Defence of Nigeria, Governor of Kano State, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulMiddlesex University, Loughborough University Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party, All Progressives Congress, New Nigeria Peoples Party Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Official websitehttp://www.kwankwaso.com/ Chenj-am

Rabiu Kwankwaso FNSE, FNIQS (dem bon am for October 21, 1956) na Naija politishian an forma govno of Kano Stet from 1999 go rish 2003. E still bi govno of Kano Stet from 2011 go rish 2015.Afta wey Kwankwaso no win re-eleshon for 2003, forma presidor Olusegun Obasanjo pik am as di fest Minista of Defens of di Forth Riplobik even sef e no get eni esperiens abaut Miitri.Kwankwaso du Minista for Defens from 2003 go rish 2007.For 2015, e bi sinator wey dey ripreset Kano Sentra Sinatoriha District.Na one term e yuz an na onda APC (All progressives Congress) e tek enta as sinator. For now, Kwankwaso bi di Nashiona lida for di "New Nigeria People Party".Pipul luv Kwankwaso for Kano an for North-Westa Naija.Meni pipul si am as politishian wey dey konsida di pipul onda am wen e dey rule dem. For 2011, Kwankwaso win eleshion as di Govno for di sekod time onda di politika parti APC. Kwankwaso enta as one of di pipul wey go like be Naija presidor for di pamari wey APC du bot na Muhammad Buhari dey fanali chuz.For 2018, e go PDP go du pamari for pipul wey go like bi presidor for PDP bot na Atiku Abubakar dey chuz. NNPP (New Nigeria Peoples Party) don pik Rabiu Musa Kwankwaso as di pesin wey go repiset di parti fight for presidet for di 2023 jeneral eleshon.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bom Rabiu Musa Kwankwaso for October 21, 1956 in Kano.Na Islam Fulani of Genawa Fulani traib.Kwankwaso papa bi di hed of Kwankwaso vilej an e taitu na "Sarkin Fulani Dagacin Kwankwaso".Afta somtime, dey mek Kwankwaso papa di Distrit Hed of Madoni an giv e papa di taitu "Majidadin Mano, Hakimin Madoni" by di Kano Emirate Council wen Alhaji Ado Bayero stil bi di 13th Fulani Emir of Kano.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rabiu Musa Kwankwaso go Kwankwaso pamari skul, Gwarzo Bordin sinior pamari skul, Wudi kraft skul an Kano teknika kolej bifor e kom go Kaduna Politeknik. Na for di Politeknik e tek du e Nashional Diploma (ND) an Haya Nashional Diploma (HND). Wen Kwankwaso still de skul, e na studet lida an e bi one of di ofishal Kano Stet Studet Hasosiashion. From 1982 go rish 1983, Kwankwaso go Middlesex Politeknik wey de United Kindom go du e Post Graduate stodi.E still go Loughborough Yunifasiti of Teknologi go du e Masta digri in Wota Enginerin in 1985.Kwankwaso finish e Ph.D in Wota Enginerin for Sharda Yunifasiti

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kwankwaso stat to wok for Kano Stet Wota Risosis an Enjinerin konstrushon Ajensi in 1975.Na Govamet of Kano Stet DW kontrol di Ajensi.E wok for dia for 17 years inside meni ples for di Ajensi onti dey mek am di presipal wota enjineha

How e tek wok in politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kwankwaso stat politis wen e join di politika parti SDP (Social Democratic Party).E dey for di grup wey jenera Shehu Yar'adua an oda popula politishian dey kontrol inside di SDP parti.Di oda politishian nem bi: Magaji Abdullahi, Babagana Kingibe, Atiku Abubakar, Bola Tinubu, Tony Anenih, Chuba Okadigbo, Abdullahi Aliyu Sumaila, Abubakar Koko an Lamidi Adedibu For 1992, Kwankwaso bi di memba of House of Representativ wey dey represet Madobi Fediral Konstituensi.E stat to dey popula for Nashional politis afta dey chuz am as di Deputi Spika of di House.Durin di 1995 konstitushon konfirens, dey chuz Kwankwaso as di pesin wey go repriset Kano onda di memba of "People's Democratic Movement" .Na Yar'adua lid di grup. Wen General [Sani Abacha]] tok sey e wan komot as militri ptesidor an hand-ova govamet for sivilian govamet, Kwankwaso go join DPN.(Democratic Party of Nigeria). Na in 1998 Kwankwaso join PDP onda di platfom People's Democratic Movement in Kano.Pipul wey de lid di parti dat time na Mallam [Musa Gwadabe]], Senator Hamisu Musaan halaji Abdullahi Aliyu Sumaila.In 1999, Kwankwaso du pamari eleshon wit PDP an pipul wey folo-am du di pamari bi: Abdullahi Umar Ganduje, Mukthari Zimit, Ahlaji Kabiru Rabiu. Di Santsi/P.S.P. dey di bak of Abdullahi Umar Ganduje bot na Kwankwaso win di pamari eleshon.

Govno of Kano Stet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Fest term

Kwankwaso bi di govno of Kano Stet from May 29, 1999 go rish May 29, 2003.Kwankwaso fest term as govno for Kano Stet no easi at all bikos of meni group dey against how e dey du e govno as e no dey Kari odas along.Anoda tin wey mek e fest term no easi na bikos e dey sopot Olusegun Obasanjo wey bi Yoruba presidet for eleshon.Kwankwaso no win di nes eleshon an na Malam Ibrahim Shekarau win an bikom di nes govno of Kano Stet.

  • Sekod term

Kwankwaso kom bak as di govno of Kano Stet from May 29, 2011 go rish May 29, 2015.Dorin e sekod term, Kwankwaso du meni tins. E stat to dey du road, hispitu, skuls an kari meni Pipul go obodo oyibo go rid for dia. In August 2013, Kwankwaso dey for di Seven govno wey join bodi Tek fom di G-7 govno wey dey PDP. Wen November 2013 rish, E komot from PDP go join di niu oposishon parti APC.

2015 presidenta kampain[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kwankwaso bikos of di plenti pipul wey dey e bak kolet pamari tiket sey e wan bi APC presidenta kandidet in October 2014.Wen dey du di pamari eleshon for Legos finish, na Muhammadu Buhari win. Muhammadu Buhari get 3,430, Kwankwaso get 974, Atiku Abubakar get 954, Rochas Okorocha get 400 an Sam Nda-Isiah get 10 among all di vote wey dey kaunt day day. How e tek wok afta e finish gorvonoship== Olusegun Obasanjo chuz Kwankwaso as di Minista if Defens from 2003 go rish 2007.Na Kwankwaso kolet wok from Theophilus Danjuma as di Minista of Defens.

Sineto of Naija[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Kwankwaso bi di Kano Sentral District sineto from May 2015 go rish May 2019.

2019 presidenta kampain[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kwankwaso an fourteen sineto wey still dey pawa dat time komot from APC go join PDP in July 2018.Wen October 2018 rish, Kwankwaso kolet pamari tiket of PDP sey e sef wan bi PDP presidenta kandidet.For di eleshon wey dey du for Riva Stet, na forth posishon Kwankwaso kari. Na Atiku Abubakar win di pamari wit 1532 vote, folo by Aminu Tambuwal wit 693 vote, folo by Bukola Saraki wit 317 vote. Kwankwaso wey kari four get 158 vote.

How e tek fom e politika parti[chenj-am | chenj-am for orijin]

On February 2022, Kwankwaso set up di "National Movement" as a politika movement.E fom di politika parti bikos of di two politika parti wey dey Naija, di APC an PDP. Di nem of e parti na New Nigeria Peoples Party as di politika wing of di parti. For March 30, 2022, Kwankwaso bikom di parti Nashional lida.