Abdullahi Umar Ganduje

From Wikipedia
Abdullahi Umar Ganduje
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAbdullahi Umar Ganduje Chenj-am
Orijina nemAbdullahi Umar Ganduje Chenj-am
Fest nemAbdullahi Chenj-am
Wen dem bon am25 December 1949 Chenj-am
Ples wey dem bon amDawakin Tofa Chenj-am
Pesin wey e mariHafsat Ganduje Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Kano State Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University, Bayero University Kano, University of Ibadan, Government College, Birnin Kudu, Dawakin Tofa Chenj-am
Party wey e dey for politisNational Party of Nigeria Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Abdullahi Umar Ganduje OFR (dem bon am on 25 December 1949) na Naija politishan wey dey sarf as di govnor of Kano Stet fom 2015 rish 2023. E don sarf as Rabiu Kwankwanso's deputy govnor, fom 1999 rish 2003 an fom 2011 rish 2015. Na memba an chairman of All progressive Congress an (APC).

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ganduje in 1949 insaid Fulani famili for Ganduje, Dawakin Tofa Lokal Govmet Aria of Kano Stet. E stat Edukashon wit Qur'anic an Islamiyya skul wey dey I'm vilej, wia dem tek tich am Islamic tins. Leta, e go dia vilej popular plez for primari skul. Ganduje go popula sekondri skul, Government College, Birin Kudu fom 1964 rish 1968.

Ganduje go Advanced Teachers' College, Kano. E kon go Ahmadu Bello University, wey dey Zaria, Kaduna State, wia e tek finish wit Bachelor in Science Education in 1975. Insaid 1979 e get masta's digre in applied educational psychology fom Bayero University Kano. Leta, Ganduje go Ahmadu Bello University fom 1984 rish 1985 for masta of poblik administrashon digre. E Kolet im doctorate in poblik administrashon fom Di Universiti of Ibadan in 1993.

Hau e tek stat politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ganduje join National Party of Nigeria (NPN) for sekond Nigerian repoblik taim as sarf as Kano Stet Assistant Secretary fom 1979 rish 1980. E trai enta as Hauz of Representatives memba in 1979 onda NPN but e luz di eleshon. Insaid 1984 an 994, e don dey for difren govmet posishon insaid Fediral Capita Divelopmet Authority, an in 1994 na im bi Kano State Commissioner of Ministry of Works, Housing, an Transport.

In 1998 e join People's Democratic Party (PDP) an trai to bi di pesin wey go enta for govnor onda Di parti, but e Luz to Rabiu Musa Kwankwanso.

Dey leta selet Ganduje as deputy to govnor to Rabiu Kwankwanso insaid 1999 an 2003. Na im bi di commissioner for Lokal Govmet. Fom 2003 rish 2007 e sarf as speshial adviser to di Minista of Defence. Ganduje sarf as exekutiv secretary of di Lake Chad Basin Commission in Nigeria.