Atiku Abubakar

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Atiku Abubakar
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAtiku Abubakar Chenj-am
Famili nemAbubakar Chenj-am
Wen dem bon am25 November 1946 Chenj-am
Ples wey dem bon amJada Chenj-am
Pesin wey e mariAmina Titi Atiku-Abubakar Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Arabic, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey ducustoms officer, politician Chenj-am
Wu e dey wok forNaija Chenj-am
Post wey e deyVice President of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party, All Progressives Congress Chenj-am
Candidacy in election2019 Nigerian presidential election, 2023 Nigerian presidential election Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Owner ofAmerican University of Nigeria Chenj-am
Official websitehttps://atiku.org Chenj-am

Atiku Abubakar (dem bon am for November 25, 1946) na Naijá politishian an biznessman wey don bi Vice presidor of Naijá fom 1999 go rish 2007 wen Olusegun Obasanjo bi presidor of Naijá. Atiku na bifor bifor govno of Adamawa Stet in 1990, 1997 an leta 1998 bifor e kom bi vais for Olusegun Obasanjo fom in 1999 an Obaasanjo sekod time in 2003. Atiku Abubakar wan bi presidor of Naijá for five time sins bot e hand to rish am.Di five time bi: 1993, 2007, 2011, 2015, an 2009. For 1993, na Atiku Abubakar bi di kandidet of SDP ( Social Democratic Party) wey kontest wit Moshood Abiola an Baba Gana Kingibe.For 2007, Atiku Abubakar bi di AC (Action Congres) wey kari nomba 3 posishion as Umaru Yar'adua for PDP ( People Democratic Party) kari fest an Muhammadu Buhari for ANPP (All Nigeria Peoples Party) wey kari sekod posishion.Atiku join APC in 2014 tinkin sey di parti go chuz am to bi dia presidenshial kandidet for di 2015 eleshion bot na Muhammadu Buhari di parti chuz for di pramari eleshion wet di parti du.In 2017, Atiku go bak to PDP an na im PDP chuz mek e bi dia presidenshial kandidet for di 2019 presidenshial eleshion bot na Presidet Muhammadu Buhari win di eleshion again. In May 2022, di PDP stil chuz Atiku Abubakar as dia pesin wey go bi dia man for di 2023 Naijá presidenshial eleshion.

Tori abaut e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for November 25, 1946 dem bon Atiku Abubakar in Jada.Jada na one vilej wey dey Kamenroom bifor e kom dey onda Naijá teritiri todey.Atiku papa na Fulani trada an e mama nem na Aisha Kande. Dey nem am Atiku bikos dey like di nem as e grapapa nem sef na Atiku Abdulqadir wey kom fom Wurno, Sokoto Stet an muv to Kojoli vilej at Jada, in Adamawa Stet.Atiku grapapa fom e mama side na Inuwa Dutse muv kom Jada, Adamawa Stet fom Dutse in Jigawa Stet. Atiku papa dai inside wota as e wan kross a riva go one vilej wey nia Jada kol Toungo in 1957.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Atiku papa no like mek Atiku go skul bikos e no like westa edukeshion.Wen Govament pipul no sey Atiku no go skul wen e stil smol, dey kari e papa go jail an e yuz somtimes dia before Atiku mama pai di fine to rilis Atiku papa.At di age of eight years old, Atiku stat "Jada Primary School" in Adamawa.Wen e finish e pamari skul in 1960, e go "Adamawa Provincial Secondary School" wit oda 59 studet.Atiku finish sekondri skul in 1965 an e get gradi three for e WASSCE (West African Senior School Certificate Examination) wey e du. Atiku go "Nigeria Police College" wey dey Kaduna bot bikos e no fit produs e ezam wey e tek pass matimatis giv di skul pipul-dem, Atiku komot don di skul.Atiku kom go wok for smol time inside "Tax Office" for Ministri of Finans wey dey dia aria.E kom enta "School of Hygiene" wey dey Kano in 1966.Atiku finish wit Diploma in 1967, na im bi di tempuari Student Union Presidor of di skul.Atiku kom get free edukeshion to rid Diploma in law for "Ahmadu Bello University" wey dia govament giv in 1967.Wen e finish di Diploma korse, in 1969 wey Naijá pipul dey fight diasef, e enta Naijá kostom David day year. In 2021, Atiku pass an get Masta digri in intanashional rilashion in "Anglia Ruskin University" wet dey Cambridge in United Kingdom.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Atiku mari four wife an get twenty eight pikin.E tok sey e get meni wife bikos e wan mek di Abubakar famili big as na onli im dey wen e smol an e no wan mek e pikin dem dey fil lonli.

  • Wen e mari dem
  • In 1971, Atiku sikrit mari one Titilayo Albert for Legos bikos Atiku famili no wan mek e mari Titilayo. Di pikin wey Titilayo bon for Atiku naa: Fatima, Adamu, Halima an Aminu.
  • In 1979, Atiku mari Ladi Yakubu as e sekod wife.Di six pikin wey Ladi bon for Atiku na: Anna, Atiku, Zainab, Ummi-Hausa, Maryam an Rukaiyatu.
  • In 1983, Atiku mari e nomba 3 wife wey bi Princess Rukaiyatu, di pikin of Lamidi of Adamawa, Aliyu Mustafa.Di pikin wey Rukaiyatu bon for am na: Aisha, Hadiza, Aliyu (nem of e papa), Asmau, Mustafa, Laila an Abdulsalam.
  • In 1986, Atiku mari e nomba 4 wife, Fatima Shettima.Di pikin wey Fatima bon for Atiku na: Amina (Meena), Hasfat, Mohammed an di two twins Ahmed/Shehu an Zainab/Aisha.

Atiku no grie mari Ladi again so dat e go rimuv am kom mari Jennifer Iwenjiora Douglas so dat e wife no go pass 4 jos as islam tok am. On February 1, 2022 wey bi Tuesday, Jennifer Douglas tok sey e no mari Atiku again bikos Jennifer like to stey in United Kingdom an Atiku wan mek e stey Naijá.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Kostom

Atiku wok for "Nigeria Custom Service" get promoshion rish di sekod posishion wey big pass for Kustom wey bi "Deputy Director".E ritaya in April 1989 kom enta bizness an politis.

  • Bai an sel of land propati

Atiku get loan of 31,000 Naira to build e fest haus for Yola an den rent di haus.Di moni wey e get for di rent e yuz am build e sekod Haus.Na so Atiku dey du am smol smol onti e propati kom plenti for Yola.

  • Farmin

In 1981, Atiku enta farmin bizness.E kolet 2,500 hekass of land an stat to grow maize an kottin.Atiku tok sey di farmin bizness mek am loss moni dat time wey e stat am.

  • Bai an sel of fud

Atiku also stat to dey Bai an sel rice, flawa an sugar bot wit big motor e dey yuz bai an sel dem.

  • "Transpotashion"

Wen Atiku stil bi Kustom ofisa at Apapa Ports, one Italian pesin wey e nem na Gabrielle Volpi kol am mek e set up NICOTES (Nigeria Container Services). NICOTES kompini na abaut how goods for Apapa go dey move from Apapa port.NICOTES kom leta bi "Intel Nigeria Limited" an na dis one giv Atiku big moni. Atiku dey amog pipul wey fom Intel Nigeria Limited, one oil sarves kompini wey dey Naijá an Ovasee.Atiku stil get oda bizness in Yola, Adamawa wey inklud "Adams Beverages Limited", anoda anima fid kompini an "American University of Nigeria (AUN).Di univasiti na di fest Amerika univasiti to dey Sub-Sahara Afrika.

Wahala as e enta bizness[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kompain dey always folo Atiku as e dey wok for govament an stil get e pravat bizness. Atiku tok sey no bi im dey kontrol di kompini sey na Shares e Jos bai in di kompini.Atiku leta chenj di nem of di kompini NICOTES to INTEL an akusashion dey always folo am sey e dey yuz di kompini du deyti bizness fom U.S. govament wen e bi vais presidor.

How e tek stat politics[chenj-am | chenj-am for orijin]

Atiku stat to du politis wen e sopot Bamanga Tukur to kampain as Tukur wan bi Govno in di eli 1980s.Tukur dat time na Manijin Dareto of NPA.(Nigeria Port Authority).Atiku hep kampain an giv moni so dat Tukur go fit enta as govno. Wen e don dey rish di time for im to ritaya, Atiku mit Jeneral Shehu Musa Yar'adua wey bi Sekod-in-komad shif of staff, Suprim hedkuorta bitwin 1976 an 1979. Na Yar'adua mek am dey kom e haus to join politis mitin wey dey happun for Yar'adua haus wey dey Legos.Na di mitin mek dem fom "The People Front of Nigeria".Politishian wey dey dia na: Umaru Musa Yar'adua, Baba Gana Kingibe, Bola Tinubu, Sabo Bakin Zuwo, Rabiu Kwankwaso, Abdullahi Aliyu Sumaila an Abubakar Koko. In 1989, dey vote Atiku as di Nashional Vais-Chairman of di "The People's Front of Nigeria" as di third Nigeria Reploblik wan dey stat.