Hausa langwej

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Hausa langwej
natural language, modern language
Subclass ofWest Chadic Chenj-am
Native labelHausa Chenj-am
Indigenous toNiger, Naija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityWest Africa Chenj-am
Memba ofAfroasiatic Chenj-am
Linguistic typologysubject–verb–object Chenj-am
Writing systemLatin script, Arabic alphabet Chenj-am
Ethnologue language status2 Provincial Chenj-am
Wikimedia language codeha Chenj-am

Hausa langwej na Chad langwej wey Hausa pipul for Chad, an north pat of Naija, Gana, Kamerun an Benin dey spik.Smol grup of pipul wey dey liv for south of Niger an smol grup for Sudan an Ivory Coast sef dey spik Hausa langwej tu.

Hausa langwej dey amog di almost 300 langwej wey pipul dey spik in Norta Asia, Norta Afrika, East Afrika an pat of Sahara/Sahel.Di nomba of pipul wey bi sey na Hausa bi dia papa langwej rish 47 million an di nomba of pipul wey len how to spik di langwej rish 25 million pipul, an if we add all of dem togeda, it mins sey na abaut 72 million pipul fit spik Hausa. For Naija, di nem of di fim indostrie wey dey mek fim for Hausa langwej na "Kannnywood".

katigori of langwej wey Hausa dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hausa na West Chad langwej, dat is, langwej wey pipul for Niger an Naija dey spik.

Aria wey dey spik am pass[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipul wey Hausa bi dia papa langwej dey Souta Niger an Norta Naija. For pesin wey dey Norta Naija, Kameroon, Gana wey wan kommuniket or du bizness wit diffren langwej go beta yuz Hausa langwej.Infat to du bizness in West Afrika, ( Benin, Gana, Kameroon, Togo, Chad an pat of Sudan) Hausa bi like bizness langwej.

Difren wey of spikin di langwej[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hausa no too difren as pipul dey spike am, bot pipul wey dey stodi langwej don see sey di wey one aria dey spik am fit difren fom oda aria.

Tradishional way of spikin Hausa[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Pipul wey dey spik Dauranci in Daura, Kananci in Kano, Bausanci in Bauchi, Gudduranci in Katagum Misau, Hadejanci iin Hadejiya an oda pat of Borno dey spik "Easta Hausa".
  • Pipul wey dey Spik Sakkwatanci in Sokoto, Kastinanci in Kastina, Arewanci in Gobir, Adar, Kebbi, Zanhwaranci in Zamfara an Kurhwayanci in Kurfey in Niger dey spik "Westa Hausa".

For Kastina, na bot di Westa an Easta Hausa dem dey spik for dia. Na Hausa wey dem dey spik for Sokoto na im dey tek rait Hausa langwej, dat is di risin dem dey kol am klasikal Hausa. Di Hausa wey pipul dey spik for North na Arewaci (Arewa mins North).Di Hausa wey pipul dey spik for South na Zazzaganci in Zazzau. Di Standad Hausa wey pipul dey spik na e bi Daura (Duranchi) an Kano (Kananci) bikos na dis one BBC, Deutsche Welle, Radio France Internationale an Voice of America dey yuz tok Niuz. Now adaz, Zazzaganci fom of Hausa na im dey wan dey yuz rait an spik Hausa langwej.