Moshood Abiola

From Wikipedia
Moshood Abiola
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Famili nemAbiola Chenj-am
Wen dem bon am24 August 1937 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbeokuta Chenj-am
Wen e kpai7 July 1998 Chenj-am
Place of deathAbuja Chenj-am
Manner of deathhomicide Chenj-am
Pesin wey e mariRemi Abiola, Kudirat Abiola Chenj-am
PikinDupsy Abiola, Hafsat Abiola Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Wie e go skulBaptist Boys’ High School Chenj-am
Party wey e dey for politisNational Council of Nigeria and the Cameroons Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am

Moshood Kashimawo Olawale GCFR (dey bon am 24 August 1937 an e kpai on 7 July 1998) wey pipo sabi wel wel as M.K.O. Abiola na Naijá biznesman, poblisha, an di politishan in di Yorubaland. Abiola bi di militiri kommanda of di Oyo kindom. Abiola na big pesin wey kom from Egba tribe. M.K.O Abiola wan yuz demokrasi enta as presidet for di 1993 Naija presideta eleshon but Ibrahim Babangida kansu di risot of di eleshon. Ibrahim Babangida dat time bi di militiri presidor of Naija. Babangida tok sey e kansu di eleshon risot bikos magomago an wayo de di eleshon. For 2018, forma presidor of Naija Muhammadu Buhari awod Abiola di rank wey hi pass for Naija, GCFR ( Grand Kommanda of di Fediral Riploblik). Na pesin wey don bi presidor dem dey give GCFR. Buhari still chenj Naija demokrasi day to June 12. Abiola an Ibrahim Babangida bi padi padi an pipo tok sey Abiola even helep Babangida to bikom presidor. Evri korna of Naija na im vote for Abiola. Even difren difren rilijion pipo an some politishan still vote so dat Abiola go fit win di June 12 eleshon. By di time wey Abiola go kpai in 1998, if Naija pipo wan tok abaut demokrasi, Abiola nem dey folo join.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Abeokuta , Ogun Stet for Naija dey tek bon Abiola on 24 August 1937. E papa nem na Halaji Alao Salawu Adenekan Abiola an e mama nem na Suliat Wuraola Abiola. Abiola papa dey sell Kokoo an e mama dey sell Kola nut Abiola bi di nomba twenty-three pikin wey e papa bon but na onli Abiola no kpai from smol pikin. All di oda pikin-dem wey e papa dey bon jos dey kpai wen dem still dey smol. E oda nem "Kashimawo" mins "Mek we still wait an see wetin go happun"'.

Wen Abiola no gri kpai till e rish 15 years old, e peret kom give am anoda nem wey bi "Moshood".

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abiola go Afrika Sentra Skul wey de Abeokuta for e pamari edukeshon. Wen e still smol, Abiola dey helep e papa for di kokoo bizness wey e papa dey do. Afta somtimes, di Kokoo bizness no move again bikos di inspetor tok sey Abiola papa Kokoo no bi orijina Kokoo. Abiola kom start to dey sell fayawood so dat e go fit sopot e famili. Abiola kom start to gada smol smol pikin-dem togeda wen e de 15 years, an dey go sing for parti so dat pipo fit give dem fud to chop. Dis tins wey e dey do mek am fit pay e skul moni for Baptist Boys Hi Skul wey de Abeokuta. For di skul magasin kol Trumpeter Abiola bi di editor an Olusegun Obasanjo bi e deputi editor. Wen Abiola bi 19 years old, e join Nashonal Kansu of Nigeria an di Kameroon. Dat time, Obafemi Awolowo don get one parti kol Action Group.

Naija govamet give Abiola free edukeshon to go stodi for University of Glasgow in 1960. E rid Akantin from di Yunivasiti an Abiola bikom an Akauntant. Abiola leta bikom a graduate of ICAN ( Institute of Chartered Accountants of Nigeria]].

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abiola start to dey wok for Barclays Bank wey de Ibadan, Naija in 1956 as "bank klark" Afta wen e don wok as bank klark for two years, Abiola komot go join Western Region Finance Corporation as dia ezekutiv akaunt ofisa. Na for dis time, Abiola tek get chans go Scotland to rid more buk for Glasgow Yunivasiti.

Wen Abiola kom bak to Naija, e wok as sinior akauntant at di Yunivasiti of Legos Tishin Hospitu. E komot go anoda kompini kol Plizer. Plizer na one kompini wey de Naija but na US kompini dey kontro am. Abiola komot for Plizer kom join ITT Korpureshon an e leta bikom di vais-presidet of di korpureshon.

How e tek do politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abiola tok for February 1993 sey e wan bi presidor of Naija. E yuz SDP tek kampain.

Wen Abiola dey kampain to bi presidet of Naija, E yuz some slogan like "Farewell to poverty", "At last! Our rays of hope" an di "Burden of Schooling". Abiola tok sey e go tok with oyinbo kontri mek dem helep ridus di moni wey Naija wan pay dem bak an sey e go manej di lokal moni wey Naija wan pay too.

  • June 12 presidenshial eleshon

For di 12 June 1993 presidenshial eleshon kampain, Abiola pik Baba Gana Kingibe as e vais for di eleshon. For di eleshon Abiola win Bashir Tofa of di National Republican Convention. Meni pipo both for Naija an Oyinbo kontri tok sey di eleshon dey gud an sey no mago mago or ojoro for di eleshon. Abiola even win Kano Stet di stet wey e opponet tek kom from. Na Abiola win Abuja, militiri pollin stashon, an ova twenty-four stet wey de di kontri. For Naija, na pipo wey kom from North meni pass of politis. For Abiola to kom go win dat plenti vote rilis sopris pipo.

Di fact bi sey, forma militiri presidor Ibrahim Babangida kansu di risot of di eleshon. Wetin Babangida do so bring plenti fight-fight an wahala an dis one mek jeneral Sani Abacha fight an kolet pawa to kontro di kontri one year leta. Dis na di risot wey fit bi di one wey Ibrahim Babangida kansu:

State SDP (Abiola) NRC (Tofa) State SDP (Abiola) NRC (Tofa) State SDP (Abiola) NRC (Tofa)
Abia 105,273 151,227 Enugu 263,101 284,050 Niger 136,350 221,437
Adamawa 140,875 167,239 Imo 159,350 195,836 Ogun 425,725 59,246
Akwa Ibom 214,787 199,342 Jigawa 138,552 89,836 Ondo 883,024 162,994
Anambra 212,024 159,258 Kaduna 389,713 356,860 Osun 365,266 72,068
Bauchi 339,339 524,836 Kano 169,619 154,809 Oyo 536,011 105,788
Benue 246,830 186,302 Katsina 171,162 271,077 Plateau 417,565 259,394
Borno 153,496 128,684 Kebbi 70,219 144,808 Rivers 370,578 640,973
Cross River 189,303 153,452 Kogi 222,760 265,732 Sokoto 97,726 372,250
Delta 327,277 145,001 Kwara 272,270 80,209 Taraba 101,887 64,001
Edo 205,407 103,572 Lagos 883,965 149,432 Yobe 111,887 64,061
sub-total 2,134,611 1,918,913 2,740,611 1,992,649 Fct 19,968 18,313
3,465,987 2,040,525
Cumulative 8,341,309 5,952,087

For 1994, Abiola go tok sey na im sopoz bi presidet of Naija wen e de Epetedo aria of Legos. Epetedo na one aria of Legos wey yoruba pipo plenti de. Di fact bi sey, Abiola jos kom bak from oyinbo go get bak-up for di eleshon wey jos hapun. Afta wey Abiola tok sey na e sopoz bi presidor, Jeneral Sani Abacha send 200 polis motor mek yuz harest am. Di risin wey Abacha give bi sey, Abiola dey dis-loya to di kontri an sey e wan skata di kontri. Dey kill Abiola wife Halaja Kudirat Abiola in Legos in 1996 bikos e wan mek pipo sopot e hosband wey de prisin. Na for 4 years Abiola tek de prisin. Nobodi fit kom see am for prisin an na onli Bible, Qur'an de with Abiola. Dey mek suo sey na 14 pipo dey luk am for prisin.

Pope John Paul II , Ark-Bishop Desmond Tutu an meni pipo wey dey fight for human right from all ova di wold beg Naija govamet sey mek dey rilis Abiola. Di fediral govamet tok sey dem go rilis am on one kondishon onli: Mek e no tok abaut di June 12 eleshon again for e life. Di fediral govamet tok sey dem go give am all di moni wey e don loss for di eleshon. Abiola no gree to do dis one an dis one mek am still de prisin. E pain Abiola wel wel wen e hie sey Kofi Annan an Emeka Anyaoku tok sey e don gree to dat kondishon. Di risin wey mek Kofi Annan an Emeka Anyaoku mit Abiola an tok wit am bi sey, Nobodi for di wold go wan lisin to eni eleshon wey don rish five years.

How e tek kpai[chenj-am | chenj-am for orijin]

E no tey wey Jeneral Abacha kpai, Abiola sef kpai. Na di day wen federal govamet wan rilis Abiola na im Abiola kpai. Abiola kpai for di mitin wey e dey do with Amerika ambasedor Thomas Pickering an Susan Rice for govamet guest house in Abuja. Na Rice give Abiola tea wey e drink bifor e kpai for dat mitin. Wen doktor for Naija, Kanada an UK chek e dead-bodi, dey see sey Abiola get hart-problem sins.