Emeka Anyaoku

From Wikipedia
Emeka Anyaoku
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemEmeka Chenj-am
Wen dem bon am18 January 1933 Chenj-am
Ples wey dem bon amObosi Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dudiplomat Chenj-am
Post wey e deyCommonwealth Secretary-General, Commonwealth Deputy Secretary-General, Minister of Foreign Affairs, Permanent Representative of Nigeria to the United Nations, ambassador Chenj-am
Wie e go skulUniversity of London, University of Ibadan Chenj-am
E pipulIgbo pipul Chenj-am
Memba ofClub of Rome Chenj-am
Awod wey e koletKnight Grand Cross of the Royal Victorian Order, Livingstone Medal Chenj-am

Emeka Anyaoku GCON, GCVO, CFR, CON (dey bon am 18 January 1933) na Naija ambassador wey kom from Igbo tribe. Na Anyaoku bi di nomba three pesin to bi di Komonwet Sekretri-Jeneral. Dey bon am in Obosi an e go "Merchants of Light School, Oba" an Yunivasiti of Ibadan. Anyaoku stil go rid Klassik for Yunivasiti of London. Anyaoku na Shiff as e tradishonal tahitu na Ichie Adazie of Obosi.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Eleazar Chukwuemeka "Emeka" Anyaoku on 18 January 1933. E papa nem na Emmanuel Anyaoku an e mama nem na Cecilia Anyaoku. Anyaoku vilej na Obosi, one big vilej wey de Easta pat of Naija. Anyaoku go CMS Skul wey de Onitsha an na Rev. William Blackett wey bi kristen mishonari dey kontro di skul dat time. Afta e skul, Anyaoku go wok for train steshon an e leta go wok for one hospitu wey de Kaduna Stet. Anyaoku leta bikom a ticha . E kom bi di oga patapata of Okpuno Ire, one vilej wey big pass for Obosi.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Anyaoku bi seven year old, dem Kari go mit e onku Egwuenu Anyaoku so dat e go fit go skul. Dis e onku na di onli broda wey Anyaoku papa get. Di onku dey stey for Umuahia. For dat time, na onli up to standad 4 or standad 6 di oyinbo pipo gri mek pipo fit rid.

Wen Anyaoku rish ten years in 1943, e go stey with e papa konsin Nathaniel Enwezor, wey bi di hed-masta for CMS Sentral Skul for Agbor in Obosi.

For e sekondri skul, Anyaoku go MOLS ( Menchants of Light School) wey de Oba. Di skul na one bordin skul wey e papa frend, Dr Enoch Oli gets