Jump to content

Abuja

From Wikipedia
Abuja
city, big city, federal capital, human settlement
Inception1828 Chenj-am
Official nameAbuja Chenj-am
Native labelAbuja Chenj-am
DemonymAbujanais, Abujanaise, абуджа́нец, абуджа́нцы Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Capital ofNaija, FCT, Abuja Municipal Chenj-am
Located in the administrative territorial entityFCT Chenj-am
Located in time zoneUTC+01:00 Chenj-am
Coordinate location9°3′20″N 7°29′29″E Chenj-am
Memba ofWorld Tourism Cities Federation Chenj-am
Twinned administrative bodyBrasília Chenj-am
Official websitehttps://fcta.gov.ng/ Chenj-am
Time of earliest written record1700 Chenj-am
Category for the view of the itemCategory:Views of Abuja Chenj-am
Map

Abuja na di capital city of Nigeria, [1]e dey for middle of the country well well inside Federal Capital Territory (FCT). As di headquarters of di Federal Government of Nijiria, plenti important national ofis, landmarks, and buildins dey spread across more than 50 districts wey dey insaid di Siti. Dem move di capital from Lagos (wey be di most populated city for Nigeria) come Abuja on 12 December 1991.[2]

Abuja giografi dey mainly show for Aso Rock, one big rock wey stand about 400 metres, wey water erosion form. Di Presidential Complex, National Assembly, [3]Supreme Court of Nigeria, and many parts of di city dey south of di rock. Zuma Rock, wey be 725 metres high, dey north of di city for di expressway wey dey go Kaduna.[4][5][6]

For 2006 census, Abuja get population of 776,298 people and 179,674 households, wey mek am one of di ten most populated sitis for Nijiria (number eight for 2006). Akoding to United Nations, Abuja grow reach 139.7% betwin 2000 and 2010, wey make am di fastest-growing city for di world that time.[13] As of 2015, di city still dey grow at least 35% every year, still holding di position as di fastest-growing city for Africa and one of di fastest for di world.[7]

Big religious places for di city include Nigerian National Mosque and Nigerian National Christian Centre. Nnamdi Azikiwe International Airport dey serve di city. [8]People sabi Abuja as one of di few capital cities for Africa wey dem plan and build from scratch, and e still be one of di richest.[9]

Abuja na di administrative and political capital of Nigeria. E still be very important capital for Africa because of Nigeria geopolitical influence for regional matters. Abuja na also conference centre wey dey host many meetings every year, like di Commonwealth Heads of Government Meeting 2003 and di World Economic Forum on Africa 2014. Abuja join UNESCO Global Network of Learning Cities for 2016.

Where Wi See Di Tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. https://www.britannica.com/place/Abuja-national-capital-Nigeria
  2. https://en.wikipedia.org/wiki/Abuja#CITEREFAbba2012
  3. https://www.nassnig.org/
  4. https://web.archive.org/web/20220627170359/https://www.visitnigerianow.com/tours/zuma-rock/
  5. https://web.archive.org/web/20100323002129/http://www.sunnewsonline.com/webpages/features/citysun/2008/may/28/citysun-28-05-2008-002.htm
  6. https://en.wikipedia.org/wiki/Abuja#cite_note-10
  7. https://web.archive.org/web/20160204113031/http://www.abujafacts.ng/top-5-cities-to-do-business-in-nigeria-abuja-is-2nd/
  8. https://www.travelstart.com.ng/lp/airports/cheap-flights-nnamdi-azikiwe-international-airport
  9. http://news.bbc.co.uk/2/hi/africa/6355269.stm