Nasir El-Rufai

From Wikipedia
Nasir El-Rufai
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejNasir Ahmad el-Rufai Chenj-am
Orijina nemNasir Ahmad el-Rufai Chenj-am
Wen dem bon am16 February 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amDaudawa Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Kaduna State, Minister of the Federal Capital Territory Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University, University of London, John F. Kennedy School of Government, Georgetown University, Barewa College Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
E pipulHausa pipul Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Medical conditionCOVID-19 Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Nasir Ahmad El-Rufai CON (dem bon am for 16 February 1960) na Naija politishian wey don bi govno of Kaduna Stet from 2015 go rish 2023. El-Rufai na bifor bifor minista of di Fediral Kapital Teritiri from 2003 go rish 2007. E don bi daretor of di Dipatmet of Poblik Entaprisis. El-Rufai bi one of di pipo-dem wey form APC (All Progressive Kongress.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na on 16 February 1960 dey bon Nasir Ahmad El-Rufai inside one Fulani famili wey de Daudawa. Daudawa na one Fulani vilej wey de Kaduna. Wen El-Rufai dey 8 year, e papa kpai an dis one mek e onku wey de Kaduna dey tekia of am. Na El-Rufai onku kari am go an pay moni for El-Rufai pamari an sekondiri skul.

Na three wife El-Rufai mari. E fest wife na Hadiza Isma El-Rufai wey bi raita wey dey rait novel. Na El-Rufai fest wife dey kontro di Yasmin El-Rufai Fondashon (YELF). Di Fondashon na to rimemba dia gel-pikin wey kpai in 2011.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

E get satifiket of masta digree in Poblik Hadministrashon from John F. Kennedy Skul of Govamet of Harvard Yunivasiti on June 2009. El-Rufai go Barewa Kolej. Wen e stil be junior for Balewa Kolej dat time, na former presidor Umaru Yar'Adua bi di house kaptain for di hostel wey El-Rufai stey.

Wen El-Rufai finish di skul in 1976, na im no buk pass an e kolet di awod "Barewa Old Boys Association Academic Achievement" Awod.

El-Rufai go Ahmadu Bello Yunivasiti wey de Zaria. For di Yunivasiti, e kolet Bashelor Digree (B.Sc) in quantity surveying with fest klass honor.

El-Rufai do e masta in Bizness Hadiministrashon an e finish in 1984 from Ahmadu Bello Yunivasiti. El-Rufai don go meni profeshonal program like Georgetown School of Foreign Service in Georgetown Yunivasiti Georgetown Yunivasiti de Washington, D.C. E don also go meni program on privataliseshon an lidaship.

El-Rufai risiv a Law digree from di Yunivasiti of London on August 2008. E get satifiket of masta digree in Poblik Hadministrashon from John F. Kennedy Skul of Govamet of Harvard Yunivasiti on June 2009.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

El-Rufai form El-Rufai & Partners, one kwuliti surverin kompini wey dey advais pipo on how dia budin go mit standard budin. El-Rufai form di kompini with three partna an di kompini in 1998. Durin di time wey militiri souja dey kontro Naija from 1983 go rish 1998, El-Rufai & Partner kolet meni budin an sivil enjinerin wok. Na im stil kolet some kontrat in Abuja an dis kontrat mek dem "young millioniha".

El-Rufai stil get manijimet wok for two intanashonal fone kompini. Di nem of di two kompini na AT &T Netwok sistems intanashonal BV an Motorola Inc.

How e tek join politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen di head of stet, Jeneral Sani Abacha kpai in 1998, di presidor wey tek ova, Jeneral Abdulsalami Abubakar chuz El-Rufai as di ekonomik advaisa of Naija. Dis wok mek am fit wok with Wold Bank an IMF (Intanashonal Monitori Fund.

Wen di militiri komot for pawa an demokrasi mek Olusegun Obasanjo di presidor of Naija in 1999, Obasanjo chuz El-Rufai as di daretor of di Bureau of Poblik Enterprises an seketiri of di Nashonal Kansu of Privataseshon wey e join bodi wok with di dwn Vais Presidet Atiku Abubakar.

El-Rufai tok sey e wan kampain to bikom di govno of Kaduna Stet.

How e tek riton to politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

El-Rufar waka komot from Naija in 2008 an wen e dey outside di kontri, e jos dey tok bad tins wey Umaru Yar'Adua govamet dey do.

In 2010, El-Rufai kom bak to di kontri an di EFCC (Ekonomik an Finashial Krime Kommishon harest am kwik-kwik. El-Rufai tok sey e kom bak to Naija bikos e wan wash e nem from di bad bad tins wey pipo dey hakuss am of. For 2011, El-Rufai join di politikal parti CPC (Kongress for Progresiv Chenj). CPC parti sopot Muhammadu Buhari Kampain in di 2011 presidetal eleshon.

For 2013, El-Rufai bikom di deputi nashonal sekretiri of di niu politikal parti APC ( All Progresiv Kongress). E win di eleshon an e yuz ova 1 millon vote pass di govno of Kaduna Mukhtar Ramalan Yero wey komot as PDP (Pipo Demokrati Parti).

El-Rufai stil win di sekod term eleshon e enta as govno for di sekod time on 9 March 2019. E yuz ova 200,000 vote tek pass e sekod kandidet.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]