Ahmadu Bello University

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Ahmadu Bello University (ABU) na fediral risach yunivasiti wey dey Zaira for Kaduna Stet in Naija.Na for 0ctober 4, 1962 dey kret di skul as di fest yunivasiti for Norta Naija. Dey yuz di nem of Sardauna of Sokoto, Alhaji Sir Ahmadu Bello wey bi di fest premiha of Norta Naija.Di yunivasiti get two kampos, di main one wey bi Samaru an di sekond one wey bi Kongo in Zaira.Di yunivasiti get pre-digri skul for Funtua wey bi like 85 kilomita fom di main kampos.Na di Samatu kampos get di house wey administrative ofis an falkoti of Fisika sayens, Life sayens, Soshial sayens, Art an Langwej, Edukeshon, Envaromenta disin, Enjiniarin, Medikal Sayens, Agrikolshoral Sayens an risach senta. Di kampos wey dey Kongo get Falkoti of law an Administrashion.Di Falkoti of Administrashion get Akauntin, Bizness Administrative, like lokal Govanment an Divelopment Stodis an Poblik Administrashion. Di yunivasiti stil dey kontrol odas institushion an program for oda Lokashion. Ahmadu Bello University dey ofas ondagraduate an post graduate program an som vokashional digri korse. Di yunivasiti stil dey ofa Medikal program wey ABU tishin Hospitu wey bi one of di tishin Hospitu wey big pass for Naija an Afrika dey assist

Falkoti wey dey di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di yunivasiti get 13 falkoti an dey bi:

Faculty of Medicine[chenj-am | chenj-am for orijin]

The Faculty of Medicine

Institute wey dey di yunivasiti[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Institute of Education
  2. Institute for Agricultural Research
  3. Institute of Administration
  4. Iya Abubakar Institute of ICT
  5. Institute of Development Research and Training
  6. National Animal Production Research

Tori of di yunivasiti[chenj-am | chenj-am for orijin]

As time dey rish mek Naija get Indipendent for October 1, 1960, na onli one yunivasiti dey di hol kontri, Yunivasiti of Ibadan wey di kret in 1948.Di Ashby komission ripot wey dey somit one month bifor Indipendent advais seye mek one one yunivasiti dey di three rijion an di den kapital of Naija, Legos.Bifor di rupot sef, di Rijional Govament don dey plan to get Yunivasiti.For May 1960, di Norta Rijion don upgrade di Skul of Arabik Stodies in Kano to Ahmadu Bello kolej for Arabik an Islamik Stodies. (Dey chenj di nem to honor di Politika lida Alhaji Sir Ahmadu Bello) Di Ashby komission ripot kom ginja dem an dey kom diside sey na for Zaria dem go fom di skul no bi Kano. Di niu yunivasiti go tek di buildin of "Nigeria College of Arts, Science and Technology" an go stil join "Ahmadu Bello College "wey dey Kano join bodi.


Pipul-dem wey don bi Vais Shansellor[chenj-am | chenj-am for orijin]