Mr Macaroni

From Wikipedia
Mr Macaroni
pesin
Industryentertainment industry Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemDebo Chenj-am
Famili nemAdebayo Chenj-am
Wen dem bon am3 May 1992, 3 May 1993 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey ducomedian, actor Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts, comedy Chenj-am
Wie e go skulRedeemer's University Chenj-am
Wen e stat wok2012 Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
FilmographySurvivors, Ayinla, Ponzi Chenj-am
Awod wey e koletThe Future Awards Africa Prize for Filmmaking, City People Entertainment Awards Chenj-am
Nominated forThe Future Awards Africa Prize for Filmmaking, City People Entertainment Awards, Best of Nollywood Awards Chenj-am
Official websitehttps://mrmacaronitv.com Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Adebowale "Debo" Adebayo (dey bon am 3 May 1993) wey pipo no wel wel as Mr Macaroni na Naija aktor, pesin wey dey do smol smol fims wey de mek pipo laff an e dey kari pipo mata for head. Pipo start to dey no Mr Macaroni wen e start to dey do smol smol fim wey dey mek dem laff on soshal midiha. For dos vidio, e dey do like politishan an Suga daddi or like professor. Meni nems wey dey tek no Mr Macaroni for e fim na "Daddi wa" an "Professor Hard life". Pesin go no sey na Mr Macaroni dey tok wen di pesin hear "Freki Freki", "You are dorin wel" an "Ooin". Mr Macaroni dey yuz e fim tek fight for pipo wey no get pawa to helep diasef. In fat, Mr Macaroni see shege wen e join sopot di fight to komot how polis dey do enihow for di 2020 #ENDSARS.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ogudu, Legos Stet dey bon Mr Macaroni on 3 May 1993. Mr Makaroni famili get moni an na bot Kristen an Moslim dey inside e famili. Na for Ogun Stet e gra papa-dem kom from. Mr Makaroni gro up for Magodo aria wey de Legos.

Mr Makaroni go Tendecare Intanashibal Noseri an pamari skulwey de Ojota, Ogudu. But di skul now de for Magodo Isheri. Na Babcock Yunivasiri High Skul e go for e sekondiri skul edukeshon. In 2009, Mr Makaroni enta Lead Yunivasiti to go rid law but e komot for year 2 bikos of sey Naija govment no gree mek Lead Yunivasiti dey tish law. By di time wey 2011 wan kom, Mr Macaroni don de Houdegbe North American Yunivasiti, wey de Cotonou in Riploblik of Benin dey rid law. Bikos of sey e dey like dey tok an e no like shitin for skul, di skul tel am mek e dey go an e no kom finish to kolet e satifiket for di Yunivasiti.

Mr Makaroni kom tok for e mind sey e no go skul again, but e go dey do fims. E kom akt inside some komedi fims for somtimes. Sins Mr Makaroni peret wan mek e shaa go skul, e kom chuz to go rid Tihata Akt (Theatre Act) fpr Afe Babalola Yunivasiti wey de Ado-Ekiti for Ekiti Stet. Mr Macaroni no stil finish e stodi for Afe Babalola Yunivasiti bikos of one tin one tin like dat.

Mr Makaroni in 2013 enta Redeemer's University Nigeria wey de Ogun Stet an na for dis Yunivasiti e kom finali finish an kolet e digree satifiket in Tihata Akt an Fim Stodis in 2018.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Mr Makaroni fest start to dey akt for Nollywood bifor e enta mekin smol smol komedi vidio. Mr Macaroni tok sey na bikos of sey pipo no kol am for fim mek am start to dey do komedi vidio by imsef E tok sey for e komedi vidio, e like to dey fo like Suga Daddi bikos plenti Suga Daddi plenti for our aria wey no fit kontro diasef.

Mr Makaroni tok sey e no sey e go sabi komedi bikos wen e dey kopi how pasto Chris Oyakhilome dey tok, meni pipo dey laff wel wel.

For e smol smol komedi vidio, Mr Makaroni dey yuz popula aktor an aktress. Som of di popula aktress an aktor bi: Jim Iyke, Bimbo Ademoye, Lateef Adedimeji, Sola Sobowale, Falz an Mr.P. Mr Makaroni don also yuz of e fonni memba wey dey do komedi vidio like am. E don yuz Mr Funny (Oga Sabinus), KieKie, Remote, an Broda Shaggi. Ooni of Ife Adeyeye Enitan Ogunwusi don de Mr Makaroni smol smol komedi vidio tu.

Fims-dem wey e don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Tahitu wetin e do Notes Ref
2021 Ponzi Uchenna
Ayinla Bayowa
2022 Survivors (2022 film)
Aníkúlápó (film) Akanji
King of Thieves: Agesinkole
Brotherhood
2023 Gangs of Lagos
Jagun Jagun

TV show[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tahitu Wetin e do References
Okirika Alaga
Ile Alayo Sweet Daddy
Flatmates AK 47
The Johnsons Casper

EndSARS[chenj-am | chenj-am for orijin]

Mr Makaroni don rili join di End SARS kampain. On Saturday, 13 February 2021, Polis harest am for Lekki Roll Gate dorin di #OccupyLekkiTollgate protest.

On February 2021, Polis harest an not Mr Makaroni an plenti oda pipo wey dey protest

Awod-dem an Nomineshon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Awod karigori Risot Reference
2018 Best of Nollywood Awards Revelation of the Year – male Nominated
2020 The Future Awards Africa Content Creation Won
City People Music Award Comedy Act of the Year Won
2021 Net Honours Most Popular Comedian Nominated
2022 Africa Magic Viewers' Choice Awards Best Online Social Content Creator Nominated
2021 Gage Awards Online Comedian of the Year Won