Mr Funny

From Wikipedia
Mr Funny
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am30 January 1995 Chenj-am

Emmanuel Chukwuemeka Ejekwu wey pipo sabi wel wel as Mr Funny or Oga Sabinus na Naija pesin wey dey akt fonni tins an aktor.

Hau e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Port Harcourt Mr Funny tek stat e edukeshon an e go Yunivasiti of Port Harcourt go rid "Linguistics and Communication". Mr Funny get e B.Sc digree from di Yunivasiti.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 2015 Mr Funny stat to dey du komendi but pipo start to sabi am wel wel in 2019.

Wen di nem of pipo wey dem wan give awod for di niu 2021 "The Humor Awards Academy" serimoni, Mr Funny nem kom out as one of dos komendia wey fit win di aword. Baskemouth nem sef folo for di katigori.

Na from smol pikin Mr Funny don sabi do fonni tins but wen e enta yunivasiti, e kom put bodi for komendia wel wel for skul.

For 2015 Skul Student Union wik, e rili paform wel wel for di wik. Afta dat time, Mr Funny kom stat to dey post e smol smol fonni vidio for soshal midiha. Na for Instagram e post am pass. Afta wey e don post meni fonni vidio for Instagram, meni pipo kom dey post e vidio for instagram. Mr Funny yuz di one popula an e kom get plenti folowas.

Mr Funny bi di brand ambasedor for one popula bettin site: Oddstackr an meni oda one. Some of di komendia wey Mr Funny dey folo dia footstep bi Mr Ibu an Charles Inojie.

Na Mr Funny win di "Best Male Skit Maker" katigori of di Legit.ng awod 2022. Di oda nem-dem wey dem nominee for di katigori na: Funnybros, Mr Macaroni an Broda Shaggi.

Mr Funny don akt for some Naija muvi-dem like: "Billionaire's Bride", "Man of War" an meni odas.

For May 2022, Mr Funny kari two fud kompini go kot bikos dey yuz some of e wok tek advatass dia prodot for e bak. Di two fud kompini na Friesland Food an UAC. Friesland Food yuz di wods wey pipo tek no Mr Funny "somtin hoodge" tek advatass an UAC draw di babi piksho of Mr Funny tek advatass dia prodot.

Mr Funny in September 2022 go do e sho for London an di nem of e sho bi:"Oga Sabinus at the Lighthouse event centre".

Awod wey e get[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Award Category Result Ref.
2021 DENSA Awards The Creative Social Media Won [1][2][3]
2022 Africa Magic Viewers' Choice Awards Best Online Social Content Creator Won [4][5]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. independent.ng (2021-09-09). "DENSA Awards 2021: Outstanding Personalities, Professionals In Media Industry Honoured". Independent (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2021-10-12.
  2. Guardian.ng (2021-09-07). "Stars shine bright as DENSA Awards 2021 rewards excellence". Guardian (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2021-10-12.
  3. thisdaylive.com (2021-10-09). "Glamour, Glitz at DENSA 2021". Thisday (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2021-10-12.
  4. "2022 Africa Magic Awards Nominees don land- See who dey list". BBC News Pidgin. Retrieved 2022-03-26.
  5. "AMVCA 8: Sabinus beats Mr Macaroni, others to win Online social content creators' award". Vanguard News (in Brítísh Ínglish). 2022-05-14. Retrieved 2022-05-14.