Jim Iyke

From Wikipedia
Jim Iyke
pesin
Industryfilm industry, cinema of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemJim Chenj-am
Wen dem bon am25 September 1976 Chenj-am
Ples wey dem bon amLibreville Chenj-am
Unmarried partnerNadia Buari Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, pesin wey dey rait song, businessperson Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Jos Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Wen e stat wok2001 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Official websitehttps://jimiykesworld.com Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

James Ikechukwu Esomugha, wey pipul no as Jim Iyke, na Naijà aktor wey don mak pipul enjoi beta fim lik Last Flight to Abuja wey im do wit Omotola Ekehinde an Hakeem kae-Kazim.

Im life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am fo 25 septemba,1976 fo Libreville, Gabon. Im mama an papa na Mr an Mrs Steven Okolue,wey dem las nam kon change to Esomugha fom Ogwugwu Vilaj fo Enugu Agidi town of Anambra State. Na Jim iyke bi di onli boi fo im famili wey bi 8 pikin. Im go skul fo 'Federal Government College, Kwali Abuja fom 1985 rich 1991. Jim Iyke stil go University of Jos,Pleateu State na Banking and Finance im go stodi fo di skul.Im get B.S.C fo Philosophy sef.

Hau im tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jim Iyke stat to dey akt fo 2001. Im dey for pipul wey dey kolet moni pass fo Nollywood, e don sho fo fim wey pas one hondred an fity(150).Im stat im fim compini wey bi Untamed Production fo 2007. Jim Iyke stil get music rekod label wey im nam na, Untamed Records. Im do one album wey im nam am Who im I?, for di album Tuface Idibia an Sound Sultan folo do song wit am inside.

Hau im tek dey hep pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Esomugha stat Jim Iyke Foundation for Children with Disabilities,wey dem do to dey hep pipul. Im go Kenya fo December 2012 to go sho say im dey sopot Make a Change Campaign, im go sopot dem bcos dem dey hep pipul sef.Na Christopher Grey an Cecile wey dey sing fo Jamiaca gada do.

Im persona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jim Iyke get awod fo teakwando.Fo April 2019, im tok fo Instagram say im don bon pikin. Na fo dat Instagram, im tak sho im wif an pikin fo pipul.

Fo Januari 2021 Jim iyke tok say im lik Davido pas Wizkid, im tok dis one wen dem dey ask am kweshon abot im lif fo Net.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]