Adeyeye Enitan Ogunwusi

From Wikipedia

Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi CFR (dey bon am October 17, 1974) bi di 51 Ooni of Ife an e stil bi di niu Ooni of Ife. Ooni of Ife bi di tradishonal rula an king of di Yoruba kindom of Ile-Ife. Na for 2015 dey mek Ogunwusi di Ooni of Ile-Ife afta wey Oba Okunade Sijuwade kpai. Oba Okunade Sijuwade bi di nomba 50 pesin wey get di taitu Ooni of Ife.

Tori abaut e four-four fada-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi wey pipo sabi as Ojaja II kom from di famili of Giesi, one of di four roya famili of di House of Oranmiyan. E papa gra-fada bi Prince Joseph Olagbaju Adewole Ogunwusi. Prince Joseph Ogunwusi gra-fada bi Oba Orayegba ( pipo sabi am as Ooni Orarigba or Orasigba) Ojaja I. Oba Joseph Ogunwusi bi di 44 Ooni of Ife an e kontro Ife from 1878 go rish 1880.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oguwusi go Subuola Memorial Nursery and Primary School wey de Ibadan. E kom go Layola Kolej, Ibadan but finish e sekondri skul for St. Peters Secondary School, Ile-Ife. Na for St. Peter e tek rait e WAEC. Ogunwusi go rid akauntin from The Polytechnic, Ibadan. Ogunwusi get honorari Ph.D satifiket in poblik hadiministrashon from Yunivasiti of Nigeria, Nssuka. Igbinedion Yunivasiti give Ogunwusi a honorari Ph.D in Law.

Oba Ogunwusi bi di shanselor of Yunivasiti of Nigeria, Nssuka.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogunwusi na memba of di Institute of Chartered Accountants of Nigeria. E stil bi associate accounting technician. Ogunwusi bi memba of Institute of Directors. Ogunwusi bi memba of di Global Real Estate Institute

How e tek bikom Oba[chenj-am | chenj-am for orijin]