Jagun Jagun

From Wikipedia
Jagun Jagun
film
Stai of song abi fimdrama film Chenj-am
Country of originNaija Chenj-am
Original language of film or TV showYoruba Langwej Chenj-am
Publication date10 August 2023 Chenj-am
Cast memberFemi Adebayo, Lateef Adedimeji, Faithia Williams, Bukunmi Oluwashina, Bimbo Ademoye Chenj-am
ProducerFemi Adebayo Chenj-am

Jagun Jagun ('Di Warrior) na one 2023 Netfix tradishonal yoruba fim wey Femi Adebayo Salami an Euphoria 360 Media produs. Na Tijani an Tope Adebayo Salami daret di fim. Di aktor an aktress-dem wey de inside di fim bi: Femi Adebayo, Lateef Adedimeji, Bimbo Ademoye, Faithia Balogun, Mr Macaroni, Bukunmi Oluwasina, Ibrahim Yekini, an Muyiwa Ademola. Dey rilis Jagun Jagun on Netflix stremin site on 10 August 2023.

Wetin hapun inside di fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jagun Jagun na ond fim wey tok di tori one wey fighta Ogundiji. For di fim, Ogundiji start to dey jelos one young fighta Gbotija wey kom len fight-fight so dat e kom fit kil pipo-dem wey kom dia vilej kom kil e famili for war. Ogundiji na fighta wey dey komot beta king from dia kindom an dey put di king wey like an sopot am eni time wey e go war. Wen pipo kom start to dey no Gbotija wel wel, dis one kom dey mek Ogundiji dey vex more more

Pipo wey akt inside di fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oda tins about di fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na one month dey tek fim Jagun Jagunfor SoutWest in Naija. Bukunmi Oluwasina wey akt inside di fim tok sey Femi Adebayo don chuz am to akt inside di fim one year bifor dey start to do di fim.Bukunmi rilis tok beta tins about di prodorshon of di fim s e tok sey na rili big wok. Femi Adebayo wey don produs King of Thieves bifor tok sey e wan mek Jagun Jagun big an beta pass King of Thieves. Wen dey rilis Jagun Jagun on 10, August 2023, witdin 48 hours, di fim kom de popula for United Kingdom an 17 oda kontri. Foe jos three days, 3,700,000 don see di fim. Dis one mek di Jagun Jagun one of di ten fim-dem wey pipo see dorin dat time.