Faithia Balogun

From Wikipedia

Faithia Balogun (dem bon ha February 5, 1971)shi bi Nigerian actress, fimmeka,Produsa,an Director.

How Shi Tek Stat Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Faithia kom from Delta State but dem bon ha for lkeja for February 1971. Ha papa mari plenti wumen an dem bi nine pikin wey di papa bon. Faithia skul for Maryland primari skul an Maryland komprihensiv sekondari skul for Legos stet na there shi get ha West Africa school Certificate. Afta shi go stodi for Kwara State Politeknik for ha diploma satifiket. For 2016 Faithia gen admishon to Olabisi Onabanjo yunivasiti to stodi aktin.

How Shi Tek Stat Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Faithia Stat to dey akt by lok. Faithia unkle Alhaji Fatai Teniola kol am mek shi kom akt di role of di persin wey no kom for di prodoshon of their muvi. Williams akt ha fest rol for di fim wey di taitu na "Ta Lo Pa Chief" Shi don Starr,Produce, an dairet meni meni Nigerian Films for meni yearz.For 2008 shi win di Africa movie Academy Awards for di most outstanding Aktres indigenous an ha muvi Iranse Aje win di Best indigenous fim of di year. For April 2014 shi win di Afrika muvi Akedemi Awods, Shi folo win as di best aktres of di year alog wit Odunlade Adekola wey win best akto of di year. Shi kon stil win di Best indigenous langwej awod for di wok wey shi du for di fim "Iya Alalake " for 2015 Africa magic viewers choice Awods(AMVCA)

How Shi Liv Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Williams fest mari wan veteran noliwud akto wey im nem na Saheed Balogun an dem get two pikin togeda one boi pikin an one gel pikin. Faithia stil get anoda boi pikin for ha haili relashonship.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Most Outstanding Indigenous Aktres (2008)
AMVCA Best Local Langwej Yoruba (2015)

Fim Wey Shi Don Du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Edit

Farayola (2009)
Aje meta (2008)
Aje metta 2 (2008)
Awawu (2015)[14]
Teni Teka (2015)[15]
Omo Ale (2015)
Agbelebu Mi (2016)
Basira Badia (2016)[15]
Adakeja (2016)[15]
Eku Eda (2006)[15]
MY WOMAN (2018