Faithia Williams

From Wikipedia

Faithia Williams (Dem bon am for February 5, 1971) na Naijá aktress, fim-meka, produsa an dareto.

Tori of e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for February 5, 1971 dem bon Faithia an na Delta Stet im papa kom fom.Faithia papa mari nine waif. Faithia go Maryland Primary School an Maryland Comprehensive Secondary School in Legos Stet.E du e WAEC (West African School Certificate) for Maryland Comprehensive Secondary School. Afta dat, Faithia go Kwara State Polytechnic go get diploma satifikat.In 2016, Faithia enta Olabisi Onabanjo University to go rid Fiming.

Tori of e karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Faithia no get am for mind to bi aktres, bot wen e Onku Alhaji Fatai Teniola dey luk for hu go du one pat bikos di aktres wey soposs du am no kom, e tok sey mek Fathia akt di pat of di aktres wey no kom.Di nem of dat fim na "Ta lo pa chief".Sins dat taim, Faithia don akt, produs an daret meni Naijá fim ova di years.

Awod wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • In 2008, Fathia win di Africa Movie Academy Award for The Most Outstanding Aktress Indigenous
  • Fathia fim Iranse Aje win The Best Indigenous Film of the year for 2008.
  • In April 2014, Faithia win for di Africa Movie Academy Award as di best aktres of di year an Odunlade Adekola win di best Aktor of di year.
  • Fathia win di Best Indigenous Language award for di wok wey e du insaid di fim "Iya Alalake" at di 2015 Africa-Magic Viewers’ Choice Awards AMVCA.

E pasonal Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Faithia bin marri one popula Nollywood aktor wey e nem na Saheed Balogun. Di marej produs two pikin, one boi an one gel. Fathia get one boi bifor e mari Saheed Balogun bifor.

Fim wey e don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Farayola (2009)
  • Aje Meta (2008)
  • Aje Meta 2 (2008)
  • Awawu (2015)
  • Teni Teka (2015)
  • Omo Ale (2015)
  • Agbelebu Mi (2016)
  • Basira Badia (2016)
  • Adakeja (2016)
  • Eku Eda (2006)
  • MY WOMAN (2018)
  • Shola Arikusa
  • President Kuti