Burna Boy

From Wikipedia
Burna Boy
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemDamini Ebunoluwa Ogulu Chenj-am
Fest nemDamini Chenj-am
Famili nemOgulu Chenj-am
AliasBurna Boy Chenj-am
Wen dem bon am2 July 1991 Chenj-am
Ples wey dem bon amPort Harcourt Chenj-am
PapaSamuel Ogulu Chenj-am
MamaBose Ogulu Chenj-am
Broda an sista2 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, pesin wey dey rait song, musician, record producer Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Sussex, Oxford Brookes University Chenj-am
Wen e stat wok2010 Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
DiscographyBurna Boy discography Chenj-am
Notable workAfrican Giant Chenj-am
Stai of song abi fimAfrobeat, dancehall, reggae, hip hop music, rhythm and blues Chenj-am
Record labelAtlantic Records, Warner Music Group Chenj-am
Official websitehttps://www.onaspaceship.com/ Chenj-am
TribeYoruba Langwej Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Damini Ebunoluwa Ogulu MFR (dem bon am for 2 July 1991) wey pipul no wel wel as Burna boy na Naija singa, song raita an rekod produsa. Pipo sabi to no Burna Boy as e rilis di muzik "Like to Party" . Like to Party na di lid singu from e fest studio habom L.I.F.E (2013).

Burna Boy sahin with Bad Habit/Atlantic Records wey de United Stet an Warner Music Group intanashonal in 2017.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Pot Hacot wey de Riva Stet in Naija dey bon Burna boy on July 2, 1991. Burna Boy papa nem na Samuel Ogulu an e mama nem na Bose Ogulu. Burna Boy mama dey translet langwej an e papa get welda kompini. Burna boy gra-pa from e mama side na Benson Idonije wey don bi manija for Fela Kuti bifor bifor. Na Corona Sekondiri Skul wey de Agbara, Ogun Stet Burna Boy go bifor e kom travu go London go kontiniu e edukeshon. E rid midiha teknoloji an kolsho for Yunivasiti of Sussex from 2009 to 2010. Afta dat, Burna Boy kom bak to Port Harcourt an start to len more abaut midiha for Rhythm 93.7 FM. Na wen e kom bak to Legos e tek start e muzik kariha.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Burna boy gro up for souta Naija an e bigin to mek beat yuzin FL Studio.

  • 2012-2015: L.I.F.E an On a Spaceship

Dey rilis Burna Boy fest habom on 12 August 2013 ( dis one na di folo up for e sekod mixtape Burn Identity ). L.I.F.E habom sel 40,000 kopis on di fest day wey e rish maket. "Aristokrat Record" leta sel di maket right of di habom to "Uba Pacific" for #10 million. Some of di muzik wey de di habom na Tonight, Always love You, Run my Race, an Yawa Dey. Na Leriq produs L.I.F.E an somw of di muzikshan wey folo sing for di habom na: 2face Idibia, M.I Abaga, Timaya, Olamide, Reminisce, an Wizkid an meni odas.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]