Timaya

From Wikipedia

Inetimi Timaya Odon(bon 15 August 1980), wey pipul sabi wel as Timaya. Na Naijà singa an songwrita. E kom fom Odi,Bayelsa State. Na im get DM rekods Limited. E stat im song karier stat for 2005 wen e rilisi Dem Mama, wey dey for im first album, True Story wey im rilis for 2006. E rilis im sekond album Gift an Grace inside 2008. Pipul sabi am wel for di wod wen e du di third album wey bi De Rebirth- wey e du wit Black Music Group Entertainment- na inside d album plantain Boy song dey. Di two album wey im du sel wel wel. Wen e kon get moni for d album wey e du, e kon du LLNP album wit Dem Mama Soldiers. Na 2002 e rilis Upgrade, wey get popula song lik Bumbum, Sexy Ladies, an Manogede inside. Timaya don get plenti awod for im wok som of dem na four Headies Awods,2 Afrima Awods, one Nigeria Music Awod an NEA awod.

How Im Tak Stat im Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Initimi Timaya Odon for 15 August, 1980 for Port Harcourt, Rivers State. No im bi di fifteen pikin for Agip Estate, Port Harcourt. im papa dey wok for bank an im Mama dey seltins. Odon go Assemblies of God Nursery and Primary Skul. E kon leta go Nkpolu Oroworukwo for Port Harcourt. E dey komot fo haus for nait to go music sho. Timaya mama kon kari am komot fo Portharcourt, mek e folo im broda, mek e fo finish skul. Na fo Legos e kon tek finish sekondary skul, Ikeja Grammar School fo Legos na im bi di skul.

Timaya kon leta go bak to Port Harcourt fo stodi Banking an Finance, im no du wel fo d skul, e kon komot fo di first year. E kon go Legos bak go join Eedris Abdulkareem's hiphop grup. Wen e don dey wit di grup fo three years e kon komot, go dey on im own. E kon dey du music wit smol Artist. Timaya du vidio wit UDX, Legos rap grup. Na im first produsa bi Obaksolo fo Mafoluku Legos. Na Obaksolo hep am du Dem Mama rekod wey bi im first rekod. Timaya tok say Dem mama rekod na stori wey hapun fo 1999 inside Odi, fo Niger State. E tok say pipul die an dem burn pipul hous.

Im Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Timaya Dem mama Album sel wel, E kon lik to dey wit Ksolo wey b produsa. Timaya du seven song fo im first album True Story, wey e rilis fo 2007. Im kon leta stat wok on im second album fo 2007. Afta dat one Timaya kon du im second album wey im get meni produsa lik Phyno, Jeggs, Spankie, Akeem D Beat, Obaksolo an Terry G. Na 2008 im kon rilis im album wey bi Gift and Grace. Timaya kolet two awods fo 2008 wey bi Album of the year fo Naija Music Awod an Naija bes Reggae album fo di Headies.