Fela Kuti

From Wikipedia
Fela Kuti
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemFela Anikulapo Kuti, Olufela Olusegun Oludotun Ransome-Kuti Chenj-am
AliasAbami Eda, Fela Aníkúlápó Kuti Chenj-am
Wen dem bon am15 October 1938 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbeokuta Chenj-am
Wen e kpai2 August 1997 Chenj-am
Place of deathLagos Chenj-am
Manner of deathnatural causes Chenj-am
Cause of deathdeath from AIDS-related complications Chenj-am
PapaIsrael Olutodun Ransome-Kuti Chenj-am
MamaFunmilayo Ransome-Kuti Chenj-am
Broda an sistaOlikoye Ransome-Kuti, Beko Ransome-Kuti Chenj-am
Pesin wey e mariunknown value, Remilekun Kuti Chenj-am
PikinFemi Kuti, Seun Kuti Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wie e go skulTrinity Laban Conservatoire of Music and Dance, Abeokuta Grammar School Chenj-am
Wen e stat wok1958 Chenj-am
Work period (end)1997 Chenj-am
Party wey e dey for politisMovement of the People Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
DiscographyFela Kuti discography Chenj-am
Stai of song abi fimjazz, highlife, Afrobeat Chenj-am
Record labelWrasse Records, Barclay, JVC, EMI Chenj-am
Influenced byOrlando Julius Chenj-am
Significant eventprisoner of conscience Chenj-am
Awod wey e koletAll African Music Legend Award Chenj-am
Official websitehttp://www.felaproject.net Chenj-am
Depicted byMy Friend Fela Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Fela Aníkúlápó Kuti (dem bon am for Octorber 15, 1938 an e kpai for August 2, 1997) na Naija muzishian, komposa and aktivist. Fela ril nem na Olufela Olusegun Oludotun Ramsome-Kuti an pipul no am wel wel as Abami Eda.Fela dey amog di fest muzishian wey stat Afrobeat. Afrobeat na one mettod of Muzik wey join Afrika muzik an Amerika funk an jazz.Pipul sabi Fela as muzishian wey dey yuz tins wey dey happun for politiks sing for e muzik. Fela na son to one Naija wuman wey dey fight for human right wey e nem na Funmilayo Ransome-Kuti. Afta e eli espiriens for obodo Oyinbo, Fela an e band Africa 70 kolabo wit drum pesin and muzikal dareto Tony Allen, dey kom popula wel wel for Naija for 1970s, na dat time Naija sojas sey im bi dey against dem and e kom bi target for dia mitin. For 1970, E fom di Kalakuta Republic Commune, to sho sey e no dey onda di militri rul. Dem skata di Commune for di raid wey dem du for 1978. Dey put Fela for prisin onda di Govament of Muhammadu Bihari for 1984, bot dem free am afta e yuz 20 month for prisin. E Kontiniu to rekod an dey pafom for difren time for 1980s an 1990s. Sins wen e don dai for 1997, E pikin wey bi Femi Kuti don dey yuz im muzik style.

How im tek stat life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Famili_Ransome_Kuti_c1940

Na for October 15, 1938 dem bon Olufela Olusegun Oladotun Ramsome-Kuti to di Ransome-Kuti famili.Ransome Kuti famili get moni an na Abeokuta for Ogun Stet in Naija dey dey stey.Fela mama na Funmilayo Ransome-Kuti an Fela mama no sopot di Oyinbo rul ova Naija dat time.Fela papa na Reverend Israel Oladotun Ransom-Kuti wey bi prinsipa for Anglican minister skul an na di fest presido for Naija Union of Tishas. E brodas dem na medikal doktor an dia nem na Beko Ransome-Kuti an Olikoye Ransome-Kuti. Kuti na kozin to Wole Soyinka wey bi Noble laureate an na Wole Soyinka bi di fest blak raita to kolet Nobel Prize for Literature awod. Fela go Abeokuta Grammar School. For 1958, dem send am go London mek e go rid medisine bot na Muzik e chuz to rid for Trinity College of Music . Fela like to yuz trumpet pass eni oda instrument. Wen e neva dai, Fela fom di band koola Lobitos an e dey play jazz and highlife togeda. For 1960, Kuti mari e fest wife, Remilekun (Remi) Taylor wey bon three pikin for am ( Femi, Yeni and Sola). For 1963, Fela kom bak to di "newly independent Federation of Nigeria" an e kom fom di koola Lobitos again, and risiv trenin to bi Radio Produsa for "Nigerian Broadcasting Corporation". E folo Victor Olaiya pafom for som time wit all e stars. For 1967, Fela trafu go Ghana to luk for a niu muzik dareto, Even kom kol im musik style Afrobeat wey bi di combinashon of highlife, funk, jazz, salsa, calypso, an tradishonal Yoruba muzik. For 1969, Fela kari di band enta United States an e dey for Los Angeles for ten month. Na dia e tek see di Black Power movement by Sandra Smith now dem sabi Sandra Smith as (Sandra 'Izsadore abi Sandra Akanke Isidore), na strong soporta for di Black Panther Party. Dis espiriens kom afekt how e tek see muzik and politiks. Fela leta nem e band Nigeria 70. E no kom tey wey one promota giv di Immigration and Naturalization Service informashon say Fela an e band dem dey for US and dem no get wok pamits. Di band kom du one kwik rekod seshon for Los Angeles wey dem go leta rilis wit di nem The 69 Los Angeles Sessions.

For 1970s[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Fela an e band kom reton to Naijá, dey nem di grup The Africa 70 an na dat taim di muzik style chenj fom love to wetin dey happun for Naijá. E fom di Kalakuta Republic wey bi grup of pipul wey de share di sem bilif and di sem responsibilitis, rekoding studio, an home for meni pipul wey get koneshon to di band. Fela tok sey Kalakuta Replublic no dey pat of Naijá Govament. Fela dey pafom for e own Nightklub wey e leta nem Africa Shrine. Fela dey giv praise to e Gran papa papa dem wey don dai. E leta chenj e nem to Anikulapo wey di minin na (pesin we death dey im poket), wey di intapritashon na (Na me go chuz wen I go dai). Fela refuse to yuz e papa nem Ramsom bikos e tok sey di nem na slave nem. Pipul no Fela muzik for Naijá an Afrika wel Fela chuz to dey sing for pidgin bikos e wan mek pipul wey no go skul wel wel fit onda standn e muzik tu. Bikos Fela laik to dey tok to Govament enihow, Govament pipul no laik e muzik at all an dem dey kol arrest am for e Kalakute Republic. For 1972, Fela an e band mek one rekod wit Ginger Baker Bobby Tench. Na for dat taim, Fela wit e band Africa 70 kom mek di rekod albom Zombie wey tok enihow to Naijá sojas an di way dem dey du. Di albom mek Govament vex so tey dey kom wit 1,000 sojas kom beat Fela no bi smol an dey kari Fela mama troway fom upstair window an e mama wey don old rili injor.Di sojas put faya for di ples inkludin di studio, muzik instrument an masta tape. Fela tok sey na dat day e for dai if no bi one ofisa wey tok sey mek dey jost beat am and liv am.Fela no du enitin dan to kari e mama kofin go Dondan Barracks for Legos, an na dia General Olusegun Obasanjo dey stay dat time.Fela dat taim rait songs wey bi Coffin for Head of State an Unknown Soildier. Di taitu of Unknown Soldier dey refar to di unknown sojas wey kom skata di commune. Fela and e band kom go dey stay for Crossroads Hotel afta dem skata di shrine wit di Commune. For 1978, e marri 27 wumen:

  1. Kikelomo Oseni
  2. Folake Oladejo
  3. Tejumade Adebiyi
  4. Naa Lamiley
  5. Sewaa Kuti
  6. Omotola Osaeti
  7. Omowunmi Oyedele
  8. Alake Anikulapo Kuti
  9. Shade Shodeinde
  10. Adeola Williams
  11. Najite Kuti
  12. Emaruagheru Osawe
  13. Kevwe Oghomienor
  14. Ihase Anikulapo
  15. Adejonwo Iyabode Ogunitro
  16. Bose Anikulapo Kuti
  17. Lara Anikulapo Kuti
  18. Suru Eriomola
  19. Tokunbo Akran
  20. Funmi Kuti
  21. Omowunmi Afesumo
  22. Laide Anikulapo Kuti
  23. Ronke Edason
  24. Damiregba Anikulapo Kuti
  25. Aduni Idowu
  26. Omolara Shosanya and
  27. Remilekun Taylor.

Meni of dem na dansa, komposa and singa wey e dey wok wit. Di marej no onli mark di anivasri for di attack for di Kalakuta Republic but na to protet Kuti an e waif dem fom di lie lie wey di otoriti dey klem sey Fela dey kidnap wumen. Leta, e adopt one roteshona sistem for mentenin 12 wife for di sem taim. Fela du one sho for Akra an wahala happun for di sho wen Fela stat to sing di Zombie. Na di risin dey no gre mek to kom dey du sho for Ghana again bi dat.Di sekond sho na afta di Berlin Jazz Festival wen most musishians wey dey wok wit Fela lif am bikos pipul dey tok lie sey Fela wan yuz all e moni tey du kampay to bi di Presido for Naijá. For 1979, Fela fom im politikal parti, wey e kol am Movement of the People (MOP), to klin up di sosaeti laik di mop. Bot govment for dat taim konfront am kwik kwik an mek di parti no dey aktiv again. Na Nkrumahism and Africanism MOP dey prish dat taim.

Fom 1980 kom down[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1983, Fela wan kari elekshion to bi di presido of Naijá bot di Govament no gre mek e bi kandidet.For dis time, Fela kom fom one band wey get Di nem Egypt 80 an e plan na to sho afrika how di Egypt pipul tey get sivilaizashon, nolej, filosofi, matimatis and dia rilijion sistem na Afrikans and dey most klem am like dat. For one intaviu, Kuti tok sey Im dey stress di point sey im hav to mek di Afrika pipul dey awie sey na dem get how di Egypt pipu tek sivilais. E kom tok sey na di resin why e chenj di band nem to Egypt 80 bi dat.Fela Kontiniu to rekod meni albom an dey waka rand di kontri. E kom mek di politikal establishment vex wen e impliket di ITT Corporation's vice-president, Moshood Abiola and Obasanjo for di popula 25-menit politikal sikret wey e kol I.T.T (International Thief-Thief). For 1984, Fela muzik dey tok enihow to Muhammadu Buhari govment. Di govment kom jail am sey dem charge am for money smuggling. One join bodi wey be Amnesty International an oda join bodi dem kom tok sey wetin govment charge am for na politikal motivashon. Amnesty kom chuz am as pesin wey dey for prisin bikos of konshens, and oda human right join bodi kom sopot an tek im kes up. Afta 20 monts, General Ibrahim Babangida kom relis am fom prisin. Fela kom divos Im remenin 12 waif afta dey rilis am, e tok sey e marej na e bring jelosi and sefishnes. Fela Kontiniu to relis alboms wit Egypt 80 and dey waka arand di United States an Europe and e Kontiniu to dey aktiv for politiks. For 1986, e dey for pipul wey pafom for Giants Stadium in New Jersey as pat of di Amnesty International's A Conspiracy of Hope concert wit Bono, Carlos Santana an di Neville Brothers. For 1989, Kuti an Egypt 80 rilis di anti-apartheid album wey bi Beast of No Nation dat sho di U.S. President Ronald Reagan, UK Prime Minister Margaret Thatcher, an di South African President Pieter Willem Botha for di kova. Di nem wey e giv di song na from wetin Botha tok sey: This uprising [against the apartheid system] will bring out the beast in us. Fela albom kom dey slow for di taim of 1990, and e stop to dey rilis albom togeda. Wen e rich January 1993, dey arrest im wit four of e membas for Africa 70 and dey chaj dem for 25 January sey dem kill one elektrishian. Pipu com stat to kari rumo sey im get one siknes wey e dey tek tritment.No bodi don konfam am wetin pipul dey tok.

How e tek dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 3 August 1996, Fela broda wey e nem na Olikoye Ransome-Kuti na prominent AIDS activist an na foma minista for health, tok sey na AIDS kill Fela bot Fela an e waif dem no gree sey e get AIDS wen Fela dey alive. Im yonges pikin wey bi Seun e kom tek ova di rol to dey lid Fela foma band wey bi Egypt 80. For 2020, di band still dey aktiv, wey e dey rilis muzik onda di Moniker Seun Kuti & Egypt 80.

Im Musik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fela muzik style na Afrobeat. Afrobeat get jazz, funk, highlife, tradishonal Naijá, Afrika chant an rhymes. Na muzik wey konten elements of psychedelic soul an wan resembu how James Brown dey kompos e song. Afrobeat borrow fom di natif wey bj tinker pan. Tony Allen wey bi druma for twenty years.Fela don tok am for one taim sey if no bi Tony Allen, Afrobeat for no dey. Fela band dey popular bikos e bi dey yuz two baritone saxophones wen meni oda group dem be dey yuz one. Dis na komon teknik for Afrika-influenced musical styles wey you fit see for funk and hip hop.Somtaims for e band, e dey yuz two pesin wey sabi play drum wey bi base for di sem taim an two of dem dey play interlocking melodies and rhythms. E dey always yuz two or more pipul wey dey play gitar. The electric West African style gita for Afrobeat band na paramont bot e bi dey yuz to gif basik strukture, and to dey repit chordal/melodic stetment, riff, or groove. Som element wey dey for Kuti musik na di call-and-response inside di korus and figurative bot di liriks dem na simpu liriks. Im song dey long for like 10 to 15 minits, and meni of e song long rech 20 to 30 minits, and som of e trak wey e no rilis dem dey last rech like 45 minits wen Im dey pafom for live stej. How im musik be dey long na e be one rizin wey make e musik no reach di digri of popularity for outside Afrika. Im LP rekod be dey get one 30 minits trak. E get som of e musik introdokshon part wey long reach like 10-15 minits befor e go com start to sing di song wit Im liriks dem, for anoda 10-15 minits. For som of e rekods dem, e devaid Im song to two pats: pat 1 na di instrument pat, and di pat 2 na di vokal pat wey e go add to di instrument pat. Kuti sing meni of e song for Naija pidgin English, and e also pafom small of Im song wit trumpet, electric guita, and di occasional drumsolo. Kuti no gri sing song agen afta e com sabi Yoruba languaj. Im mein instrument dat time na di saxophone and di key board, but e de also play di one wey e don alredy rekod dem, na e make Im song no too dey popular for outside Afrika. Dem sabi Kuti for im show dem, and im konsat dem wild show e dey be. E call Im akt wey e do for stej di Underground Spiritual Game. Meni pipu espet am to pafom for di western part, but for di time of 1980, e no com get interest for eni show. E pafomans for Europe dey represent wetin dey hapun for im time an im oda inspiration dem. E tink of di art sey e musik go get minin for politiks. Kuti na part of di Afro-Centric consciousness movement wey start date time and diliva from e musik wey sopos get effect. Wetin Afrika musik dey about be say, wen you dey play musik and pipu no dey feel enitin, e show say you no sabi be dat. For one intaviu wey e do wit Hank Bordowitz Noise of the World, Kuti tok say: Muv! I wan muv pipu to dance, but mek we tink of am. Musik nid to show a beta laif agenst a bad laif. Wen you dey listen to somtin wey dey tok about beta laif and you no get beta di laif, e sopos show for di kind pesin wey you be. Kuti musik, an im e no go gri behevio na becos of wetin dey hapun for e area. For one intaviu rekod wey show for di Faces of Africa for CGTN Afrika, e kompie bitwin di Oyinbo languaj love musik and e own musik say: Yes, wen you dey for England, di musik fit be di tin of enjoiment. You fit sing about love, you fit sing about wu you wan folo sleep nest. But for awa own envairoment hia, my sosaeti never develop becos of di strenj sistem wey dey wit awa pipu. Notin wey be like love. Na wetin dey hia, na how pipu be dey try struggle for dia laif for dem to fit live.

E politika viu and e invovment[chenj-am | chenj-am for orijin]

E politika invovment: Kuti invov e sef for politiks in Afrika from 1970 till di time wey e dai. E kritisais di koropshon fo Naija govment woka an au dem tek dey trit sitizin fo bad way. E tok about how strenja tek bi di rut for di ekonomi Kraisis for Naija, an aw dem tek be di yawa fo politiks wey di pipu fo Afrika dey fes. Koropshon na won wos problem fo politik wey Afrika dey fes fo 1970s an Naija dey for di kontri wey koropshon sidon. Govment dey dabaru eleshon an dey pafom kup wey kom wos povati mata, e kom mek ekonomi mata sef drop, emploiment no dey, an di mata fo politiks no dey stebu, koropshon wit kraim kom plenti well well. Kuti protes musik taitu, na di rialiti fo wetin dey hapun to Afrika ekonomi an koropshon mata. Na all Afrika kontri go don hie about Kuti stetment fo politiks. Kuti song dey tok about di bad tins an di kain way wey shitin de fo how dem dey kontro Naija an e no dey kom witaut konsikwens. E pass 200 diferens time wey dem arest Kuti and e spend time fo jail, wit e 20 mont for jail afta dem arest am for 1984. For dat time, di koropt govment send sojas to bit Kuti, e family an frends, an distroi wie e dey stay wit e instrument dem an e rekods dem. For di time of 1970, e bigin tok for politiks for deli an wikli nius pepa advat like The Daily Times and The Punch, livin di editorial censorship in Nigeria's predominantly state-controlled media. Dem poblish am for di time of 1970 and for eli 1980 onda di taitu Chief Priest Say, dis kolums na Kuti estenshon for im femos Yabi Sessions-consciousness-raising word-sound rituals wit e sef as chief priest for e nite klob for Lagos wey de oganise for militantly Afrocentric for e histri and di esens for black beauty, Chief Priest tok say focused on the role of cultural hegemony in the continuing subjugation of Africans. Kuti tell plenti topiks on kondemin di Naija govment krimina behavio,how Islamik and Kristen don koropt reach, and bad bad plenti koporeshon dem; E tok abaut di brek down of Western medicine, Black Muslims, Sex, Pollution, and Poreverty. Chief Priest tok sey The Daily Times and The Punch Kansu all e ripot dem. Plenti oda pipu sef tok sey dem preshor di pepa editors dem to stop to dey rait dis tins inside pepa wit di e trets of vawulens dem.

E viu for Politiks[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kuti musik dey tok abut wetin e be get for mind. How e tek popula for 1970s show di shenj wey dey for Naija musik art and for di tok tok wey dey for Naija politiks dat time. For 1984, e tok and yab di Naija presido wey dey for pawa dat time wey bi President Muhammadu Buhari. Beast of No Nation, na one of di most popula song wey e refar to Buhari sey e bi anima wey dey for mad man bodi. E tok am for Naija pijin sey: No bi outside Buhari dey ee, na craze man, na craze man bi dat, animal in craze man skini. Kuti get strong belief for Afrika and e dey alwes preash pis among e pipu. E tink sey to fight agenst Europe pipu korshor and to sopot tradishona riligion dem and e lifestyle for dia kontinent. Di American Black Power movment also show how Kuti tek viu politiks, how e tek sopot di Pan - Africanism and Socialism wey e call for how dem go dey as one wey bi di Democratic African Republic. Kwame Nkrumah and Thomas Sankara dey among di leeda for Afrika wey Kuti be dey sopot wen e still dey alaif. Kuti na pesin wey strong for human rite mata, and meni of e musik na direkt atak agenstdi diktetors for politiks mata, espeshiali di militiri govment wey dey rule Naija for 1970s and 1980s. E also yab im felo Afrika pipu espeshiali di upper klas pipu for di wey dem tek dey bitre di Afrika tradishon and korshor. For 1978 Kuti bekom man wit meni wife, wey e mari to 27 wumen one afta di oda.Na di popula wedin dat time wey serv meni porpos: e mark di one year anivasri for how Kuti and e wife tek sovaiv di atak wey hapun for Kalakuta Republic by di militri govment for 1977, naso e fomalise di rileshon wey de betwin di wumen wey e dey liv wit dis lega status privent di Naija govment wey dem no fit kom e kompand, on to sey im kidnap di wimen dem. Kuti also tok about meni wife as wetin bi sens and dey norma. Man dey go for wumen for di fest ples. laik for Europe, wen a man don mari, wen di wife dey sleep, e go dey go out go dey slip around. E go kari di wuman kom haus, and di man go dey kom dey liv wit am and e go stop to dey run around di strit. Som pipu tok sey im viu for wuman mata na di kain filin wey mek e sing song like Mattress for foda pruf for mor esampu, e mok di African women's aspiration to European standards of ladyhood wai e prais di valu of di market wumen for e song wey bi Lady. Kuti also tok agenst wetin e konsida say e bi strong displa for Afrika karakta for men. For e song wey bi J.J.D.(Johnny Just Drop) and Gentleman, Kuti mok di men for how dem tek dey do dia kulshor and politiks wey Erop pipu kari enta Afrika and e kom deklie e sef say im bi African man: Original, Kuti na pesin wey dey tok well well agenst di United States. For one mitin wey e go wen e waka for Amsterdam, e komplen abaut di kind mind for war wey Amerika join bodi like ITT and di CIA tek agenst di nashons dem wey de divelop for languaj. Bekos word wey be like Third World, undeveloped, or di wons wey even wos kontris dem wey no gri wit wetin e tok na fek e bi. Kuti fill say mek dem stop to dey yus dem.

Wetin dem tek de rimemba am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Den dey rimemba Kuti for how e tek bi important pesin wey dey tok e aidia for mata wey de afekt di nashon wit e musik. Na from 1998, na im di Felabration festival wey bi one aidia wey im dohta wey bi Yeni Kuti start, dem de do am evri year for di New Afrika Shrine to selibret di laif of dis musik ogbonge pesin and e betday. Sins di taim wey e dai for 1997, na im dem don de do e revaiva for how e musik tek dey impotant and e tok abaut awa popula kolshor, dey kom rilis plenti of e musik from e list wey UMG dey kontro, for big ples and ples wey no bi opun ples, dem pafom e shos dem and niu band dem laik Antibalas, wey kari di Afrobit bana for di niw genereshon to di pipu wey de hie di musik. For 1999, Universal Music France, wey dey onda Francis Kertekian, wey mek a niu 45 albom saund rekod wey dem rilis am for 26 kompat disk. Dem kom giv laisens for di song taitu for di world, esept for naija and Japan, wie oda kompani get kuti musik. For 2005, di UMG opereshon for Amerika giv laisens to all e world musik taitu to di UK-Based label wey bi Wrasse Records, wey ripakej di sem 26 disk wey dem go distribut for di United States (Na die dem riples di taitu wey MCA giv) and di one wey UK giv. For 2009, Universal kom kriet one niu deal for US and Europe, wit Knitting Factory Records and. . PIAS, wey get di Broadway cast record rilis for di Fela musik. For 2013, FKO Ltd, na di join bodi wey get di rite to all song wey Kuti rait, and na BMG Rights Management na dem get am. For 2003, dem displey di Black President as di fest tin for di niu Musiom for Contemporary Art for New York and mek atrakshon konsat dem, different parti dem, fim dem, and intanashona art wok wey rish 39. Bilal wey bi Amerika singa rekod and do som song wey Kuti sing for 1997 wey bi Sorrow Tears and Blood and for e sekond albom, Love for Sale e fishor one rappa wey jus kom. Bilal see Kuti song kombinashon wey be jazz and folk sey na e efekt e musik. One fim wey dem do for 2007, wey e nem na The Visitor wey bi sey na Thomas McCarthy dairet am, reprisent won diskonekted profesor wey bi (Richard Jenkins) na e bi wan pley di djembe; e len am from won yong pesin wey kom from Syria wey e nem na (Haaz Sleiman) na e tell di profesor sey e no go fit ondastand Afrika musik if e no gri hie Kuti musik dem. For di fim, dem yus Kuti song wey bi Open and Close and Je'nwi Temi (Don't Gag Me). For 2008, small small ples dem, dem do prodokshon abaot laif wey Kuti liv wey dem koll Fela! and na e mek di Fela laif tori wey dem do for 1982, wey bi Fela! This Bitch of a Life from Carlos Moore, e stat to join bodi togeda to do wok bitwin di Afrobeat band Antibalas and di Tony awod winna wey e nem bi Bill T. Jones. Di prodokshon na big sosess and e sell well for di time, pipu wey dey tok agenst am dem even stat to de preis and tok beta tins abaut di sosess. For November 22, 2009. Fela! kom be wetin dey for big opun ples for di Eugene O'Neill Theatre. Jim Lewis hep wrait di skript wit Jones among oda pipu, pipu laik Jay-Z and Will Smith, giv am produsa backup. Wen e rish May 4, 2010. dey kom nominet Fela for 11 Tony Awards, wit di Best Music, Best Book of a musical, Best Direction of a Musical for Bill T. Jones, Best Leading Actor in a Musical for Sahr Ngaujah, and Best Featured Actress in a Musical for Lillias White. For 2011, dem do one fim for di London Prodokshon for Fela! Wey dem koll ( stage at the Royal National Theatre). For 11, June 2012, dem anaons am sey dem go reton Fela! bak to 32 opun ples pafomans. For 2009, DJ J.Period rilis wan fri mixtep for di jenera poblik wey e nem di tep The Messengers. And na kolabo wit wan hip-hop musishian wey dem bon for Somalia wey e nem na K'naan dem do am togeda to prais Kuti, Bob Marley, wit Bob Dylan. Afta two mont, Knitting Factory stat tu rekod and stat tu rilis di 45 taitu kontro by di UMG again, E stat wit Fela Kuti statue for Ikeja, Lagos wit anoda rilis for US for di konpilashon wey bi The Best of the Black President wey dem komplit and rilis am for 2013. Fela Son of Kuti: The Fall of Kalakuta na stej play wey bi sey na Onyekaba Cornel Bestin for 2010. E don klem to win am as pat of di year Felabreshon and reton for 2014 for di National Theatre and for Freedom Park for Lagos. Di pley dil wit event for a haid ples, a day afta Kalakuta fall. Di full lent dokumentri fim Finding Fela, wey bi sey na Alex Gibney dairekt am, na e bi nomba one for di 2014 Sundance Film Festival. A biographical film by Focus Features wey bi sey na Steve McQueen dairet am, and na Biyi Bandele raite am, for 2010, one stori kom dey dat time dey for prodokshon, wit Chiwete Ejiofor for di lead role. So, for 2014, di proposa no longa dey prodius onda di Focus Feature, and e menten e role as di main pesin wey raite am, dey Kom riples McQueen kom put Andrew Dosunmu as di darekto. McQueen kom tell di pesin wey dey ripot for Hollywood sey di fim don die. Di 2019 dokumentri fim wey bi My Friend Fela (Meu amigo Fela) wey bi sey na Joel Zito Araújo do am, wey bring about Kuti laif tru di eyes and di Konvashon of e baografa wey bi Carlos Moore. Di kolaboretiv jazz/afrobeat album wey bi Rejoice by Tony Allen and Hugh Masekela, wey dey rilis for 2020, wey include di track Never (Lagos Never Gonna Be the Same), wey bi atribute to Kuti, for wen Allen and Masekela fes mit for di 1970s. Kuti song wey bi Zombie don apie for di vidio game wey bi Grand Theft Auto IV, and afta e death dey kom giv am awod wey bi di Rock & Roll Hall of Fame for 2021. For 2021, Hulu rilis won six episod dokumentri wey e taitu na McCartney 3, 2, 1, wey bi sey dem quote Paul McCartney sey e visit tu see Fela Kuti for di African Shrine, wey bi Kuti klob for outsaid Lagos,for ehli 1970, e tok sey; Di musik surprise am wey mek e krai. Sey; hearing di musik na won of di gretes musik moment for e laif. For 1 November 2021, e get won blu plaque wey Nubian Jak Community Trust opun for 12 Stan lake Road, Shepherd's Bush, na der Kuti fes stey for di taim wey im dey go Trinity College. Wetin dey do for di event konten tribiut wey Kuti dohta wey bi Shalewa Ransome- Kuti, Debbie Golt wey bi Resonance FM broadcaster, Kuti bifor bifor maneja Rikki Stein, kova atist wey bi Lemi Ghariokwu, wit di odas. For 2022, dey kom put Kuti for di Black Music & Entertainment Walk of Fame.

Som of E Musik Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Fela Fela Fela (1969)
  • Fela's London Scene (1971)
  • Why Black Man Dey Suffer (1971)
  • Live! (1971)
  • Open & Close (1971)
  • Shakara (1972)
  • Roforofo Fight (1972)
  • Afrodisiac (1973)
  • Gentleman (1973)
  • Confusion (1975)
  • Expensive Shit (1975)
  • He Miss Road (1975)
  • Water No Get Enemy (1975)
  • J.J.D. (Johnny Just Drop!!) (1977)
  • Fela Kuti Zombie (1977)
  • Stalemate (1977)
  • No Agreement (1977)
  • Sorrow Tears and Blood (1977)
  • Shuffering and Shmiling (1978)
  • Black President (1981)
  • Original Sufferhead (1981)
  • Unknown Soldier (1981)
  • Army Arrangement (1985)
  • Beasts of No Nation (1989)
  • Confusion Break Bones (1990)
  • The Best Best of Fela Kuti (1999)
  • The '69 Los Angeles Sessions (1969/2010).

Som of E Fim Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • My Friend Fela, 2019, Joel Zito Araújo (Casa de Criação Cinema)
  • Finding Fela, 2014, Alex Gibney and Jack Gulick (Jigsaw Productions)
  • Femi Kuti — Live at the Shrine, 2005, recorded live in Lagos, Nigeria (Palm Pictures)
  • Fela Live! Fela Anikulapo-Kuti and the Egypt '80 Band (https://www.bbc.co.uk/iplayer/episod e/m000xh3n/glastonbury-fela-kuti-at-glastonbury-1984), 1984, recorded live at Glastonbury,England (Yazoo)
  • Fela Kuti: Teacher Don't Teach Me Nonsense & Berliner Jazztage '78 (Double Feature), 1984 (Lorber Films)
  • Fela in Concert, 1981 (VIEW)
  • Music Is the Weapon, 1982, Stéphane Tchalgadjieff and Jean-Jacques Flori (Universal Music)

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]