Jump to content

Ogbonnaya Onu

From Wikipedia
Ogbonnaya Onu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejOgbonnaya Onu Chenj-am
Orijina nemOgbonnaya Onu Chenj-am
Wen dem bon am1 December 1951 Chenj-am
Ples wey dem bon amOhaozara Chenj-am
Wen e kpai11 April 2024 Chenj-am
Place of deathAbuja Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, chemical engineer Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Abia State, Secretary to the Government of the Federation, Minister of Science and Technology, Minister of Science and Technology Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, University of California, Berkeley Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
E pipulIgbo pipul Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Memba ofNigerian Academy of Science Chenj-am
Bifor amFrank Ajobena Chenj-am
Replaced byChinyere Ike Nwosu Chenj-am
Awod wey e koletFellow of the Nigerian Academy of Science Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Ogbonnaya Onu CON (dem bon am on 1 December 1951 - e kpai on 11 April 2024) na Naija politishan, buk raita an engineer bifor e kpai on 11 April 2024. Na im bi di fest govnor wey dem vote for in Abia State an na im bi di bifor bifor Naija minista of science, technology an innovation fom November 2015 rish wen e sey e no dey du in 2022. Na im bi di minista wey don sarf pas for di ministry.

Im life tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ogbonnaya Onu on 1 December 1951, insaid di famili of Eze David Aba Onu wey dey Amata, Uburu, Ohaozara Lokal Govmet Aria of bifor bifor Eastern region, wey kon chenj to Imo Stet, stil chenj to Abia State an nau Ebonyi State Nigeria. E stat im edukashon for Izzi High School wey dey Abakaliki, wey bi Ebonyi State Kapita nau. Na fom dia e get im West Afrika Certifikate Examination. E rait im High School Examination for College of Immaculate Conception (C.I.C) Enugu, wia e finish as best student. E kon go University of Lagos an finish wit first klas digre insaid Chemical engineering in 1976. E kon go University of California, Berkeley, an e get Doktor of Philosophy digre in chemical engineering in 1980. Onu kpai on 11 April 2024, Wen e dey 72 years old.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tichin wok Afta e finish fom di Universiti of Lagos, Ogbonnaya Onu du tichin wok for Augustine's Seminary, Ezzamgbo, Ebonyi State. Afta e finish im doctoral stodi at di Universiti of California, Berkeley, Onu kon bi lecturer insaid di department of Chemical Engineering of Universiti of Port Harcourt, an leta bi di oga kpatakpata of di department. E sarf as aktin Deen of di faculty of Engineering an dey vote am as memba of di Governing Council of di Universiti.

Hau e tek du politis wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogbonnaya stat I'm politis wok wen e trai toenta as senato for old Imo Stet onda National Party of Nigeria (NPN). E go for govnor of Abia State in 1991 onda Nashonal Repoblikan Convention an e win. Dem swear am in as fest exekutiv govnor of Abia State in January 1992. Na im bi di fest chairman, Conference of Nigeria govnors. In 1999, na im kom out as president for All People's Party but leta giv am to Olu Falae afta im parti an Alliance for Democracy join togeda who leta luz to Olusegun Obasanjo of di PDP. Na im bi Nashonal parti chairman of di All Nigerian People's Party in 2010. In 2013, im parti (ANPP), Action Congress of Nigeria (ACN), Congress for Progressive Change (CPC), Democratic People's Party (DPP) an som membas of di All Progressives Grand Alliance (APGA) kom togeda to fom All Progressives Congress (APC). In November 2015, dem put am as Minista of Science an Teknologi by President Muhammadu Buhari. On 21 August 2019, na im stil dem put as Minista of Science an Teknologi by President Muhammadu Buhari. Nigeria (NPN). E go for govnor of Abia State in 1991 onda Nashonal Repoblikan Convention an e win. Dem swear am in as fest exekutiv govnor of Abia State in January 1992. Na im bi di fest chairman, Conference of Nigeria govnors. In 1999, na im kom out as president for All People's Party but leta giv am to Olu Falae afta im parti an Alliance for Democracy join togeda who leta luz to Olusegun Obasanjo of di PDP. Na im bi Nashonal parti chairman of di All Nigerian People's Party in 2010. In 2013, im parti (ANPP), Action Congress of Nigeria (ACN), Congress for Progressive Change (CPC), Democratic People's Party (DPP) an som membas of di All Progressives Grand Alliance (APGA) kom togeda to fom All Progressives Congress (APC). In November 2015, dem put am as Minista of Science an Teknologi by President Muhammadu Buhari. On 21 August 2019, na im stil dem put as Minista of Science an Teknologi by President Muhammadu Buhari.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Onu na certified memba of Council for di Regulation of Engineering in Nigeria. E dey insaid Nigeria Society of Chemical Engineers.

In October 2022, dem giv am Naija Nashonal Honors of Commander of di Order of Niger (CON) na President Muhammadu Buhari giv am.

Katakata wey hapun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Onu tok sey Naija go dey produs pencil by 2018 wey go mek 400,000 Naija pipu get wok. Wen 2019 rish Naija Neva stat to dey produs pencil. In 1999, e dey insaid katakata wey hapun for APP/AD afta e pick Olu Falae as pesin wey go stand for President insaid eleshon.