Igbo langwej

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Igbo langwej
language, modern language
Subclass ofIgboid, Kwa, Benue–Congo Chenj-am
Native labelAsụsụ Igbo, Igbo Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Indigenous toNaija, Igbo pipul Chenj-am
Linguistic typologyagglutinative language, subject–verb–object Chenj-am
Writing systemIgbo alphabet Chenj-am
Ethnologue language status2 Provincial Chenj-am
Related categoryCategory:Igbo pronunciation Chenj-am
Wikimedia language codeig Chenj-am

Igbo langwej na di langwej wey Igbo pipul dey spik.Igbo pipul na traib wey dey stey South-East of Naija. E get di jeneral Igbo langwej wey dey Tek dey rait an rid wey dey fom in 1972 an na Owerri (Isuama), Anambra (Akwa), Umuahia (Ohuhu) mentod of spikin Igbo dey tek fom am.Ika, Ngwa Ukwuani an Ogba langwej na stil pat of Igbo langwej.

Tori abaut di langwej[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest buk wey Igbo word dey inside na "History of the Mission of the Evangelical Brothers in the Caribbean" wey dey poblish in 1777.Wen e rish 1789, Olaudah Equiano wey bi slave bifor rait one buk wey get 79 Igbo words.Na for London inside England dey tek poblish di buk wey get di nem "The Interesting Narrative of the Life of Olaudah Equiano."Di buk tok about how Igbo life bi as Equiano tek see am wen e dey e vilej Essaka. Wen Oyinbo (White pipul) kom see how Naija Riva bi for 1854 go rish 1857, Dey kari one Yoruba pastor Ajayi Crowther kom an wit di hep of one young Igbo pesin Simon Jonas wey dey intaprit for dem, dey stat to fom how to rait Igbo langwej down in 1857. Di langwej kom dey propa to rait wel wel wit di hep of di chorch "Union Ibo Bible (1913). Di Sentral Igbo wey of spikin Igbo na di one wey kom fom memba of Ezinifite grup of Igbo in Sentral Owerri Aria bitwin di towns of Owerri an Umuahia in Easta Naijá.Wen Dr. Ida.C. Ward mek di sorgeshion in 1939, na di Sentral Igbo misionari, poblisha an raita dey yuz rait. Anoda wet of spikin Igbo bi Standad Igbo wey bi Igbo wey kombine all di oda mentod of spikin Igbo langwej. Chinua Achebe no even like as pipul dey du dia best to get just one Standad way of spikin or raitin Igbo for one leshua wey e gif for katolik chorch in Owerri.

Gramma wey dey inside Igbo langwej[chenj-am | chenj-am for orijin]

Igbo langwej sef get Noun, Pronouns, Numerals, Verbs, Adjectives, conjunctions an preposition. All dis gramma na pat of spicy as Inglish pipul dey kol am. Di onli Preposition for Igbo langwej bi "na" an e min plenti an na for di wey dem yuz am go show wetin e min. See dis ezampul wey Emenanjo (2015) yuz to sho am:

(1)

O

3sg

live

n'Enugwū.

PREP-Enugwū

O bì n'Enugwū.

3sg live PREP-Enugwū

'E dey live for Enugwū.'

(2)

O

3sg

live

ebe

here

à

this

n'ogè

PREP-time

agha.

war

O bì ebe à n'ogè agha.

3sg live here this PREP-time war

'He live for dia wen di war stil dey.'

(3)

Ndị

people

Fàda

Catholic

kwènyèrè

believe

n'atọ̀

PREP-three

n'ime

PREP-inside

otù.

one

Ndị Fàda kwènyèrè n'atọ̀ n'ime otù.

people Catholic believe PREP-three PREP-inside one

'Katolik pipul biliv sey Trinity dey.

"Adjectives" wey dey Igbo langwej no plenti.Infat, Emenanjo (1978, 2015) see onli 8 adjective:

  • ukwu wey bi 'big',
  • nta wey bi 'smol';
  • oji wey bi 'dak',
  • ọcha wey bi 'light';
  • ọhụrụ wey bi 'niu',
  • ochie wey bi 'old';
  • ọma wey bi 'gud';
  • ọjọọ wey bi 'bad'

"Verb" plenti wel wen for Igbo langwej an na verb dey tek fom meni sentens for Igbo langwej. If pesin dey spik Igbo, di sem word fit min Male, female or tins. For ezampul: '"Ọ maka" fit bi man, wuman or tin is fine.

Di Vois wey dey tek dey spik Igbo langwej[chenj-am | chenj-am for orijin]

Igbo langwej na langwej wey bi sey if you no yuz di koret way tok am, e go min diffren tin. For ezampul, 'ákwá "krai", àkwà "bed", àkwá "egg", an ákwà "klot".