Igbo pipul

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Igbo pipul na one etnik grup in Naijá. You fit find dem for Abia Stet, Anambra Stet, Ebonyi Stet, Enugu Stet an Imo Set. Plenti Igbo pipul stil dey Delta Stet an Rivers Stet. Igbo etnik grup dey Kameroon, Gabon an Equitorial Guinea an as wel aa outside Afrika. Di ril orijin of Igbo pipul no tu klair.

Igbo land get tu pat wey Niger Riva sepiret: Igbo land wet dey Easta pat (di one big pass) an di Westa pat. Di Igbo pipul bi one of di etnik grup wey plenti pass in Afrika. Di Igbo langwej na one of di Niger-Congo langwej famili.