Naira Marley

From Wikipedia
NIGIERA MARLEY
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija, UK Chenj-am
Famili nemMarley, Fashola Chenj-am
Wen dem bon am10 May 1991 Chenj-am
Ples wey dem bon amAgege Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician, rapper, singa, actor Chenj-am
Wie e go skulChrist The King Sixth Form College Chenj-am
Wen e stat wok2014 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimhip hop music Chenj-am
Record labelMarlian records Chenj-am
Official websitehttps://jenitv.com/track/ Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Azeez Adeshina Fashola (dey bon am 10 May 1991) wey pipo no wel wel as Naira Marley na Naija singa an Song raita. E get e fans base wey e tok sey e bi dia presidor an di nem of e fans base na "Marlians"

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Naira Marley bi 11 years, e go Peckham wey de South London in England. Naira Marley rid Bizness from Peckham Akademi with beta grade (distinction). E stil rid Bizness Law for "Crossway Kolej" ( di kolej nem don chenj to Christ di King Form Kolej).

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Naira Marley stil dey smol, e wan bi MC an pesin wey dey tok for bak wen muvee dey play (Voice cover). Na for 2014 e start to dey sing wen e frend-dem advais am to bikom muzishan. E rilis one song kol "Marry Juana" bifor e rilis e habom "Gotta Dance" in 2014. For December 2017, Naira Marley rilis one song wey Olamide an Lil Kesh join am sing kol "Issa Goal". "Issa Goal" song na e dey yuz for Supa Higu for di 2018 FIFA Wold Kup. On 16 June 2018, Naira Marley do di remix of di song an Olamide, Lil Kesh, Falz, Simi an Slimcase folo for di remix.

Naira Marley dey yuz English, Yoruba an Naija Pijin sing. E muzik na Afrobeats an hip-hop.

  • 2019 go rish today

Naira Marley rilis di song wey Zlatan folo join sing "Am I A Boy" for 3 May 2019 an EFCC harest am dat dem day . E rilis "Soapy" on 27 June 2019 afta dem rilis am from EFCC . On 11 January 2020, Naira Marley yuz di song "Soapy" win "Viewers' Choice" awod in 2020 Soundcity MVP Awod

How EFCC tek kach am[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 10 May 2019, EFCC kach Naira Marley an e frend Zlatan, Tiamiu Kayode, Adewunmi Adeyanju Moses, Michael "Taqueesh" Adenuga an Abubakar Musa.

Di EFCC harest hapun di folorin day wey Naira Marley do di vidio of "Am I A Yahoo Boy". Five days wey don dey harest dem, EFCC rilis Zlatan an three odas but dem no gree rilis Naira Marley bikos of wetin dey get as evidensbwey kach am. For 16 May 2019, EFCC tok sey 11 sins of wayo wayo e komit bifor Fediral Hi kot wey de Ikoyi, Legos Stet.

Zlatan rilis one song "4 Nights In Ekohtieboh" on 19 May 2019. Dat time, Naira Marley stil de inside polis sel. For di song, Zlatan tok about e frends, enemis, an pipo wey sopot am dorin di wahala wey e faze.


For May 2019, EFCC kari Naira Marley go kont an dey tok sey dey fit give am bail on 30 May 2019. Wen dat day rish, Naira Marley rilis one song kol "Why". For di song, e tek one pikshon wey polis hankuff dey e hand.

Di kot tok sey mek e pay #2,000,000 as bail on 14 June 2019. E yuz 14 days for polis sel from di day wey EFCC kach am to di day wey e get bail.

Muzik-dem wey e don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Habom[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • God's Timing's the Best (2022)

Smol smol song wey no rish habom-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Gotta Dance (2015)
  • Lord of Lamba (2019)

Singles[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Tahitu Habom Ref
2016 Kosi Werey Templet:N/A
2017 Issa Goal Templet:N/A
2018 Japa Templet:N/A
2019 Am I A Yahoo Boy Templet:N/A
2019 Opotoyi (Marlians) Templet:N/A
2019 Why Templet:N/A
2019 Soapy Templet:N/A
2019 Back2work Templet:N/A
2019 Bad influence Templet:N/A
2019 Mafo Lord of Lamba
2019 Tesumole Lord of Lamba
2019 Isheyen Lord of Lamba
2019 Yanyanyan Lord of Lamba
2020 Aye Templet:N/A
2020 Dido lobo Templet:N/A
2020 Mofoti Templet:N/A
2020 Anywhere Templet:N/A
2020 As E Dey Go Templet:N/A
2020 Idi Oremi (Opotoyi 2) Templet:N/A
2020 Chi Chi Templet:N/A
2020 Koleyewon Templet:N/A
2021 Coming featuring Busiswa) Templet:N/A
2021 Drug Test Templet:N/A
2021 First Time In America Templet:N/A

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Awod Katigori Winna Risot Ref
2020 Soundcity MVP Awards Viewers' Choice "Soapy" Won
Song of the Year Nominated
Best Pop Himself Nominated
2019 City People Music Awards Artiste of the Year (Male) Nominated
Street Song of the Year "Soapy" Nominated