Simi

From Wikipedia
Simi
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejSimisola Kosoko Chenj-am
Orijina nemSimisola Kosoko Chenj-am
Famili nemOgunleye Chenj-am
AliasSimi Chenj-am
Wen dem bon am19 April 1988 Chenj-am
Ples wey dem bon amOjuelegba Chenj-am
Pesin wey e mariAdekunle Gold Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, singer-songwriter, actor Chenj-am
Wie e go skulCovenant University Chenj-am
Wen e stat wok2006 Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Notable workDuduke Chenj-am
Stai of song abi fimrhythm and blues, African popular music, Afrobeats, soul music Chenj-am
Awod wey e koletOkayAfrica 100 Women, 2015 Nigeria Entertainment Awards, The Headies 2016, City People Entertainment Awards Chenj-am
Official websitehttp://www.iamsimi.com/ Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Simisola Bolatito Kosoko ( dey bon am 19 April 1988) wey pipo no wel wel as Simi na Naija singa, song raita, an pesin wey dey du fims. Simi start to sing as Gospel singa an na for 2008 e rilis e fest habom Ogaju. Simi bi one of di pipo wey dey joji for sisin 7 of di Nigeria Idol TV show in 2022. Simi start to dey popular afta e sing one song kol Tiff in 2014. Tiff dey for fi katigori of song wey fit kolet Best Alternate Song at The Headies 2015.

For 2014, Simi sahin one rekod kontrat with X3M Music, but e komot for di rekod kompini wey e kontrat finish in 2019. Simi rilis e sekod habom Simisola on 8 September 2017. E nomba three habom Omo Charlie Champagne, Vol. 1 kom out on 19 April 2019. Na dat date wey e rish 31 years e rilis Omo Charlie Champagne, Vol. 1. Simi in June 2019, opun e own rekod lebel kompini Brat".

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 19 April 1988 fey bon Simi in Ojuelegba, Surulere, Legos Stet. Wen Simi tell Juliet Ebirim wwy dey wok for Vanguard Niuz-pepa about e life tori, e tok sey wen e dey 9 years old, e peret marej skata. E stil tok sey wen edey smol, e dey do wetin boiz-dem dey do.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Simi go Star Intanashinol Kolej, one sekondiri skul wey de Ikorodu, Legos Stet. Simi rid Mass Komunikeshon for Kovenat Yunivasiti.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2006-2013 ( Ogaju habom)

Simi dat time fest dey sing an dans for e lokal chorch. For 2008, e rilis one habom kol Ogaju. Ogaju get some muzik inside like: "Iya Temi", an "Ara Ile". Na Samklef bi di produsa of di habom.

  • 2014-2018: (Restless, Chemistry, an Simisola).

For January 2014, Simi rilis one habom kol Restless. Di habom get five song inside. Na Restless habom mek X3M rekod lebel sahin Simi. Di habom get som song wey oda popular singa don sing. For ezampul, Rihanna song "Man down" an Adele song "Set Fire to the rain" de inside Restless habom.

For 9 January 2014, Simi rilis two singu "Tiff", an "E No Go Funny". Pipo like dis two song an meni redio an TV steshon play di song wel wel. Na Josh Clarke produs di vidio of "Tiff" an na 30 August 2015 pipo start to see di vidio.

For Headies 2015 Edition awod, "Tiff" dey for di katigori of Best Alternative Song. Simi leta win di " Most Promisin Act to Watch "'" at di 2015 Nigerian Entatemet Awod. For one intaviu wey Simi do with Lidaship niuz-pepa, Simi tok sey e don dey wok to rilis e sekod habom in 2016. Simi rilis Jamb Question an one site kol NotJustOk chuz Simi as one of di singa wey pipo go nid to lisin to in 2016. Simi do di remix of Jamb Question with Naija rappa Falz. Simi rilis Oscar Heman Ackah song "Love Don't Care". Pipo like di song. Di song tok about how Naija pipo no like to dey folo oda tribe do somtin togeda. Na Clarence Peters daret di vidio of di song. MTV Afrika Muzik Awods join Simi nem for Best Breakthrough Act Katigori in October 2016.

Muzik wey e don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

List of singu wey e don do, di year an di nem of do habom.
Taitu Year Habom
"Ara Ile" 2008 Ogaju
"Emi L'Onijo" 2012 Non-album single
"Take a Chance"
"Chocolate Brown"
"Don't Judge Me (cover)" 2013
"Bibanke (cover)"
"Marvin's Room (cover)"
"Tiff" 2014 Simisola
"E No Go Funny" Non-album single
"Jamb Question" 2015 Simisola
"Jamb Question" (Remix) (featuring Falz) Non-album single
"Open and Close"
"Love Don't Care" 2016 Simisola
"Smile for Me" 2017
"Joromi"
"I Dun Care" 2018 Omo Charlie Champagne, Vol. 1
"Lovin"
"Ayo" 2019
"Duduke" 2020 Non-album single
"There for You"