Agege

From Wikipedia
Agege
local government area of Nigeria
Part ofSouthwest Nigeria Chenj-am
Official nameAgege Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityLagos State Chenj-am
Located in time zoneUTC+01:00 Chenj-am
Coordinate location6°37′19″N 3°19′33″E Chenj-am
Office held by head of governmentChairman of Agege local government Chenj-am
Executive bodysupervisory councillors of Agege local government Chenj-am
Legislative bodyAgege legislative council Chenj-am
Language usedYoruba Langwej Chenj-am
Country calling code+234 Chenj-am
Map

Agege na place wie pipul dey liv wey bi pat of Legos and na lokal govanment aria for di Ikeja pat of Legos Stet for Naija.

Histri of di wod Agege[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di time wen di kolanut fam for Agege aria bigin dey gro wel wel e mek meni pipul for difren aria kom dia. Agege kom bigin dey divelop fast-fast an e kom bi one epotant ples to bai kolanut. Dis bizness dem mek difren kind of pipul to kom dia, for ezampul, pipul wey dey du jama jama (manual) wok wey no nid to go skul an Hausa plenti pass for dis one.Enitime wen di Yoruba pipul nid wokas wey dey du jama jama wok like to kut tree, dem go kol di Hausa pipul. Bikos of dis wok dey kom dey nem dat aria wie di Hausa pupul dey stey as "Ilu Awon Ageigi" wey di minin na 'Town (Ilu) of di pipul wey dey kut tress'. Na so dem tek fom di nem Agege fom di wod Ageigi.

Wie Agege land big rish[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fom di North pat of Legos, Agege long fom Dopemu road pass thru Anu-oluwapo strit to Olukosi down to Fagbola pass thru Osobu strit to Orile road down to Old Agege Motor Road wey dey opposite Nitel. Fom di South pat for Legos, e long fom Ashade retail market go rish Akilo strit. Fom di East pat of Legos, e long fom Oba Ogunji road up to Wis by-pass dey go rish Agege motor road for Nitel ofis. Fom di West pat of Legos, Agege long fom Abeokuta Express road fom Bandri with Ikeja Local government go rish Dopemu junshon.

How moni tek enta Agege bifor bifor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di time wey Dasab Airlines stil dey wok, e ofis for Legos dey Agege.

Tins wey don hapun in di past for Agege[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na 1954 dem kret di Agege Lokal Govament an e bi dey wok ontil 1967 afta militiri Govament tek ova pawa for di fest time an kom join am wit di Ikeja District Council for 13 years. Dem remuv Agege fom di Ikeja Lokal Govament for 1980 an e bi like dat ontil 1983 wen di militiri Govament tek ova pawa again kom kansu Agege Lokal Govament.Again Agege kom dey onda Ikeja Lokal Govament for anoda six (6) years. Afta dat time, 3 oda Lokal Govament don kom out fom Agege Lokal Govament. Dem bi: Alimosho, Ifako Ijaye an Orile-Agege Lokal Govament Aria.

Pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di pipul wey dey liv for Agege Lokal Govament Aria na difren-difren grup of pipul wey dem get dia kolshor an tradishion bot na di Awori bi di orijina pipul wey fest stat to dey liv for Agege.Som of di epotant grup of pipul wey dey liv for di sem ples for di Agege Lokal Govament na Ogba, Asade, Dopemu, Orile, Magbon, Oko-Oba, Atobaje, Gbogunleri, Isale Oja, Oke-Koto, Panada, Tabon-Tabon, Ajegunle, Sango, Keke, Puku/Olusanya, Oniwaya, Moricas, Iloro, Mangoro, Darocha, Onipetesi, Alfa Nla and Agbotikuyo. Di pipul wey dey liv for Agege Lokal Govament na pipul wey dey spik Yoruba an som nomba of pipul wey skata smol for dia wey no dey spik Yoruba.

Traditional rula[chenj-am | chenj-am for orijin]

For Agege/ Orile Agege, di grup of pipul wey bi shif get three Oba wey dem no an accept, an six pipul wey bi part of di traditional grup.

Tins wey hapun[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 3 June 2012, Dana Air Flight 992 yuz speed tek fall on top plenti buildin wey pipul dey liv inside for Agege as e dey try to land for Muritala Muhammed International Airport and e kill all di 153 pipu wey dey inside di plane and 10 oda pipul wey dey for graund.

Education[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • E kontan one campus of Lagos State University.
  • National Youth Service Corps Orientation Camp wey dem no go change dey for Iyana-Ipaja Road for Agege.