Economic and Financial Crimes Commission

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) na Naija law enforsimet agent wey dey chuk eye for krime abaut moni Palava an 419 issue. Na for 2003 dey fom EFCC bikos of di komplain wey di inta-govamet organizashion wey di nem bi FATF (Financial Action Task Force on Money Laundering) abaut Naija.FATF nem Naija as one of di twenty-three kontris wey dia hand de inside deyti moni bizness like teroris an drug bizness. Na Abuja bi dia hed-ofis.

Di wok wey dey don du[chenj-am | chenj-am for orijin]

EFCC onda dia forma lida, Nuru Ribadu dey dudia best to harest meni big pipul wey don put hand for kriminal mata.E don harest pipul like forma Naija shif law ofisa an meni bank shif esekutiv.In 2015, di EFCC harest govamet pesin wey bi Diepreye Alamieyeseigha. For September 2006, di EFCC don get 31 of di 36 stet govanor wey EFCC dey luk into dia mata for koropshion. For December 2007, di fediral govament Afta wey EFCC don chuk eye into dia mata tok sey dia hand klin an tok sey nek dey kom bak to di kontri.Meni Naija niuz pepa like "This Day" Kari di tori an di tok wey Fediral govamet abaut di mata. For April 2008, di EFCC stat to dey chuk eye for forma Naija presidor gel pikin Iyabo Obasanjo-Bello bikos e kolet Ten million Naira ($100,000) wey dey thif for di dipatmet "Ministry of Health". EFCC Kari di forma Health Minista (Professor Adenike Grange) an e sekod go kot bikos of di moni wey pass 30 million Naira ($300,000) wey lost from di ministri dipatmet wey sopoz dey for di dipatmet poket. For June 6, 2008, Chif (Mrs) Farida Mzamber Waziri enta as di oga patapata for EFCC.For 6 August 2008, di komot di posishion of di forma oga patapata of EFCC from AIG (Assistant Inspector General) to DCP (Deputy Commissioner of Police) Di pesin wey dey kontro di kriminal investigeshon of EFCC, Abdullahi Muazu, na e dey finish e life for Kaduna on September 14, 2010. E don dey chuk eye for meni bank ogas wey EFCC dey kweshon. Forma presidor komot Farida Waziri as Oga patapata of EFCC on 23 September 2011 an e pik Ibrahim Lamorde as pesin wey go fest jost dey di posishon.In 15 February 2012, di Naija sineti konfam Ibrahim Lamorde as di oga patapata for EFCC. Wen Muhammadu Bihari enta as Naija presidor, e komot Ibrahim Lamorde as oga for EFCC an pik Ibrahim Magu for November 9, 2015.Di sineti no gri konfam Ibrahim Magu as di Oga patapata of EFCC on two okeshion bikos of sekioriti ripot by pipul wey dey wok for law enforcement agency giv. Di Department of State Services join hand wit Nigeria Police Force harest Magu for July 6, 2020 an kari am go Naija presidor villa for som kweshon on korupshon wey pipul tok sey e du.On 7 July 2020, dey sospen Ibrahim Magu as di Oga patapata for EFCC onti investigashon finish on am. For July 10, 2020, Naija presidor Muhammadu Buhari pik Mohammad Umar Abba as pesin wey go dey akt as oga patapata for EFCC onti di mata for kot finish. For February 16, 2021, presidor Muhammadu Buhari nominee Abdulrasheed Bawa as pesin wey go bi di oga patapata for EFCC