MC Oluomo

From Wikipedia
MC Oluomo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am14 March 1975 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, labor leader, businessperson, media personality Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Eye kolorblack Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am

Musiliu Akinsanya (dey bon am 14 March 1975) wey pipo no wel wel as MC Olumo na Naija pesin wey bi di oga patapata for Nashonal Union of Road Transpot Workas. Pipo dey tok sey na MC Oluomo get moni pass for all di Agbero wey de Naija.

How e tek start life an go Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Oshodi wey de Legos dey bon MC Oluomo on 14 March 1975. MC Oluomo papa papa-dem kom from Kwara Stet. Wen MC Oluomo finish pamari skul, e papa wey kpai no mek am fit kontiniu e edukeshon.

MC Oluomo komot for house go dey do bus kondotor wen bi 13 year old. Oluomo fest bikom di Oga patapata of Agbero for Oshodi motor pak bifor e bikom di ova all oga of Nashonal Union of Road Transpot Workas in Legos.

For one kampain wey APC ( All Progresive Kongress do for Legos in 2019, dey chuk chuk MC Oluomo with Knife for di kampain. Some pipo dey tok sey na sombodi wey like di Legos govno wey wan komot dat time Akinwumi Ambode do dat tin. Dey sey di rising fit bi sey bikos di parti no gree mek Ambode go for di sekod time as govno.

Palava an Wahala wey dey folo am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni vidio wey de soshal midiha on 25 February 2023 sho MC Oluomo wey dey tok sey Igbo wey dey Legos most not vote for Peter Obi for di 2023 Naija presidential election for Legos.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

MC Oluomo get three wife an e get nine pikin.