Akinwumi Ambode

From Wikipedia

Akinwunmi Ambode ( dey bon am 14 June 1963) na Naija politishan wey bi bifor bifor govno of Legos Stet from 2015 go rish 2019. Ambode don wok for govamet for 27 years as pesin wey dey advais govamet on moni mata bifor e bikom govno of Legos. Na APC (All Progresive Parti) Ambode tek enta as govno in April 2015. E win di pesin wey Kari sekod for di eleshon Jimi Agbaje wey yuz PDP (Peoples Democratic Party|Peoples Democratic Parti]]) kampain. Na 150,000 vote Ambode tek pass Jimi Agbaje for dat eleshon.

Ambode enta ofis as govno of Legos on 29 May 2015. E tek ova from Babatunde Fashola. For October 2018, Ambode no win di Pamari eleshon wey APC do to chuz pesin wey dem wan mek e go as govno for di komin eleshon. Na Babajide Sanwo-Olu di parti pik as dia kandidet for di eleshon. E no get opshon Dan to sopot Sanwo-Olu.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 14 June 1963 dey bon Ambode for Epe general Hospitu. E papa nem na Festus Akinwale Ambode an e mama nem Christianah Oluleye Ambode. Na ten pikin Ambode papa bon.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ambode go Fediral Govamet Kolej Warri, Delta Stet from 1974 to 1981. E go Yunivasiti of Legos from 1981 go rish 1984. Na Hakantin e rid as e finish at age 21. E do e masta digree in Hakantin from di Yunivasiti of Legos an e kwulify as a chartered Accountant. Ambode get di Fulbright Program to go rid for free for Hubert Humphries Feloship Program in Boston, Massachusetts. Some of di program wey e go bi:

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 1988-1991

Ambode bi di hasistat for di pesin wey dey handu moni (assistant treasurer) for Badagry lokal govamet, Legos Stet, Naija from 1988 go rish 1991.

  • 1991

Dey tranfa Ambode go Shomolu lokal govamet to go wok as pesin wey dey check how Dem dey yuz moni for di lokal govamet (Auditor). Ambode do dis sem wok for Alimosho lokal govamet.

  • 2001

Ambode wok as aktin Auditor Jeneral for lokal govamet, Legos Stet.

  • 2005

Ambode bikom di pamanet Seketri of di Legos Stet Ministri of Finas

  • 2006-2012

Ambode wok as Hakantin Jeneral for Legos Stet. For dat posishon, na Ambode dey luk into moni mata for Legos Stet an na ova 1400 hakantat dey wok onda am.

Di kompini wey e fom[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta wey Ambode don wok for govamet for 27 years, e ritaya in August 2012. Ambode kon start e kompini Brandsmiths Consulting Limited. Di kompini na to advais pipo, kompini an govamet agent on moni mata.

In 2013, Ambode form La Roche Leadership Foundation.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ambode mari Bolanle Patience Odukomaiya. Ambode na Kristen.