Jump to content

Kwara State

From Wikipedia

Kwara na one state for North central Nigeria. E get border with Kogi State for east, Niger State for north, and Ekiti, Osun, plus Oyo states for south. For west side, e still join border with Benin Republic.[1] [2]Di capital city na Ilorin, and di state get 16 local government areas.

Out of di 36 states wey dey Nigeria, Kwara na di ninth biggest for land size, but na one of di states wey no too get plenty population, dem estimate am say na around 3.2 million people as for 2016.[3] [4]If yu check am well, di giografi of Kwara divide into two, for east side na West Sudanian savanna, while di rest of di state dey inside Guinea forest savanna mix.

Some important natural features for di state na rivas. Riva Niger dey flow along di northern border go enta Lek Jebba before e continue as boundary. Other rivers like Awun, Asa, Aluko, and Oyun dey flow inside di state.

For di far northwest side, you go see Borgu part of Kainji National Park one big national park wey get animals like grey heron, kob, hippopotamus, African bush elephant, olive baboon, and roan antelope. Some of di last West African lions wey still dey alive sef dey there. For far southwest, small part of Old Oyo National Park dey there too, wey get animals like crowned eagle, martial eagle, African buffalo, oribi, and patas monkey.

People don dey live for Kwara State since long time, and plenty ethnic groups dey there. Di main group na Yoruba pipu wey spread across di state. But Nupe people dey for northeast, Bariba (Baatonu) and Busa (Bokobaru) pipu for west, and Fulani people for Ilorin and other parts as dem dey move around with cattle as nomadic herders.

Were you see am

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. https://www.pulse.ng/lifestyle/food-travel/see-how-all-the-36-nigerian-states-got-their-names/g8bkn2c
  2. https://en.wikipedia.org/wiki/Kwara_State#cite_note-Creation-6
  3. https://web.archive.org/web/20211214205233/https://nigerianstat.gov.ng/elibrary/read/474
  4. http://www.worldnewsnaturalsciences.com/wp-content/uploads/2018/09/WNOFNS-22-2019-1-11.pdf