Ifeanyi Akogo

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Ifeanyi Akogo ( Dem bon am for July 24) na Naijá akto, fim podusa, an redio tok-tok pesin.

How e tek stat life an go Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ebute Metta wey dey Lagos State inside Naijá dem bon Akogo. Akogo go Bright Star Pramary School an Labo Memorial Primary School wey dey Lagos. Na for St.John's Secondary School, Lagos an Baptist Boys High School, Abeokuta for Ogun State im tek do im sekondri skul. Akogo na akada wey rid Health Education for Delta State University for Delta State inside Naijá. Akogo get satifiket for Entrepreneurial Management fom Pan African University

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fom eight years Akogo don dey du fim for front of pipul wen e dey pramari skul, an e waka evriwie for Naijá wit im grup memba to du fim for front of pipu wen e dey pramari an sekondri skul. Di fest fim wey Akogo du na Choices an na Barrister George bi di pat wey e du inside di fim. Di fim kommot for 2016. Di fim na pasto Bimbo Odukoya for Fountain of Life Church we dey Lagos mek am an na Don Pedro Obaseki daret am. Afta di fim, Akogo akt as 'Omasola' inside one televishon show wey dem lol Tango wey Fountain of Life Church mek. Pipu sabi am wel wel wen e akt di pat of 'Mr Midas' for one televishon show wey di nem na Tinsel wey Africa Magic di. Na for kontri-dem for Africa wet pas 50 dem see di fim an dis one mek Akogo stat to du sho go plenti televishon an fim prodoshon. Akogo dey for di televishon show wey bi Battleground an Battleground-Final Showdown wey Mnet/Africa Majic du. Na di pat of 'Boniface' Akogo akt for di fim. Akogo don do fim-dem wit plenti aktor an aktres for Nollywood an som of dem na Richard Mofe Damijo, Segun Arinze, Van Vicker,`Adesua Etomi, Femi Jacobs, Abiola Segun Williams, Iyke Okechukwu, Ihuoma Linda Ejiofor, Lala Akindoju, Somkele Idhalama, Chiwetalu Agwu, Jide Kosoko, Bolanle Ninalowo, Bolaji Ogunmola, Ayoola Ayolola an meni meni akto

Fim wey e don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akogo don du plenti fim an akt for televishon sho.

Televishon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akogo akt di pat of "Boniface" for Battleground an Battleground-Final Showdown (Mnet/Africa Magic) Akogo akt as "Mr Midas" insaid African Magic's Tinsel.

  • Battleground (2017)
  • Battleground-Final Showdown (2018)
  • Living with Angel (2016)
  • Tinsel (2016)
  • Tango (2008)

Fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akogo akt wit Femi Jacobs inside di fim wey dem lol Tango wey Solomon Macauley daret. Akogo dey inside di fim Choices wey Don Pedro Obaseki daret.

Akogo akt for Crystal an Ordinary People wey Desmond Elliot daret

  • The Cleaser (2021)
  • The Wait (2021)
  • Kamal (2021)
  • Mourning Karen (2018)
  • Ordinary People (2018)
  • The Groom (2018)
  • Eve (2018)