Segun Arinze

From Wikipedia

Segun Arinze (dem bon am for 1965) na pesin wey dey sing an dey do fim for Naija. Im ful nem na Segun Padonu Aina Arinze.

Hau im tek stat life an hau im go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Segun for Onitsha wey bi Anambra Stat. Im papa na Yoruba man an im nem na Bamidele Padonu an na Igbo wuman im mama bi, im mama nem na Lydia Padonu. Na Segun sinio pas for ol di seven pikin-dem wey im mama wey bi de do telo wok bon. Im papa-papa dem kom from Badagry for Legos. Na Victory College of Commerce wey dey Ilorin im go school, leta im go Taba Commercial College fo Kaduna Stet so dat i go finish im sekondri skul fo die. Afta dat wan im go len Dramatic Arts fo Obafemi Awolowo University. Pipu kom no am wel-wel afta im kommot fo wan big fim we Chiko Ejiro we don die nao rit. Di fim nem na Silent Killer an im nem fo di fim na Black Arrow, so pipu kom de kal am Black Arrow. Na Anne Njemanze wey dey do fim na im Segun mari bot e no te wey their marej skata. Im get wan pikin wey bi gel, im nem na Renny Morenike an Dem bon am for 10 Me.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na singa an pesin wey dey do fim Segun bi. Bot na to dey sing fest mek am popula wel wel an dat na afta e don do im song we bi Dream. E no tu get moni fo di song afta im don sel am bot di song mek pipu no am wel wel. Na for Ilorin im bigin do fim, afta Segun stil de tish pipu hau to do fim for Prestigious African International Film Festival. Im wont mek pipu we jus de grow sef get di sens we im get for hau dem dey do film.

Fim dem we im do[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Women in Love
  • Anini
  • Darkest Night
  • Extra Time
  • Fragile Pain
  • Across the Niger
  • Church Business
  • To Love a Thief

Wia we gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]