Adesua Etomi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Adesua Etomi
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Industryfilm industry, cinema of Nigeria Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAdesua Etomi Chenj-am
Orijina nemTolulope Chenj-am
Fest nemAdesua Chenj-am
Famili nemEtomi Chenj-am
Wen dem bon am22 February 1986 Chenj-am
Ples wey dem bon amOwerri Chenj-am
Pesin wey e mariBanky W. Chenj-am
Fest langwejEsan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Esan, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, musician, film producer Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulCity College Coventry, University of Wolverhampton, Queen's College, Lagos Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Wen e stat wok2012, 2014 Chenj-am
E pipulEsan people, Yoruba pipul Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Notable workKnocking on Heaven's Door Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Tolulope Adesua Etomi-Wellington wey pipul sabi as Adesua Etomi na Naijá aktres. Na for 2014 e du e fest fim wey bi Knocking on Heaven's Door.Etomi win di Best Actress for Drama awod for di 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards for di e pat for di fim wey bi Falling for 2015.

Tori of e laif an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Adesua Etomi for Owerri, Imo State in Naijá. Plenti niuz tok sey na 1988 dem bon am. For one intaviu wey Etomi du for January 2016, Etomi tok for Pulse Nigeria sey e bi 29 years old. Anoda niuz wey bi Answers Africa for March 2016 tok sey e bi 30 years old.Etomi papa na souja wey kom fom Esan pipul an e mama na Engineer wey bi Yoruba pesin. Na im smol pas for di three pikin wey im papa an mama bon. Etomi go skul for Corona School wey dey for Victoria Island, Lagos bifo e kom go United Kingdom wen e bi 13 years old. Etomi kom leta get diploma for "Physical Theatre, musical theatre and performing arts" fom City College Conventry for 2014. Afta e don finish di kose for 2016, Etomi go rid drama an performance arts for University of Wolverhampton wie e finish wit First Class honours.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Etomi du fim laik The Arbitration, The Wedding Party and Faling. Di way e tek du for di fim wey get di nemFalling mek am win 2016 Africa Magic Viewers Choice Award for Best Actress in Drama. Oda fim wey Etomi du na A Soldier's Story (2015), Out of Luck (2015) an Couple of Days (2016). For di fourth and fifth season of Shuga wey bi fim abaut how pipul fit prevent HIV/AIDS, Etomi akt as Shiela for di fim.

Pasomal laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Etomi du engagement with Banky W for February 2017. Dia two kom do dia traditional marriage for 19 November, court wedding for 20 November and white wedding for 25 November 2017. Dem do di white wedding for Cape Town, South Africa. For January 2021, Adesua and Banky bon boy pikin wey dem kol Hazaiah Wellington.

For 5 April 2021, Adesua and Banky tok about dia marriage for one tori wey dem kol Final Say Faith for inside Waterbook church.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]