Abike Dabiri

From Wikipedia
Abike Dabiri
pesin
Part ofHouse of Representatives of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Famili nemDabiri Chenj-am
Wen dem bon am10 October 1962 Chenj-am
Ples wey dem bon amJos Chenj-am
Pesin wey e mariSegun Chenj-am
PikinOladipo Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dujournalist, politician Chenj-am
Pat of wok wey e put mindadvocacy Chenj-am
Wu e dey wok forNaija Chenj-am
Post wey e deymember of the House of Representatives of Nigeria, chairperson Chenj-am
Wie e go skulJohn F. Kennedy School of Government, University of Lagos, Obafemi Awolowo University Chenj-am
Academic degreeBachelor of Arts, master's degree Chenj-am
Wie e dey livNaija Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress, Alliance for Democracy Chenj-am
Candidacy in electionAll Progressives Congress Chenj-am
Awod wey e koletwoman of letters Chenj-am
Official religionMuslim Chenj-am

Abike Kafayat Dabiri Oluwatoyin Dabiri-Elewa OON (dem bon am for 10 October 1962) na Naija politishan an forma memba of di Nigeria Fediral Haus of Representatives wey dey for Ikorodu Consistuency in Lagos State. Na shi bi di Chairman of di Haus Committee on Media & Publicity.

Na shi bi di forma chairpesin of di Haus Commitee on Diaspora Affairs, dem fest elect am in 2003, an stil enta in 2007 an 2011.

In 2015, dem giv am Sinior Speshial Assistant to President Muhammadu Buhari on foreign Affairs an Diaspora. In November 2018, giv Dabiri-Erewa niu rol of Chairman/CEO of Nigerian in Diaspora Commission. Di leta wey dey uze komfam am rish senate in 2018 by di presidency but dem dilay am til May 2019 wen di senate komfam im appointment.

Shi bi sopota of "Together Nigeria"; wey dem du to hep President Muhammadu Buhari's win 2019 elecshon.

Na shi bi di forma Chairman/CEO of Nigerian in Diaspora Commission.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dabiri-Erewa wok for National Television Authority (NTA) for fifteen years, na shi dey holways du NTA News line programme evri week an na Tori abaut pipu wey no tu get moni an hau pipu go ci justice di programme dey abaut. Sho komot for National Television Authority (NTA) to go for eleshon in di Haus of Representative, shi win di eleshon. Wen shi dey du im wok for haus shi dey insaid pipu wey no gree for forma President Olusegun Obasanjo mek e go third term as president.

Na shi bi di bifor bifor Chairperson, Haus Committee on Media in Federal Haus of Representatives fom 2003 rush 2007, Honourable memba, Federal Haus of Representatives fom 2003 rush 2007, Board memba, Lagos state Broadcasting Coperation Vision 2010, Honourable Memba, Federal Haus of Representatives fom 2007 rush 2011.

Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dabiri-Erewa go Maryland private School, Maryland, Ikeja for primari skul edukashon, an St. Teresa's College, Ibadan for sekondri skul edukashon. Shi get fest digre in English Language fom di University of Ife (wey kom bi Obafemi Awolowo University, OAU nau) Ile - Ife. Shi get post graduate diploma (PGD) in mass Communication fom di University of Lagos, Akoka. Shi go out for di kontri go stodi in di United States at Harvard University's John F Kennedy School of Government.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Alhaji an Alhaja Ashafa Erogbogbo famili wey dey Ikorodu Dem tek bon am.Im papa, Alhaji Ashafa Erogbogbo na one of di pikin wey Alhaji Ashafa Erogbogbo of Adegorosun Compound wey don kpai bon. Im mama, Alhaja Alimotu Erogbogbo na fom Bello Solebo famili of Ita- Elewa square, Ikorodu. Na Segun Erewa bi im hosband.

On di 4th of August 2015, Dabiri nem dey for Naija newspaper as pesin wey dem sabi wey no dey owe bank. Na bikos dem du mistake put im nem insaid pipu wey dey owe bank mek am rait am for newspaper sey shi no dey owe eni bank.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1.Abiodun Adelaja an Adekunle Adesuj (December 18, 2019)"Nigeria Death of Students - Dabiri Erewa Slams Nigerian Envoy to Cyprus". Daily Champion.

2.Buhari Appoints Abike Dabiri as National Diaspora Commission ChairmanThe Guardian News - Nigeria and World News. 28-11-06. Retrived 05-08-23.