William Kumuyi

From Wikipedia
William Kumuyi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejIkumuyiwa Chenj-am
Fest nemWilliam Chenj-am
Famili nemKumuyi Chenj-am
Wen dem bon am9 June 1941, 6 June 1941 Chenj-am
Ples wey dem bon amOsun State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duraita, profeso, pastor Chenj-am
Wu e dey wok forUniversity of Lagos Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ibadan, University of Lagos, Mayflower School Chenj-am
RilijonPentecostalism Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

William Folorunso Kumuyi (dey bon am 6 June 1941) na Naija pastor wey bi di Fonda an general presidet of Dipa Kristen Life Bible Ministri wey de Gbagada, Legos Stet. Kumuyi don rait meni kristen buks. Na on 6 June 2021 Kumuyi do e 80 years birthday.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Erin-Ijesa wen de Osun Stet in Naija dey tek bon Kumuyi. E famili na kristen famili. Kumuyi go Mayflower Skul wey de Ikenne , Ogun Stet an e finish e sekondiri skul edukeshon in 1961. Kumuyi kom go Yunivasiti of Ibadan fo rid matimatis. E finish with fest-klass an kolet e satifiket in 1967. Na Kumuyi no buk pass for di yunivasiti dat year.

Kumuyi go rid Edukeshon korse in Yunivasiti of Legos.

Na on April 5, 1964 Kumuyi giv e life to Krist wen e bi 23 years. Wen Kumuyi wan tok abaut e life wen e dey smol, e tok sey:

E go wake up for morin, rid Bible, sing song to God, an e dey alway go chorch. Kumuyi tok sey wen e dey sekondiri skul, e no kom biliv sey God de again bikos Kumuyi prinsipal for skul dey tish dem sey God no dey too.

Leta, Kumuyi tok sey e kom stat to dey go chorch difren chorch wey de aria bak.

Kumuyi like to dey rid John Wesley, Charles Finney, an Charles Spurgeon buk dem an dis one helep am wel wel. Kumuyi papa na memba of Angilika Chorch. For one niuz-pepa wey ue nem na The Sun (Nigeria), di niuz-pepa tok sey Kumuyi na forma memba of Angilika chorch ( di niu nem of di chorch now bi Anglican Communion), Selesiha Chorch of Krist, Scripture Union (SU) muvmet an Apostolik Faith bifor e form Dipa Life.

How e tek do tishin wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1962, Kumuyi start to tish matimatis for Mayflower Skul di skul wey e tek finish. By 1970, e don bi leshural for Yunivasiti of Legos. Pastor Kumuyi do one day program wey e wan tek tok to ova 50,000 young pipo in Legos so dat dey go fit komot bodi from bad bad tins.

How e tek stat kristen ministiri[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1973 wen Kumuyi still bi leshural for Yunivasiti of Legos, e start to dey diskuss with 15 studet wey kom mit am for Bible tranin. Na dis Bible tranin kom lid to di fondashon of Dipa Kristen Life Ministiri.

Apostolik chorch tel Kumuyi mek e no dey kom dia chorch again in 1975 bikos Kumuyi dey tish Batisim of di Holi Spirit. E kontiniu dey du e ministiri onti 1982 wey di ministiri komvikom Dipa Life Bible Chorch.

As at 2005, Dipa Life Chorch don get Ova 800,000 difren aria to woship.

Dipa Life head-ofis dey Gbagada, Legos. Di chorch get a ples wey ova 30,000 pipo fit sit-down an woship God. Pipo wey sabi tins tok sey dat ples bi di nomba four ples wey big pass if dem dey tok about chorch wey get ples wey pipo fit woship.

Wen dey wan opun di big chorch aria wey 30,000 pipo fit woship on 24 April 2018, meni big big pipo kom dia like di vais presidor of Naija, Yemi Osinbajo.

Dipa Life still get oda ples like di "Deeper Life Conference Centre" wey de Ogun Stet at Kilomita 42, Legos-Ibadan Expressway an IBTC ( International Bible Traning Centre]] wey de Ayobo, Legos.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]