Wasiu Alabi Pasuma
Wasiu Alabi Odetola (Pasuma) (dey bon am 27 November 1967), wey pipo sabi wel wel as "Oganla one", na Naija aktor an Fuji muzishan.
How e tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Pasuma, wey im ril nem bi Wasiu Alabi Odetola on November 8, 1967 for Mushin inside Legos Stet and im gro up for Kwara Stet, Westa Naija. Im mama na bifor bifor aktress wey bikom treda, wan im papa bi general manija for one lokal kompini Pasuma's papa and mama sepiret wen e stil smol.
How im take work
[chenj-am | chenj-am for orijin]As young boy, Pasuma like to dey listen to King Wasiu Ayinde Marshall (KWAM 1) album 'Talazo' and im talk say na di album make im decide to becom Fuji musician. Pasuma bin release "Recognition" wey bi im first album in 1993. Since di time,im don release over 30 albums,wey make am dey among the most successful Fuji musicians in Nigeria. Im don also do collabo with plenty recording artists wey include Bola Abimbola and King Sunny Ade. Apart from singing, Pasuma don also feature for some Nigerian movies wey include Iyanje plus Alenibare. For September 6, 2015, Pasuma beat people like Olamide, Phyno, Flavor come become di winner of Best Indigenous Artist of di year for inside Nigeria Entertainment Awards. Dem also nominate Pasuma, Saheed Osupa, Sule Alao Malaika, Shefiu Alao, Taye Currency, Muri Thunder for Best featured Non-Islamic Artiste in Islamic album for 2016.
Pasuma be philanthropist wey don help many artiste wey just dey come up.
Albums wey im don Release
[chenj-am | chenj-am for orijin]Alhaji Wasiu Alabi Pasuma don record and release about 30 Fuji Music Albums. Him first album na 1993 wey him record am. Na all him albums dem arrange under as him take realease dem:
- Recognition
- Choice
- Orobokibo
- Computer
- The man
- Confidence
- London experience
- London Scope
- African Puff Daddy
- Entertainer
- Americana
- Extravaganzer
- Desperado
- High level and joker (2in1)
- Judgment
- Unique and superior (2in1)
- Fuji Motion
- Maintain and Sustain (2in1)
- Initiator
- Importer and exporter (2 in 1)
- Stability
- In and out
- Brain box and Stardom (2in1)
- Infinity
- Role Model
- Feel it
- Ability
- Yankee Party Time
- Sure pass
- Influential
- Purity
- December tonic
- Torin tilu
- My World (Hip-hop album)
- Me, Myself and I
- Gateway
- Undefeated
- Compatibility
- Game changer
- Goodness and Mercy
- Wisdom and Maturity
- Gratitude
- Testimony and Advice
- Hello and 2020
- MMM (Money Making Machine)
Album wey im do with other pipu
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Fuji gyration (Sule Malaika)
Singles
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Iseju Meji (Ft 9ice)
- Whyne am
- Kowale
- Change
- Action (ft Olamide)
- Quality
- Olorun Oje (ft Q dot)
- Am on fire (ft Phyno)
- Labe igi (ft Oritse Femi)
- Oruka
- Our Lagos (ft Patoranking)
- Ife (Ft Tiwa Savage)
- ogede ti pon
- Abo
- Oganla (ft Olamide & Lil Kesh)
- Amen (ft Davido)