King Sunny Ade

From Wikipedia

Chief Sunday Adeniyi Adegeye MFR (Dem bon am for September 22, 1946) wey pipul sabi wel wel as King Sunny Ade na Naijá juju singa, song rita. Na pesin wey dem sabi for Afrika, bikos e dey amog Afrika musishian wey dem fest sabi for di wold wey dey sing Afrikan pop. Sunny Ade gada e band for 1967, wey pipul kom leta no as African Beats. Afta dey don no am wel wel for Naijá, Sunny Ade kom get e own own label for 1970s. Na 1982 Sunny Ade sign for Island rekods an pipul sabi am wel well wit di album Juju Music(1982) an sychro system (1983); wey mek e nem dey for pipul wey fit win Grammy awod, wey bi fest for Naijá singa. Sunny Ade 1998 album wey bi Odu stil mek dem kol e nem for singa wey fit win Grammy awod. Na Sunny Ade bi di chairpersin for Musical Copyright Society of Nigeria.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Sunny Ade for Osogbo. Im mama an papa na fom King famili an dey kom fom Ondo an Akure an dat one kom mek sunny a prince (Omoba) in Yoruba land. Sunny Ade papa na Organist for choch an im mama wey bi Maria Adegeye (neè Adesida) dey sel tins for maket.

Tori about e wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sunny Ade komot for gramma skul for Ondo like sey e wan dey go Univasiti of Legos (Unilag). Na for Legos e stat e Musika karia.Sunny Ade karia stat wit Moses Olaiya's Federal Rhythm dandies, wey bi hilife band. E kom go fom anoda band wey bi The Green Spot for 1967. Bikos of e kind muzik an biznes, Sunny Ade bkom chenj di band nem fest to Afrikan Beats an leta kon chenj am to Golden Merkury. King Sunny Ade dey luk pipul lik Tunde Nightingale ezampul wey mek am kopi som of im 'so wa nbe' way of juju music.

King Sunny Ade get King Sunny Ade Foundation wey niu pipul dey len how to sing, di foundation stil get studio an room wey pesin wey dey len musik fit stey.

King Sunny Ade na ticha for Obafemi Awolowo University, Ile-Ife. Im stil get Order of the Federal Republic.

How im tek pafom[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta dey don no Sunny Ade wel wel for Naijá, dem lik am for Europe an North America. Dey kol Sunny Ade nem as pesin wey sabi sing for di wold inside New York papar. Na July 16 2017, Sunny Ade tok sey e go du sho wit Ebenezer Obey for London, dey kol di sho Night to remember with the Legend.

Pipul wey im don wok wit[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sunny Ade don wok wit plenti pipul lik Manu Dibango(Wakafrika) an Steve Wonder, im stil folo Wasiu Alabi pasuma an Bola Abimbola wok.

Kontrat wey Sunny Ade folo Island Rekod label du mek am wok wit Youssou N'Dour, Mali's Salif Keita. an plenti oda pipul.

Im Fim karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Inside 1980's, Sunny Ade wok for Hollywood. E song dey for 1983 Breathless, wey Richard Gere dey inside an 1986 komedi One More Saturday Night. Sunny Ade dey Robert Altman's 1987 komedi O.C. and Stiggs. Im du fim inside Naijá Nollywood sef.

Im Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sunny Ade kolet meni awod for im karia.Fod November 2016, e kolet Afrima awod. Inside December 2016, Sunny Ade dey amog Hard Rock Cafe hall of fame. For February 2021, e nem enta Headies Hall of fame 2020.