Tiwa Savage

From Wikipedia
Tiwa Savage
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK, Naija Chenj-am
Nem for lokal langwejTiwa Savage Chenj-am
Famili nemSavage Chenj-am
Wen dem bon am5 February 1980 Chenj-am
Ples wey dem bon amIkeja Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej, English langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinger-songwriter, actor, musician Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Kent, Berklee College of Music Chenj-am
Wen e stat wok1996 Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
DiscographyTiwa Savage discography Chenj-am
Stai of song abi fimpop music, pop rap, soul music, rhythm and blues Chenj-am
Record labelRoc Nation, Universal, Capitol Records, Motown Chenj-am
Official websitehttp://officialtiwasavage.com/ Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Tiwatope Savage (dem bon am for 5 February 1980), wey plenti pipu sabi for im wok as Tiwa Savage, na Naijà singa, songraita, an aktres wey som pipu dey kol Queen of Afrobeats. Savage dey sing for Yoruba an English; na Afrobeats, R&B, hip pop an Pop shi dey sing.

Di Kain wey shi dey tek sing for Naijà don mek shi get plenti awod.

Dem bon am for Isale Eko, shi go London wen shi dey 11 years old for sekondri skol. Afta five years shi stet dey du muzik wok wit George Micheal George an Mary J Blige. Afta shi folo dem du UK Edition of X Factor an wen shi don finish for Berklee College of Music, Savage sign for Sony/ATV Music Publishing in 2019.

As shi ci sey Naijà muzik dey gro wel, Savage kom Naijà bak to du song, kon sign wit Mavin Rekods in 2012. Shi dey insaid Solar Plexus album 2012.

Im fest Studio album na Once Upon a time wey shi rilis on 3 July 2013. Shi leta kon du "Kele Kele Love", "Love me", "Without My Hearts", "Ife wa gbona" "Folarin", "Olorun Mi", "Eminado". Di album dey insaid album wey fit win Bes album of di year at di 2014 Nigeria Entertainment Awods an for Bes R&B Pop Album for Headies 2014. Savage sekond album wey bi R.E.D, wey shi rilis on 19 December 2015, get tu singles: "My Darling" an "Standing Ovation". In June 2016, Savage du kontrat wit Roc Nation. In September 2017, shi rilis fes EP Sugarcane. R.E.D an Sugarcane dey insaid song wey fit win Bes Album for di Nigeria Entertainment Awods.

In November 2018, Savage win Bes Afrika Act at di 2018 MTV Europe Awods, na shi bi di fest Wuman wey go win di awod. In May 2019 shi let pipu no sey shi don komot for Mavin Rekods an kon sign for Universal Music Group. Savage third studio album na Celia an shi rilis am in August 2020. E get four singles: "Attention", "Dangerous Love", "Koroba", an "Temptation". Di sekond EP wey shi du na Water an Garri, Shi rilis am on 20 August 2021, di EP get Afrobeats, R&B wit soul musik insaid. In March 2022, shi let pipu no sey wod tour go dey for Water and Garri for North America. In July 2022, shi get honory digre fom Universiti of Kent.

Life an hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

1980-2009: Hau shi tek stat life an hau e stat wok .

Tiwatope Savage wey dem bon on 5 February 1980, in Isale Eko, Lagos State, Nigeria. Im famili komot for Naijà go London web shi dey 11 years old. Wen shi dey sekondri skul, shi dey insaid skul band. Savage finish fom di Universiti of Kent, an stat wok at Royal Bank of Scotland. Shi folo Micheal George sing wen shi dey 16 years old, an wit som oda ogbonge singa lik Mary J Blige, Chaka Khan, Blu Cantrell, Emma Bunton, Kelly Clarkson, Andrea Brocelli an Ms Dynamite. Savage go Berklee college of music an get digre in music in 2007.

E du kontrat wit Sony/ATV Music Publishing in 2009. Di kontrat mek am fit rait song for Babyface, Kat Deluna, Fantasia, Monica, an Mya. Song wey shi du for Fantasia mek di song dey insaid song wey fit win Grammy Awods in 2010.

in 2006, Tiwa Savage dey insaid UK Edition of.di X factor, shi rush las nomba 34 an na shi bi di nomba 12 pesin wey komot.

2010-2013: Once Upon a Time, rekod an deel.

In December 2011, Savage dey insaid sekond sisin of Nigerian Idol wit IIIRymz. Di fes fim du na wit Joke Silva an Ireti Doyle insaid For Coloured Girls. Savage stat 323 Entertainment rekod wit im bifor bifor manaja Tunde "Tee Blliz" Balogun, wey dem kon gree to mari on 5 February 2013. Shi join Mavin rekods in 2012 an dey insaid Solar Plexus album. Wen shi dey Berklee e sabi Keith Haris, Derek Pate, Scott Coleman, Radar Ellis, an Darien Dorsey. Wen dem dey ask am abaut im wok e tok sey, shi du wok wit produsa lik Sossick, Chuck Harmony an Warren "Oak" Felder.

Wen Naijà dey du dia 52nd anniversary, Tiwa Savage pafom "Arise O Compatriots" for Ndani. In November 2012, shi sing wit Wake, Timi Dakola, Praiz an Pamela Egoh on di Oviation Red Carol song "Higher". Savage dey holways hep youth an wuman wey get cansa no hau dey tek no go get di cansa. Shi hep one grup wey dey gada moni du skul for im town. Tiwa sign deel wit MTN Nigeria in July 2013 ,wey rush 30 Million Naira.[1] She also signed endorsement deals . Shi sign deel wit Pepsi [2]Forte Oil an Maggai tu.

2014 - 2016 :R.E.D an Roc Nation deel.

On 31 January 2014 Tiwa rilis "Love in yellow" wey Spellz produs for am. Tiwa dey insaid Reekado Bankz 2014 song "Turn it up", wey Don Jazzy produs. Mavin rekods rilis anoda song, "Dorobicci" on May 1 2014.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Savage mari Tunde "Tee Blliz" Balogun. On 23 No ember 2013, dia tu du tradishonal wedin for Lekki. Dem du dia white wedin on 26 April 2014,for Armani Hotel Dubai.On January 1 2015 dem annous sey dem go bon pikin, six month leta dem bon pikin. On 28 April 2016, Balogun tok sey im wiaf waka enihau an im mama na winch.

On 19 July 2021, Savage papa kpai.


Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "Tiwa Savage becomes MTN ambassador in N30m deal". Nigerian Entertainment Today. 17 July 2013. Archived from the original on 21 January 2014. Retrieved 11 December 2013.
  2. "Nigeria: Tiwa Savage and Wizkid Unveiled As Pepsi Ambassadors". AllAfrica.com. 14 July 2012. Archived from the original on 22 May 2014. Retrieved 11 December 2013.

3.Tiwa-savage-loses-dad.Vanguard News .19 July 2021. Archived fom di original on 19 November 2021. Retrieved 19 November 2021.