Lagos State University

From Wikipedia
Lagos State University
university, higher education institution, organization
Industryeducation Chenj-am
Inception1983 Chenj-am
Official nameLagos State University Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokBritish English, Yoruba Langwej Chenj-am
Pat of wok wey e put mindeducation Chenj-am
Named afterLagos State Chenj-am
Founded byLagos State Government Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityOjo, Lagos, Lagos State Chenj-am
LocationEpe Chenj-am
Coordinate location6°28′0″N 3°11′0″E, 6°27′54″N 3°12′3″E Chenj-am
Applies to jurisdictionworldwide Chenj-am
Legal formuniversity Chenj-am
Parent organizationLagos State Ministry of Education Chenj-am
Has subsidiaryLagos State University Teaching Hospital Chenj-am
Headquarters locationOjo Chenj-am
Language of work or nameEnglish langwej Chenj-am
Official websitehttp://www.lasu.edu.ng Chenj-am
Described at URLhttps://www.timeshighereducation.com/world-university-rankings/lagos-state-university Chenj-am

Lagos State University wey pipul stil sabi as LASU dey Ojo, one town for Legos Stet for Naija. Na for 1983 dey stat di yunivasiti. Di motto of di skul na: For Truth and Service. Di yunivasiti get ova 35,000 student. Na wen Lateef Jakande bi govno of Legos Stet dey fom di yunivasiti. Di yunivasiti dey giv Diploma, digri an post graduate satifiket inkludin MBA program. For di ranking wey Times Higher Education World Rankings du for 2020, LASU dey amog di best top 600 yunivasiti for di wold. For 23 June 2021, di yunivasiti kari fest for di best yunivasiti wey dia age neva rish 50 years for Naija. For 2 September 2020, Time Higher Education rank Lagos State University as di sekond best yunivasiti for Naija an na di onli Stet yunivasiti wey dey di rankin .Meni intanashonal bodi don giv LASU moni inkludin to fom a World Bank Group Africa Centre for Excellence on Science, Technology, Engineering and Mathematics

Histri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di yunivasiti fest stat as plenti plenti kampos an skul wey student go dey kom fom house. LASU get four kampos wey dey Ojo (wie di skul dey), Epe (wie di Fakulti of Enjiniarin an skul of Agrikolsho dey), Ikeja (wie di kolej of medisin for LASUTH dey). Na 3 fakulti dey tek stat bdi skul: Commerce and Business Administration, Law an Medicine. Dey leta chenj Commerce and Business Administration to Faculty of Business and Social Studies.Na leta leta dey kom join Falkuti of Art, Education, Engineering an Science .

Epe Kampus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Epe kampus dey North side of Lekki Lagoon an na Epe kampus di Falkuti of Enjiniarin an skul of Agrikolshor dey.Studet dey stey di kampus an dey kret Epe kampus bikos Ojo kampus no fit kontain Falkuti of Enjiniarin.Na Armi barak dey wen Epe kampus dey now an dey chenj di barak to kampus dorin Olusegun Obasanjo rijin wen e bi presidor of Naija.Na Epe kampus studet wey dey du pre-digri an Diploma korse dey go.Na Epe kampus big pass for all di Kampus wey Lagos State University get.

Wetin di skul dey tish[chenj-am | chenj-am for orijin]

LASU get korse for di folorin aria:

Faculty Departments / Programmes / Centres / Institutes
Faculty of Arts
Faculty of Social Sciences
Faculty of Management Sciences
Faculty of Law
Faculty of Science
Faculty of Engineering
Faculty of Clinical Sciences
Faculty of Education
Faculty of Basic Medical Sciences
School of communication
School of transport *Transport management and operations

Vice Chancellor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ibiyemi Olatunji-Bello na di nomba 9 vice-chancellor of Lagos State University (LASU).Di wuman professor stat to bi VC on Wednesday, September 22, 2021.

List of forma Vice Chancellor of LASU[chenj-am | chenj-am for orijin]

Note:if you see , it mins di pesin don kpai

Pipul wey don pass out for di Yunifasiti[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Oluranti Adebule - forma deputi govno of Legos Stet
  • Brymo- singa an song raita
  • Sound Sultan- singa an song raita
  • Chioma Chukwuka- muzishian an aktress