Rwanda (or di Repoblik of Rwanda) (UK: /ruˈændə/ roo-AN-də, US: /ruˈɑːndə/ roo-AHN-də;[1] Kinyarwanda: u Rwanda [u.ɾɡwaː.nda]),[2] bi wan kontri witaut access to sea and dey for di Great Rift Valley of Central Afrika, for whe di Afrikan Great Laeks rejion and Sauteas Afrika konvaj. E dey a feu degrees to di saut of di Equator, Rwanda dey bodad bai Uganda, Tanzania, Burundi, and di Demokratik Repoblik of di Kongo. E dey f6 hai elevashon, wey kom giv am di soubriquet "land of a tausand hills" (French: pays des mille kollines), e jeografi dey dominated bai mauntains for di wes and savanna ga reach di sauteas, wit numerous laeks thruaut di kontri. Di klaimaet dey from temperaet to subtropikal, wit tuw raini seasons and tuw drai seasons each year. E bi di mos densli populaeted mainland Afrikan kontri; among kontris wit erea wey dey laja than 10,000 km2, e bi di fift mos densli populaeted kontri for di wold. E kapital and lajes citi bi Kigali.[3][4]