Ejipt (Arabik: مصر Miṣr [mesˁr], ), wey ofishali bi di Arab Repoblik of Ejipt, bi wan transkontinental kontri wey dey for di norteas kona of Afrika and di Sinai Peninsula for di sautwes kona of Asia. E dey bodad bai di Mediterranian Sea for nort, di Gaza Strip of Palestaen and Israel for di norteas, di Red Sea for eas, Sudan for saut, and Libia for wes. Di Gulf of Aqaba for di norteas dey separaet am from Jordan and Saudi Arabia. Kairo bi di kapital and lajes citi of Ejipt, while Alexandria, wey bi di sekond lajes citi, bi wan impotant industrial and touris hub for di Mediterranian koast.[1] For aproximaetli 100 milion inhabitants, Ejipt bi di 14th-mos populaeted kontri for di wold, and di thord-mos populaeted for Afrika, behind Nigeria and Ethiopia.